Wednesday, February 6, 2019

Dem Don Arrest Nine Suspects Sake Of Say Dem Do Gang Rape And Nyamma-nyamma Touch-touch With Underaged Girls



From Ali Ina...

The Katsina State police command, don arrest Nine suspects sake of say dem do gang rape and turn two underage girls into people wey sabi this touch-touch business pass normal... Parading the suspects for the police headquarter, the talk-talk person, SP Gambo Isah identify the suspects as Ali Isah, 68 Years, Ayuba Sada, 65Yrs, and Danjuma Saleh Galadima, 62 Yrs.

SP Isah talk say, others include, Ibrahim Sa’idu Zaki (46Yrs), Salisu Dahiru (46Yrs), Ibrahim Mohammed (38Yrs), Yahaya Salisu (40Yrs), Shehu Umar (55Yrs) and Ibrahim Ummaru (45Yrs).  Kai! All of dem na old men fa!

The suspects, according to police dey for prison custody as dem don charge them go Senior Magistrate Court, SMC 5 Katsina State for the offence of rape and conspiracy and the case dey come up by February 28th, 2019.

The incident been happen when one of the rape victim been dey sell something for road,  because say she been lose her father, and her mother con get skoi-skoi for head. She pushed am commot for their house, naim she dey street dey try to survive. Even her uncle no show little or no care at all and na that one con lead her to dey ask for food from her clients and sell her body too. We later hear say when the mother skoi-skoi con disappear meaning say she regain her sense. Naim she con report the case for the Divisional Police headquarter, Ingawa. Say one Ibrahim Mohammed been carry her daughter (14years) enter him room, con take advantage do touch-touch with her plenty times.

Upon interrogation, Ibrahim Mohammed con confess say,  him do touch-touch with her only 5 times since him don know her almost two years. Ali Isah, 68 years, wey dey old enough to be her grandpapa been also confess say,  him also do touch-touch with the girl too. When dem ask her if she dey feel pain inside her private part, she said no... Heeeey... This one mean say, dem don rape am plenty times and she don dey use to am... She later confess say the suspects also do touch-touch with her friend, (15 yrs) but we never know her name.
Chai!  See as dem spoil this small girls for nothing...

See Miracle o! Baby Survive 2 days wey dem bury am alive by him own father...



From Ali Ina...


This one don make me believe say miracle dey happen tru-tru ooo especially when na innocent children dey involved… Anyway make una hear the story… Police command for Jigawa State Don catch one 27-year-old man, Ashiru Abubakar, sake of say,  him bury him newborn baby boy alive for Jan-biri village inside Birnin Kudu local government area. The Police Command Public Relations Officer (PRO), Abdu Jinjiri, confirm the incident. Jinjiri talk say, the accused wey been dey  married to Hussaina Yusuf, wey be the 20 year old mother of the newborn baby, dem arrest am because him do dis kind wicked thing of to bury him own pikin alive…

Him add say the couple been marry three years ago and their marriage been end about few months back but dem been continue to see each other until the wife wey him don end things with, con get belle again… The Police Public Relations Officer explain say the incident happen on the first day of February when the accused been get the information say him ex-wife don born pikin. Jinjiri talk say, the accused been waka like Thief for night, enter the house where him ex-wife dey live, con carry the newborn baby. Him no stop there o!  Him con go dig one kind shallow grave, na there him con bury the baby alive. Haaaw  Owoicho Ada!  See the kind mind wey human being get…
Anyways, the police for the area been get the report when the mother of the newborn baby and one good Samaritan con raise alarm the following day. Na there the police immediately enter into action. Na for this their action, dem con succeed to rescue the baby alive after him don spend two days for inside grave. Him explain say, dem take sharp-sharp carry the newborn baby go hospital for medical attention. Him also talk say, police still dey investigate the matter and dem go charge the accused go court immediately after the investigation.
Chai!  Na which kind life this world don dey turn into?  Ehn!!!

Dem Don Catch One Man Dey Picking Used Sanitary Pads And Pants For Edo...





From Ayim Raymond...

This pant issue never stop oooo,  One man don receive better komin after them gbab am as him dey pick used sanitary pads, pants and other items yesterday early mor-mor for Edo state.

Them gbab this man with the item as him one use them for ritual. Them gbab am for Enwan area for Akoko-Edo Local Government Area of Edo State.

One Facebook user weh be Phattylee John share pictures of the suspect as him talk say;

We gbab this man with pikin nappy, pants and pads with some other items like that for enwan villa… make every body be careful ooo. People no dey pick metal again oooo. Sundry your pant at owner risk. 

Lawyers Don Give Edo State Commisioner of Police 24 hours Make Him Investigate Why People Go Put Pepper For One Lady Private Part Because of Missing Phone



From Ayim Raymond...

Few days ago, one video of one lady weh them no call her name, don dey every weh as some group of people been remove this lady all her clothe come cari pepper chuck inside her private parts, sake of say them say she go seal phone for inside Benin City, weh be Edo State Capital. this thing weh happen so… ie come the make plenty people vex for social media.

Inside the video, weh hear as the lady the cry as she deny say she no steal any phone, but this people no gree show her Mercy oo


The League of Patriotic Lawyers weh be groups of lawyhttps://googleweblight.com/i?u=https://www.gistmania.com/talk/topic,376800.0.html&hl=en-NGers weh get them people for heart, come join other groups as them come the ask for justice for the lady.
Them come give Edo State Commissioner of Police, Mr. Olusegun Odumosu, 24 hours to search and gbap all the people weh get hand for this bad thing, to beat this lady come chuck pepper for her privet part. 

Chairman of the platform weh be the former Student Union President for the University of Benin, Mr. Abubakar Yesufu, come the tell the state Director, Department of State Services, DSS, to go join body too, for the  investigation.
For one statement on Tuesday, Yesufu talk say: “The League of Patriotic Lawyers don give the Edo State Commissioner of Police 24 hours to arrest and start prosecution on top all the people weh do this, barbaric, inhuman, wicked, ungodly and unacceptable act, weh the video the every where for social media now. all that grammer mean say make them arrest the people weh get hand for this bad thing.

Him come still talk say if them fail to arrest this people, ie go lead to serious legal consequences against the security agencies, weh suppose take action on top this matter, especially the Police and Director of DSS for the state. This bad act shows say law and order done break down for Benin.
“We call on the governor, weh we know say him know every well about this matter, and also the Secretary to the State Government, to make sure say them arrest this people and punish the accordingly.  
 Na so him still talk…….

Chimoooo!! See As One Man Commit Suicide After Him Attack Him Wife With Acid For Anambra



From Deborah Odoekwu.... 

Heyy chimooo!!
How people dey take get mind these days sef?
Ha! Some kin tins wey person go just hear go fit make ear bend o!
Na wa oo
Chai!  The people wey dey stay for one community wey dey Anambra state don shock o as one man attack im wife with acid hmm, before im come kill imself.
This man wey attack im wife with acid come carry the acid, come drink am so that im go die.
This kin sad tin bn happen on Monday wey be February 4thfor Mbaise Nsugbe for Anambra State.

From the chuen chuen wey we gather, dem say this man bn attack im wife with acid sake of say she build house, come use her son as next of kin. Say as im find out about am, im body come dey do am somehow, he come dey vex, na im he come use acid take finish the woman for her body till she come die.
As im kill am finish, he come carry the acid, come drink am, come die.
Which kin yeye jealousy be that one ehn? If person build house come put im son as next of kin, e bad? Hian! Some people sha get serious sko sko for head! I just dey pity the poor boy wey don loose im parents and I dey hope say the soul of this woman go dey at peace where she dey.

Ha! The matter weak me o, na so this woman just die..hmm

One Man Don Stab Neighbor To Death Because Him Bin Dey Play Loud Music For Ebonyi



From Deborah Odoekwu...

Police people dem for Ebonyi state don arrest one 50-years old man wey im name na Cyril Oko, sake of say him use knife take chuk im 25-years old neighbor wey be Peter Nkwuda till im come die. This thing so bn happen for February 4, 2019 and according to wetin police dem talk, this man wey die and the other man wey kill am bn dey stay for Oroke Onuoha wey dey for Ebonyi Local Government area for the state,
Hmm
Kasala bn burst when Peter start to dey play music from im room, come high the volume well well sotey all im neighbours dem start to dey complain and from the chuen chuen wey we hear, this Cyril wey kill am bn go beg am make he reduce the volume of the music wey im dey play but Peter come refuse say im no go reduce anything. Na so quarrel take enter fight o! Cyril come vex enter im house come commot with knife, come use am take stab Peter. Na so peter just die for there.
Them come carry the matter go Kpirikpiri Police station. Na for there the police people dem come send their people make dem go the place go arrest Cyril. As we reach the ebonyi state Police Public Relations Officer, wey be DSP Loveth Odah, she talk say true true this tin bn happen, say after dem don finish to dey chuk eye for the matter, dem go carry Cyril go court.
Na wa o. anyways make I no too talk for this one, make I leave the talk talk for you ...

Hmmmm! Lagos state police don arrest two men sake of say dem drug and rape one girl for Lekki



From OLU ALVIN...

The Gender Section of the Lagos State Police Command dey investigate one case of rape against one Razaq Oluwaseun Oke, Wey be 28 years old and Don-China George wey be 25 years for Dallankester Hotels, Lekki, Phase one Lagos.
One statement from the Lagos state police command, wey be CSP Chike Oti, talk say the two men been take one 23 years old girl go club on Saturday, wey be 2nd of February, 2019, and she no know say them get one kind bad plan for her. When them been dey club, them mix something with her drink wey make am weak, con dey unconscious.
As them see say the drug don dey take action for her body, na him them carry her go Dallankester Hotels for Lekki Phase one.
For the hotel, them rape her one by one. Them even carry phone dey film as them dey rape am.
As the girl wake from the sleep, she been feel say e be like say this men don clear her bush. As she ask them, them say lai lai, say them no do anything like that. But she been no dey satisfied, na him she carry phone call are elder brother, tell am watin happen. The brother sharply invite policemen from Maroko Division, and na the Divisional Police Officer, CSP Isah Abdulmajid. Been lead the team come.
As them search the suspect them, the DPO been collect their phones, where them for see the video wey them do, as them they clear the bush of the girl wey dey unconscious.
The state  Commissioner of Police, wey be CP Edgal Imohimi, don direct the Gender Section of the Command make them investigate, and make them make sure say them prosecute the suspects them, so that other people go learn lesson, say to rape no be good thing.

Betta Tori; Dem Don Arrest Seven Internet Mago-Mago People For Ibadan With Exotic Motor wey plenty...



From OLU ALVIN...

Operatives of the Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, Ibadan Zonal Office don arrest seven people wey them suspect say be internet curney curney people.  The suspects them name na, Ola Sam, Demeji Abiola, Segun Isaac, Oyinloye Jubril, Bamidele Adeboyega, Hassan Afeez and Sanni Muyideen.

One statement from the anti graft agency talk say them been catch them for Poly Road and Sanyo area for Ibadan, Oyo State, on February 1 and 4, 2019.
Them talk say this boys them, been dey involve for love scam for different dating sites, where them dey use curney curney collect money from people.

The time wey them arrest the them,  EFCC been collect two big big motor for their hand. Them collect laptops, telephone, and plenty document wey get fake fake name. They collect passport and ATM card from them too.

EFCC talk say, them go carry them go court, when them done finish investigation.

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land