When we ask am, wetin be him philosophy for life? Him talk say; "You treat me well...and I go definitely treat u better..." Simple! From him philosophy, you go know say Dj Seal no dey talk too much at all... That is why him no dey like; "Lies and Self pity..." This guy na action guy... Him likes also include; "Simplicity, open mind and fear of God..."
No wonder today, Eze Kingsley na; "CEO of DJSeal Entertainment..." Wey be; "Offical DJ to Black Giant Signatures and
Official DJ to Summer Set Intercontinental..." Guy, no worry, na so you go go from Official National to Official International... I hope say fans dem dey shout Amen! Lol...
We con ask am say apart from DJ, wetin him dey into again?
Him talk say; "Movies..." And na One movie him don dey part of... "Touching Heaven Episode 2... Wey na Black Giant Signatures produce am..." Correct! Stars wey him talk say, him don star with, na "Charles Awurum..." We con ask am say, how him take reach there, him talk say; "All wetin I fit talk, na say, na Papa God Do am ooo" On top him hussle, him don make some achievements wey include; "Best DJ Award 2018/Karu Excellent and Achievements Award..." Wow! Na the beginning be dis my brother...
When we ask am wetin him still hope to achieve, him talk say; "I hope say i go fit achieve more in time to come.... And i dey pray say make God give me better life and Good health..." On top him final advice to especially the youths, him talk say; "For youths... Make una Dey focused... Dey
Plan well.... And fear God..... Every thing especially your dream go come to pass..."
I celebrate my self first
ReplyDeleteHe is the bomb....... Good at what he does mennnn....... I celebrate u dearie
ReplyDelete