"Dem born me for Abia State but i be Imo bae on the 12th of October..."(and na today o!) E no go too tey we go wish her Happy Birthday but make we enjoy the tori from dis confam Igbo Queen mouth...
"I been attend Pope John Paul School for my nursery and primary education, Divine Grace Academy for my secondary education Dorben Polythecnic for my tertiary education but presently i dey national open university." Wow! No wonder she get the titles "Amb/Comr/Empress" and I sure say more still dey come... As she take continue ontop wetin she dey do, she talk say;
"I be Filmmaker/Nollywood Actress and also i be Entrepreneur."
Chai! You no need native doctor to tell you say dis babe na complete Packaged Nigerian Woman... Toh, make we continue as her profile don dey make me almost wan piss for my trouser... Lol! On top wetin she hope to become for dis her Career, she yarn say;
"I hope to become one of the best producer/filmmaker worldwide." Hmm mm the weight of this dream no be here oo!
She no stop there o! When we ask am, how far she don waka for dis journey, as an Empress wey no dey waste time to talk her mind, she yarn say; "I don go far small but i still wan go more farer..."
Na dis wan con make our curiosity tall small as we con ask am which stars she don act films with, & which projects she don do, she no form as she call;
![]() |
Zack Orji |
![]() |
Larry Koldsweat |
![]() |
Amaechi Muonagor |
![]() |
Tony Goodman |
![]() |
Victor Decker |
Correct! Oya, we go soon finish dis session so dat we fit go celebrate the only Empress without Cabon Copy but make we go front small. We con take style ask her who be her Mentor and she talk say;
"Na my Pastor be my mentor as the guy teaching too make sense." Whoever dis man be, we dey tell am weldone boss!
On top how long she wan dey do dis career, she yarn say;
"I wan do am all my life or as my strength go fit carry me."
Hmm the tori with Empress Chizzy no be one wey person go wan leave sharp-sharp but like every other wan, we must to finish... Las las, ontop wether any project dey wey we suppose know about, she yarn say; "Well for the moment, none but i still dey work on Something. No worry, na una go first know" ๐
On top her final words, she talk say;
"Me too na upcoming shaa but i go advice make we jes take am easy say na slow and steady deh win the race."
Na here we go take style match brake with Empress Chizy but before we caput as oyibo dey talk am, make we also use dis opportunity wish our Sis the kind betta-betta orishirishi wey baidays dey come with, plus plenty money inside her account. Happy Birthday Empress Chizy!
Country people, make we celebrate person wey dey celebrate and as today na Empress Chizy day, make all of us join hand celebrate am especially for her social media handles;
Fb: Adaku Nwachinemere Ebere
IG: @officialempresschizy
Twitter: ebere chizy
Wish you a very Happy Birthday...may all your wishes comes true and may the almighty fill up your life with success and lots of happiness.
ReplyDeleteHappy birthday to the queen of nollywood,to the queen of ndigbo, the asa npete wayi. I wish u happy birthday 1nce again and a very lovely celebration. May God bless u as u mark this very day.
ReplyDeleteas e b say na pidgin lane we dey, make I tell you say ya hustle go soon pay, as e b, God just dey arrange how him wan bless u as d hustler and ya hustle... simi go say happiness suntin, prosperity suntin and blessings follow you... happy baiday Lolo one...
ReplyDeleteas e b say na pidgin lane we dey, make I tell you say ya hustle go soon pay, as e b, God just dey arrange how him wan bless u as d hustler and ya hustle... simi go say happiness suntin, prosperity suntin and blessings follow you... happy baiday Lolo one...
ReplyDeleteHappy birthday Chizzy bae! #Adaimo
ReplyDeleteMay God bless your day and crown all your efforts with success. Cheers.. ๐๐พ๐ฅ #librababy #birthdaygirl ๐
I gbadu all of Una wey dey take out time to comment for here... On behalf of the Empress herself I say God go bless Una well-well... But make Una no forget to hit the share button wey dey immediately after the article for up. We go see Una for on top as true true, nothing dey dis life pass God and friendship!
ReplyDeleteHappy birthday dear
ReplyDelete