Kevin bin however, con live just few months to enjoy im supposed achievement because depression con choke am, and later him use him hand cut him own life short(suicide)!
Him depression bin start when during one of him interviews (wey be phone-in programme), person call for phone inside d Program con ask am; wetin happen to d Sudanese pikin? Him con answer say; "I bin no wait to find out after i take d picture because i bin get flight to catch..." Na here d person con reply say; "Make I tell you something wey you no know, two vultures bin dey there dat day; and one bin get camera for hand".
As him continue to dey think about dat statement, na so e lead to depression and las-las d ultimate suicide.
Make una listen o, For Inside anything wey we dey do, make humanity come first, before wetin we fit gain for d situation.
Kevin Carter for dey alive today and people for even celebrate am well well, if for say, him bin just pick dat Sudanese pikin from d ground, con carry her go the United Nations Feeding Center where she bin dey attempt to reach.
Inside everything wey we dey do, make we always dey think of others and how we fit help humanity.
And even when we dey pursue elective office, make we dey think of how we fit use am to benefit the people first before anything...
Better and New Nigeria dey possibleππΌππΌ
This talk the surprise me, because had it been he help that pikin even nature for the reward am but instead na to snap picture. This same thing the happen even for this our generation, accident go happen instead of to help na phone we go the bring out to snap come post for social media. It's well oh
ReplyDelete