Friday, February 22, 2019

One 23-year-old-man don enter gbege, sake of say, him allegedly kill him wife with axe for Jigawa State...


One Dutse Magistrate court for Jigawa State don remand one 23-year-old man, Sha’aibu Adamu, of Warwade village for Dutse local government because say him allegedly kill him wife with axe.
The prosecutor, Barr M.Fagam, tell the court say, dem been accuse Sha’aibu say him kill him wife, Usaina after she refuse to comply with him request say make dem settle their differences, wey dem been get for their matrimonial home.
Him explained say, the incident happen when she been decide to move go her parents’ house and the accused person follow her to plead with am, so dat she go fit come back to him house.
However, on her way, na so Adamu allegedly use axe to hit her plenty times ontop her forehead.
The prosecutor talk say, after the incident, the accused been leave the late wife body for the bush, then him con run.
Magistrate Muhammad Lamin Usman talk say, Adamu committ culpable homicide, wey dey contrary with section 221 of the state sharia Court wey dey punishable to death after convictions.
The accused, been however, deny the allegation, as him talk say, the deceased been die for her parents house after she commot from him house when dem been get misunderstanding.
The magistrate, con adjourn the case go March 27, 2019 for further hearing.

”Beware of fake dollars wey dey in circulation” – EFCC dey warn Nigerians


The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don raise alarm over the circulation of fake Dollar notes, for this period before the Presidential and National Assembly elections.
For one statement wey no the Acting Chairman of the Commission, Ibrahim Magu, personally sign am, the agency talk say the warning follow intelligence wey dem gather, as Nigeria Dey prepare for the elections.
The intelligence talk say the Dollar notes get features of genuineness, but forensic analysis by the Commission talk say the thing get k-leg...
Dem dey therefore warn the BDC operators say make dem dey cautious for their transactions from now till the end of the elections...

People Just Dey Yab These Northern Nigerian Men Sake of Say, Dem Take Selfie For Burial Ground


People don dey Chuck mouth for one picture wey see one group of some Northern Nigerian men as dem dey take selfie for the burial ground of one person wey don die...
The report wey surround the picture reveal say, the men been burry one of their friends, dem con decide to take selfies for the grave after the funeral.
While some people don condemn the action of the men, con talk say e dey unnecessary, considering the situation, other people Don argue say, nothing dey wrong with taking selfies for grave sites...

Considering say we be Africans and Nigerians for that matter,  how you take see the matter?

How I Was S*xually Harassed By Filmmaker And Marketer - Blessing Egbe

E be like say the issue of byforce touch-touch harassment for film people for Nigeria wey we dey call Nollywood, don dey underreported these days ooo.
Blessing Egbe, wey be Nollywood actress and ‘Lekki Wives’ creator, don narrate how she be victim of byforce touch-touch harassment by one filmmaker and marketer.
As she dey talk for one interview with Everything Entertainment, the actress wey no gree call the name of the filmmaker talk say him try to do byforce touch-touch with her in exchange for movie roles. Blessing Egbe wey narrate how d thing happen, talk say;
“This harassment been come from one prominent writer, producer, director wey been just wan try him luck." She say she been don call am before make dem talk about the possibility of working together. Na so him con give am appointment wey she been respect. The meeting been dey for one hotel, no be him office. Ahn Ahn!  She con ask am why dem dey meet for hotel and him talk say, d hotel na makeshift office… Say na something wey him dey do when him wan get time to write. Na so Blessing con believe am, con follow am to the makeshift office.

When dem enter,  na so him give her script make she read, as him no con dey satisfied with the way she read am,  him talk say him go fit write the wan wey go fit her because the cast for this particular project Don complete. As a sharp man,  him con add say if him go do dat one for am,  she go gats dey come around dey follow am go anywhere wey him dey go,  so dat the inspiration go fresh for him mind... But as a Sharper girl wey don code d direction of this talk,  na so she tell am say no wahala... But make she first go discharge her cabman so dat dem go begin celebrate. The next time wey d guy hear from her, she dey road dey go her house... And na the last time wey him hear from her be dat... She also talk say no be only him don try dis kind thing with her and no be only her dey face dis kind harrassment for the movie industry... Hmm Nollywood people wey dey do dis kind thing no worry,  one day monkey go go market,  e no go con back again...

Herdsmen Don Kidnap 12-year-old Boy After Dem Invade Plateau Polytechnic

The eldest pikin of the Chaplain of Plateau state Polytechnic, Barkin Ladi, some people wey dem say na herdsman don abduct am... And up till now, these suspected men never make contact with the family.
The attackers been enter the Chaplain compound around 8pm on Wednesday, con carry  money and other valuable things like dat, after which, dem con abduct him eldest pikin, wey be 12 year old.
TVC News correspondent, Funom Joshua report say, the police don visit the house and investigation dey go on.
Members of the family talk say, dem don advise dem say, make dem no talk with talk-talk people until the abductors don make their demand.

From Plateau State...

Wetin you get to add?

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land