Tuesday, November 19, 2019

FELIX C. AMADI - D Original Nollywood Lastborn...

Oyibo talk say anybody wey be "Last born" most times dey social, outgoing and if na guy, dem dey dey charming meaning say anywhere dem enter all d girls for there must recognize them even if dem no too fine like dat.. But their personalities dey very sweet... As I talk dis wan na, I know say person don dey nod head to agree with me say na true as d picture of our guest today, dey play ludo for their mind... Anyway, na some of these betta qualities and plenty others dem wey attract our waka come land for the domot of Felix Amadi, wey dey popularly known for Nollywood as Nollywood Last born... Oya, time don reach for am to take im own mouth chop d onions today as we go hear firsthand from dis charming Actor wey GE swagg;
"My name na Felix C. Amadi ( Nollywood Lastborn)..." You see say him even get betta name wey fine sef but dis him identity -Nollywood Lastborn- na im dey make am stand out for anywhere wey him appear and on top anything wey him put im mind to do... Make I no talk too much, make we follow am jeje as shell dey take follow snail upandan, slow and steady... As him continue, him say;

"My Papa And Mama born me for Aba Abia State. 1990..." I dey tempted to wan talk say, Omo, him na Aba boy confam... Lol!πŸ˜… No wonder him get dis πŸ‘πŸ½never-say-never plus die hard husslingπŸ’ͺ🏽 spirit wey me as guy dey trip for🀝🏽, anytime wey I see am... Now, as I dey hear Felix talk, I fit confam firsthand to you say, him na correct guy! Oya, make I no commot spotlight from our guest as dis na him moment... Unto him educational background, him yarn say;

"I bin attend community primary school Umuejea nvosi isialangwa South LGA... I still con attend Ibeko High School Umuahia and Unique Modern Schools Aba, all of dem dey inside Abia State... I still waka go front again con
Study Film Production for Harvilley film and Art Academy 2014..." Ehen! You wey no know, shey you see why Felix knowledge about filmmaking no be here... Chai!🀭 My mouth no go put me for trouble oo... Unto who him be now for those of us wey no know am, him talk say;
  "I be Actor/filmmaker..." Hmmmm😚 na now him don steady d plane wey we dey inside... Toh, as we dey vano dey go, I con take style ask am say, for benefit of people wey wan know, wetin you go like achieve with wetin you dey do?; "I wan achieve plenty things, but the most important wan na to recreate our stories so dat I go fit make people relate to our story telling, and our viewers sef, fit relate more..." As per how far him don waka for dis career, Lastborn no think twice as him say; "Omo, na 9yrs now o!" Toh na person wey don tay for yard, na him fit tell you wether the landlord good or e bad... Lol!(if you know, you know) As him take continue when we ask am who be him mentor, dis na wetin him talk;
Jim Iyke
"As Actor, my Mentor na Jim Iyke... As Filmmaker, I wan create my own world just like Tyler Perry do him own."

Tyler Perry
Hmmmm no be small thing ooo! Anyway, as per wether anything dey, wey him go like leave wey go make people fit take remember am, him talk say; "I dey always tell people say: if you get breath and you dey Healthy, nothing dey impossible for you to achieve, No Limitations, And again no ever use wetin you get by Grace to take style disgrace anybody and las las, we dey rise when we sef lift others..." Hmmmm betta talk from person wey sabi, dat na d reason why Lastborn no get duplicate for Nollywood. Him originality na im make am stand out any day anytime...πŸ‘ŒπŸ½  Na here we con ask am wether any project dey, wey dem just do wey him dey involved or him join body do, and if some kind notable stars sef join the project, na so him talk say; 
Zack Orji

Esther Audu
"Yes, i joinbody do projects like; The Little Devil, wey involve Stars like Zack Orji, Esther Audu, Tony Goodman, Sunny Williams myself and plenty other movies like; Nduka, Nwaora, Conscripted, Pain, Twisted Consequences, Twisted Lines, Ebele The story of a Legend, Bustle, Bliss and Bruises Juicy Paul, Dinner Party and in fact some I don lost count..."
Tony Goodman(Uncle T)

Sunny Williams
Wow! Now you sef go no say Felix Amadi no just be Last born Like dat but Lastborn wey get sauce... Lol! As e be say time don dey give us signal to tell Last born bye bye, na so we sharperly ask am, wetin be your advice to upcoming Filmmakers/Actors dem; "For everybody wey dey out there, wey still get passion for Entertainment as Actor ooo or Musician, Model, comedian, Dancer and others you go need to dey focus and no ever give up on your Dreams, everything dey possible. Always know say, no Limitation dey for wetin you fit achieve, if you fit think am, you fit do am..." Las las as him take sign out to go enter him private jet, him yarn say; "I wan say, the industry never reach where  we want make e reach yet.... But still, e no dey where e bin dey many years ago.... I get Dream say one day Nollywood films go compete with Hollywood films inside Quality and standard..." Gbam!!!
In case you wan holla Lastborn, him no far from you, just drop your comments under here, him go respond like oyibo dey say; "with immediate alacrity..."πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚


ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land