Levels, dem say, pass levels... That is why e no dey hard to see people wey don work hard dey get levels pass other people... But to get high level, na one thing, but to dey humble, con dey maintain that level, and still dey touch lives, na another different thing...
"My name na Ahmed Alvin Abdulkadir (Mic Master) and na Kogi State I come from... Currently, I dey base for Abuja..." Pidgin dey sweet for Oga-Boss mouth ooo! Him say; "my hobbies na Playing Football, Writing, Watching Movie..." I believe you die Oga as your current position na very great testimony... If you dey near this gentleman, you go know say true-true; "Integrity pass money..." Hmmm if you get ear, make you dey hear am o! Him still talk say, as per him likes and dislikes; "Sincerity, Lies..." Na dem fall under the category because Oga-Boss na straight-forward person wey no dey like mago-mago (mehn, dis one na topnotch characteristics him get ooo!)
Our handsome Oga-Boss na Oga Kpatakpata for Actors Guild of Nigeria(AGN) Abuja Chapter & him dey work with Hot Touch Productions, wey don produce some ogbonge films... But, that na matter for another day... Previously, Oga-Boss wey dey popularly known as Mic Master been hold positions as; Sec. AGN/ Vice Chairman AGN/ Media Consultant FED UP Nigeria/ Editor Redemption News Magazine/ News Department, Kogi State Broadcasting corporation..." Chai! Una see part of the reason why I dey like to call am Oga-Boss? OK presently, Mic Master na him be the Prestigious Chairman, Actors Guild of Nigeria Abuja/ GM House 2 Entertainment Abuja/ CEO Hot Touch Productions...
Omo! See levels! And if you see am koro-koro, you go dey amazed at the level of humility wey him go take relate with you... Nuff respect Chairmo! Make we go front... As per movies wey him don star inside, him say; "i don Star for MY KINGDOM/ THE CELEBRITY /IF AM PRESIDENT/ THE TWINS/ THE PRIEST/ SECRET VIOLENCE ETC" E plenty o, but no worry, very soon you go know all... On top the ones wey him do by himself nko? Him say; "The movies wey I don make na DEEP HOLE/ MISTAKES / NO WHERE TO HIDE... Apart from movies, Mr Ahmed Alvin aka Mic Master talk say, him be; "MC/ COMEDIAN/ EVENT STRATEGIST / ORGANIZER LAUGHTER OVERDOSE... Hmmm Oga-Boss na container with heavily decorated contents wey dey very attractive...
As him don waka for the movie industry tay-tay, him don rob shoulders with the high and mighty, sotay him don act inside the same movies with stars like; "Van Vicker, Jibola Dabo, Stella Damascus, Olu Jacobs, Joke Silver, Eucharia Anunobi, Clem Ohameze, Ani Idibia etc... Chai! I dey speechless as I dey so... But when we ask am, how him take reach where him dey today, him talk say; "Na Hard work, dedication, and God..." Shebi una dey hear am! On top him achievements so far, him talk say; "hmmm, dem plenty but make I mention few; D'Advertiza Most Innovative MC of the Year/ Radio Nigeria Best COMEDIAN of the Year/ UM Best Entertainer of the Year/ Living Faith Best COMEDIAN of the Year Abuja/ NF Nollywood Leadership Awards / Zeal Awards Best COMEDIAN of the Year Mexico/ Premium Leadership/Merit Awards eye... Oga-Boss Mic Master, I no go lie, Oil dey your head well-well... On top wetin him still wan achieve for the office wey him occupy presently, him say; "I wan Impact more in People/ Capacity Building/ Make Abuja the hub of Entertainment/ Make AGN Abuja better..." Him still add say, the plans wey him get ehn, no be here oo! And I believe am die... Las-las, on top him advice to especially the youths wey dey read this right now, him say; "Never say Never & Do to others wetin u want make them do to u..."
Dis man don do plenty things since him come on board... Write us tell us some of wetin you know say him don do and him still dey do since him assume office...
Wonderful ππππ sky is your stating point
ReplyDelete