Di feem wey Genevieve Nnaji direct dey for English and Igbo, however d koko be say, dem speak English pass Igbo for di feem.
One of di requirements wey di Oscars dey give for dis category, wey dem dey call 'Best Foreign Language Film' before, na make dem no speak English for di film.
Tori pipo The Wrap tok say di Academy tell voters say dem don disqualify di feem for email wey dem send on Monday. Di feem supposed screen for voters on Wednesday.
Last month, di Academy announce say 93 kontris submit dia films for di category and ten of di films come from Africa. Lionheart disqualification don take di number down to 92.
Ogbonge American director Ava DuVernay wey comment on di mata, feel say dem no supose disqualify di movie as English na Nigeria official language.
Genevieve Nnaji tok for Twitter say di movie represent how we dey speak for Nigeria and how English be di bridge between all di languages for di kontri.
Other pipo don dey para ontop social media wen di news of di disqualification reach dem.
Nigeria Oscar Selection Committee for dia response to di disqualification for inside statement wey dem release say dem go learn from dis experience.
Chairperson of di committee, Chineze Anyaene tok for di statement say because filmmakers wan produce film wey go get wide reach, dem gats do am for English.
Dem add say dis one na eye opener as Lionheart pass all di oda requirements wey oscars want.
"As we dey move forward we go dey submit film wey dem no speak too much English inside. We want ask filmmakers say make dem shoot film wey no get English as wetin we go use measure di ones wey go represent di kontri for di ogbonge award."
"Di committee go work to organise workshop, seminar and use available media to create more awareness on wetin di guidelines be to submit feem for di International Feature Film Entry." she tok for di statement.
No comments:
Post a Comment