How This Diss Take Start?
Una already know say the "diss battle" bin start from Martel Cypher wey bin get M.I and im team before we con see The Purge Cypher by Vector and im team reach down go “Tetracycling“. Meanwhile, e take M.I two weeks to reply Vector after him diss am for “The Purge” cypher. The Chocolate City boss bin reply with “The Viper“, one kind diss track wey bin target Vector.
M.I “The Viper” diss track bin get betta contents as him utilize the opportunity to throw some kind gbege shots ontop Vector wella... All of us con dey think say M.I don succeed to make Vector close mouth because of some of the hard knocks wey him give am inside that diss track but Nah!
Na so Vector bounce back like few days later with another diss track wey him title “Judas The Rat” where him bin give M.I some kind deep gbege backlash as him respond to some kind claims inside “The Viper” diss track. The song na correct jam and na perfect response to M.I diss track.
Now Between Vector and M.I, e be like say the diss battle line don finish for now till further notice, but for our minds, we still need to pick one as the winner.
The question now be say 👇 Between M.I vs Vector, Who Win The Diss Battle?
Pick one, give your reason and make sure say, you dey very sincere
Drop your comments!
Me I think say M.I the too fill himself... But na him still win for my mind sha
ReplyDeleteI been know tey try say vector na intelligent rapper.Na one of em rap make me know say rap fit make sense.I no go compare the two as both dey good in their own ways
ReplyDeleteM.I is the winner
ReplyDeleteThe gap he gave Vector is like from Heaven to Earth.
Even in Vector's diss track Vector call M.I boss 🙄