http://legeerook.com/cZV ππ½
Person wey wan grow for dis life go grow... And na d reason why we dey advocate for legitimate hustle no matter how hard d country be... Nollywood no dey any different as even d practioners and veterans dey advice Cast and Crew say make dem try dey get handwork so dat dem go fit stand when wetin oyibo dey call 'rainy day' go come... But d truth be say, Crew dey mostly under celebrated because people no dey get to see dem as dem dey see Casts for on top screen. And na wetin dey produce stars wey we dey celebrate today. But without these crew guys and ladies, some of d stars no go even smell limelight ooo! Na dat wan make our waka carry us reach d domot of dis talented young man wey don joinbody as crew member, dey pursue him legitimate hustle jejely. Dis attempt na to celebrate am and those crew guys and ladies wey dey tirelessly work day and night for d stars wey we dey celebrate today. Dem ma, need celebration. Make we meet Joshua Caleb...;
"D school wey I go, na Christ Children School and Christ High school. Den I come go Yaba Technology School for Lagos..." OK as we don hear dat wan, na so we con ask am say as we dey talk, na wetin him dey do now? Him still comfortably answer say; "Now na film making I dey do and na me be the CEO of Team Josh production (tjp) and also the CEO of Josh Ola films..." No be small thing oo! So how you con take become film make? Joshua still yarn say;
"hmm as I take be film maker no easy oo.... First, film na wetin dey give me joy so my first step wey I take na determination... Dat wan mean say I carry am for mind and I follow am up... I serve people so dat I go learn and Sabi..." Unto dis level now, wetin you dey hope to achieve with Filmmaking wey be wetin you dey do? Him yarn say;
"Na plenty things dey to achieve with am ooo... First, people go Sabi u. After dat wan, u go get respect for society and if you plan ur life well, u go use d money do betta things for life..." Na true you talk bros... Just as oyibo dey talk am 'proper preparation preceeds proper performance'... Oya make we continue before we use Joshua Caleb session do philosophy seminar...π Na for here we con ask am say, how long him don waka on top dis him filmmaking career? Sharperly, him respond say;
"hmm I don Waka far oo sotay my shoe self Don chop untop the Waka π€£ππ€£ππ€£πbut I thank God say the Waka Don dey pay..." Correct! E nor easy for guys like Joshua Caleb if you know how him take start but as oyibo still dey talk am, 'd end go justify d means'... OK so as you don reach dis leave, I sure say you get mentor(s), who dem be? Joshua tell us say;
"For my field I go like be like the top film makers wey Don make big name oo..." Correct guy, him sabi dodge some kind questions but him answer am well well... Na for here we con ask am say, Precisely like how long him don dey do dis waka and how long him wan dey do am? Him still yarn comfortably say;
"I Don dey do am for 10 years now and I go do am till d end of my life oo..." See passionate youth wey wan do positive things with him craft. I know, because na me and him dey yarn right now...π But Make we leave matta for Matthias... Unto wetin him go like leave as legacy for dis career path wey him don choose, him talk say;
"Plenty things dey... But First, I Don follow some people build their dreams, for now i dey okay with dat legacy and i believe say more go come..." As time don dey give us signal say make we begin find where to match full stop, na so we sharperly ask am wether some projects dey wey him don do or him joinbody with odas do? Him sharperly respond say;
"so many projects dey... Like 'Cockcrow' na me do Gaffer for the film. 'Stained' na me do Gaffer. 'From The Street' na me do Gaffer. 'Seizure' na me be the DOP. 'Unfailing Vow' na me be the Director, the project na my film..." Omo! Joshua Caleb don achieve well well ontop him 10 years waka for Nollywood ooo... Nuff twale for dis young guy wey dey contribute him own quota small small through filmmaking... As we don dey near to pack kaya escort am go him private πhelicooterπ wey dey on standby to carry am go d next set, we kukuma con ask am say wetin be him advice to those wey just dey start?;
"my advice be say make dem dey focus and make dem no dey too big to Serve because If dem too big to serve, na im be say, dem go too small to rule... Make dem get respect for people wey dey their front for dem career and make baba God be their back bone..." Las las ontop another thing wey him go like add, him say;
FACEBOOK: Joshua Caleb88 or Joshua Caleb
INSTAGRAM: Joshua Caleb 88
Nice coverage of "small trouble". Josh Ola the great. More grace from God to do better things Amen
ReplyDeleteAmen thank you boss
DeleteNice one, he is doing a good job
ReplyDeleteThank you so much
DeleteMay you continue they do this good for Nigeria entertainment industry God go use u do film wey go make Niger proud...✌️ From Jj@Kd
ReplyDeleteAmen thank you so much
Delete