Thursday, December 5, 2019

CHUKSJESSI: "D person wey I go like to be like, na Chacha Eke Faani..."

Click here to support our legitimate hustle πŸ‘‰πŸ½
http://legeerook.com/2jei πŸ‘ˆπŸ½

🀷🏽Legitimate hustle for me, na d main game wey dey bring nuff respect and dignity to any youth wey care to learn. Excuses and procrastination never realy help any youth wey dey focused to achieve any thing wey get value... But we thank God say youths of today don dey embrace legit hustle with d mindset say dem wan contribute to nation building and take style betta their lives... Ontop our waka to discover youths wey dey do legit hustle so dat we go fit celebrate dem, na so we con go jam dis fineπŸ‘©πŸ½ babe πŸ‘©πŸ½wey dey try for her own way to engage inside legit hustle, so dat she go fit make name for herself... Make i no keep una inside suspense... Sharperly, as we dey do am, na she go introduce herself... Oya, make we meet her;
  "My name na Jessica Livinus aka chuksjessi..." Hmm again another πŸ‘©πŸ½fine πŸ‘©πŸ½babe πŸ‘©πŸ½no pimple wey dey tear pidgin like warri babe... LolπŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚! But we go know where she come from later sha... As she continue, she say; "Dem born me for June 12,1992... I attend Gods Own College, before i come go Nasarawa State University wey dey keffi... Na there I read Mass Communication and na 2016 I come graduate... But I still dey do small program for the same school..." Okay na betta information she just let us know now and e good say education, no matter d level, dey appreciated because as oyibo dey talk am 'education na bedrock of every venture' even though say no be means to an end... I sure some of una ear don dey scratch una head, as una wan know who ChuksJessy be... Nor worry! On top dat wan, she yarn say;
  "I be actor and I be Entrepreneur, but I like acting since I dey watch film... So I con start to practice am for 2011. Den, i con go film school for 2017... Na dat time I con become Professional for acting... And I even sabi sing Oo...πŸ˜‚" And dat wan na true, because if you hear ChuksJessy sing, you fit start to trip like i trip when i hear her... Lol!πŸ€— But wetin I wan point out to Una be say, she finish school for 2016, where she read Mass Communication... E no do her, she still go Film School where she go learn Filmmaking and Acting and today, she be professional Actor... Omo! I trip for d kind steps wey dis young babe take wey make her reach dis level wey she dey... Dis wan don also prove say, she dey among d youths wey value education and dem dey engage inside legitimate hustle... Chai🀦🏽! My mouth too big,🀭 but I go try no talk too much... Make we continue with our guest Jessica Livinus aka ChuksJessy... Onto wether e get project wey she don do or joinbody do and wether some kind Nollywood starz bin dey inside she talk say;
FREDERICK LEONARD
(NOLLYWOOD ACTOR)
"Yes, e get some wey i do but d most recent movie wey I bin take d sub lead na Blue Sky wey dem shoot for Lagos With big actors like Frederick Leonard and Mercy Macjeo... "

MERCY MACJEO
(NOLLYWOOD ACTOR)
Wow! She no even allow distance be barrier to her because she b Abuja based Actor... D thing dey sweet my belle because many of these youths dey struggle and if you no hear their story, you fit no appreciate their hustle... And na d reason why dis blog dey exist, so dat we fit celebrate dem for our own small way... Na here we ask her say, wetin she go like achieve for dis her career path wey she don choose so? She talk say;
  "I go like make am for dis field and start to produce my own films... " Wow! See correct babe with big dreams... My respect for dis babe don increase oo!😊 Toh, when we con ask her say who be her mentor(s) or if people dey, wey she wan be like, she talk say;
CHACHA EKE FAANI
(NOLLYWOOD ACTOR)
"D person wey I go like to be like, na Chacha Eke Faani..."
Wow! Anyway, na here we go like match break on top dis session with ChuksJessy but before she sign out, we ask her wetin be her advice to those wey just dey start, and she talk say;

"My advice be say make dem dey focused and prayerful. All of us know say nothing good dey come easy... If e no betta today, e go better tomorrow!"
E con be like say make dis session with ChuksJessy no end but we gats end am so dat d πŸ›«flightπŸ›¬ wey dey wait for her go carry am go her next point of duty... But we know say you go was chook mouth on top her matta. You fit do so under here and make you also know say you fit reach her on top her social media handles wey be:
FB: chuksjessi
IG: chuksjessi

Click here to support our legitimate hustle πŸ‘‰πŸ½
http://legeerook.com/2jei πŸ‘ˆπŸ½

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land