Sometimes i dey dey Tempted to call dis my brother "Mai gemu"... But dat na based on how far we don come o, no be based on logistics... Lol! And you no fit spend 5 minutes with dis guy wey your jaw no go ache you from plenty laff laff... But anyhow wey you see am dis na another tori session with one guy wey im charisma dey self announcing, im presence na sure-banka because im na dedicated and disciplined craftsman wey dey deliver when you want, plus na very admirable Thespian wey dey gradually step up him game for Nollywood and the career wey him don choose... Make we take style meet Chia Tiga as im carry us through dis journey of no dulling...
"My Name na Chia Tiga Micheal. And na for Kontagora Niger state na im dem born me..." No wonder im keep beards wey don dey gradually become one kind identity. Una see why sometimes I dey tempted to call am "Mai gemu" Abi? Lol! Make we continue sha... On top schools wey him don attend, him talk say; "Faith nursery and Primary School, and Baptist comprehensive school. All for Kontagora Niger state. Before him con go Benue State University makurdi for him Higher education... Wow! From Niger State to Benue State where him no wan tell us say him study Theatre Arts... Issorite! Make we continue... On top who him be now, Chia Tiga no waste time to tell us say him na;"Every body wey be film maker, wey Sabi him work na my mentor" Ontop how long him dey hope to pursue dis career, the Thespian wey know wetin oyibo dey call resolute, con talk say; "I wan be actor and film maker till I die but later Sha I go join other business o!"
![]() |
Tiga with Zack Orji & other Actors on set of Pillars of Africa |
Hmmmmm as things dey go so, e no look like say dis Thespian dey ready to slow down or dream small dream o, na big dreams him get... Toh, when we con ask am wether project dey wey him go like make we know about, him talk say;
"Right now I dey Edit Pillars of Africa. Na big film wey feature Hollywood actor Hakeem Kae Kazim and Nollywood veterans like Zack Orji, Segun Arinze, Shola Sobowale, Chidi Mokeme... I even act for the film too."
![]() |
Hakeem Kae Kazim |
![]() |
Zack Orji |
![]() |
Chick Mokeme |
![]() |
Segun Arinze |
![]() |
Sola Sobowale |
"The only advice wey I get for upcoming talents na say make them dey committed to their work because Na hard work dey pay..."
Instagram @tigachia
FB: @chia tiga micheal
Nice one bro
ReplyDelete