Monday, December 30, 2019

20 Year Old Girl Hang Herself Because Her Family Discipline Her For Benue State...

Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here πŸ‘‰πŸ½http://triabicia.com/GhfπŸ‘ˆπŸ½to encourage us well well!


πŸ€”Hmm d kind wonders wey person dey take him eyes see for dis world, no be here o!πŸ€” As 2019 dey waka commot, wey everybody dey jolly dey prepare, na so we con receive dis sad news wey pain me for liver kumeme..😑😠

🀦🏽Chai! As e pain reach, my mouth no fit talk am but make I try... For Ehatokpe Okpiko inside Ohimini Local Government Area wey dey for Benue State, Eneonche Rosemary wey be very young fine girl, get liver, go hang herself after Christmas day, sake of say her Family been discipline her when she come back for wetin oyibo dey call "ungodly hour"...😯

πŸ€”Hmm, as d thing pain her reach because dem bin sieze her phone con break her Sim card, na so she take her time, prepare food for the family, con pretend like say she dey go fetch firewood, carry big basin wey she take hide rope and knife con waka go one very far bush go kpai herself...😠😑😠😑
D tori no finish for there o! E con take like 3 days before d family of dis 20 year old pikin go find her as her body don already dey decay small small...

As e reach dis level, wetin person wan con talk again?🀷🏽 Shey na d way wey her family go con enter year 2020 with regrets and tears because of their small pikin wey take laws for her hand go kill herself because of small discipline?πŸ™†πŸΎ But wait ooo,😳 tori be say, dem no beat am o, na talk with shout dem shout on top her wey con grow reach dis level ooo...😧 Now d question be say, shey dis kind thing make sense? How we take reach dis level inside dis present generation? Country people, make we yarn!

Abeg make una support our correct hustle so dat things like dis no go dey happen again... Click here πŸ‘‰πŸ½http://triabicia.com/GhfπŸ‘ˆπŸ½to encourage us well well!

5 comments:

  1. What a world and generation we are... Is it wrong now to scold our children ?

    ReplyDelete
  2. Na foolishness make her do watin she do na hell she go find herself las las na her family I pity for make God confort dem

    ReplyDelete
  3. Na the generation wet we dey now be this, things wet no make sense back in the days dey make sense for we generation now,make papa God helep him children ooo, signs of endtime

    ReplyDelete
  4. Thank God she won't be around to trouble her parents anymore....

    ReplyDelete
  5. Hmm mm so even as we all dey eager and careful to see year 2020, some people get liver to refuse say dem no wan see d new year... Meaning say, you dey tell Papa God say Him no know wetin Him bin dey do when Him create you... Chai! See as e con be for you now... Dis wan na big lesson to all of us ooo wether Parents or Children... Make we am learn from dis story!!!

    ReplyDelete

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land