Thursday, November 28, 2019

JENNIFER UTULU:"Actress, Model, Entertainer, and Student... I Study am, i con come Lagos, con pursue am..."

Support legitimate hustle like dis wan wey Jennifer Utulu dey do... Just click here πŸ‘‰πŸ½http://legeerook.com/dRoπŸ‘ˆπŸ½

Oyibo say 20 friends no fit stay together for 20 years... Small truth dey inside because out of d 20 of my coursemates wey we siddon together for university, e be like say those wey still keep in touch after 10 years now no reach 15 oooo even though say we get WhatsApp group🀷🏽(dat na story for another day sha) and we go wait for the 20 years before i go visit dis topic again... ☺Today na special day because our guest today na special person because me and her siddon for the same class for 4 years for university where we bin study Theater Arts... I dey happy to introduce her sef even before she start because when I be JJC for university, na she be d second person wey I jam as I bin dey look for my department (d first person, we go know her days or months or years later laterπŸ€£πŸ˜‚πŸ˜€πŸ˜…) and since then we con close sotay I con dey even trip😍 for one of her sisters but liver fail me till todayπŸ˜₯... Lol!😊😊 Today, our guest dey pursue her legitimate hussle for Lagos and we dey see her for inside some big big films with big big stars dem...πŸ€— Anyway, Make I no talk too much again, make we meet our special guest for today;
  "My name na Jennifer Utulu..." Chai! Pidgin strange for her mouth sha but e make sense... Lol! She con continue say; "Na for Ibadan my Papa and Mama born me..."
Toh ontop her educational background she yarn say;
  "I bin attend Makurdi International School, from there I go BSU Staff School (primary education). Before I con go Regina Pacis for Abuja ... Then I move again go FGC Vandeikya, con move again go Abeco Model College Mkd (Secondary school)..." Omo! Dis babe move oooo no be small thing... As we reach d most important part of dis interview na so I botton my shirt, spray perfume for cloth and mouth con polish my pidgin as I ask her say abeg help people wey dey follow your tori, make dem know who you be... With one kind betta Angelic smile, the same wey I know for the past 10 years, na so she talk say;
  "I be Actress, Model, Entertainer, and Student..." Omo see levels... She no stop there o! She continue say; "Incase you dey wonder how? I Study am, i con come Lagos, con pursue am..." Respect for dis babe wallahi! No be everybody get dis kind liver to follow their passion like Jennifer Utulu... Toh as we don reach dis level, na so we con ask her wetin she go like achieve with wetin she dey do, she no think twice to sharperly say;
  "Wetin i go like achieve na just acknowledgement..." You see ba, na so dem dey take know humble people I swear... I commot cap for you Jennifer Utulu... But make I no dey talk too much... As she continue when we ask her how far she don waka for dis her career path, she yarn say; "E never too far yet..." OK as she don talk dat wan, while we dey enjoy d ride with her, we con kukuma ask her if she get Mentor(s), na here she con tell us with her sweet Angelic pidgin voice say; "My mentors na Tyler Perry/Oprah/Mel Gibson..." Omo! Dis wan mean say Jennifer don aim pass d blue skies ooo! Onto how long she don dey pursue dis career path, she talk say;
  "I don dey act professionally since 2015, but i bin do one job for 2010, before gap con enter..." Toh, for how long you wan con dey pursue dis career path nko? She talk say; "I wan entertain as long as God go let me do am..." For her to acknowledge say e dey God hand, I believe say her own acknowledgement go soon show... Na wetin con be d legacy wey she go like to leave wey go make people remember her. She talk again say;
  "Na d movie wey I act wey d title na Alero's Closet, because d film carry d belief wey I feel about societal malformations..." Omo carry dictionary if you no understand am ooo or look for d film Alero's Closet, watch am to understand her point... As per wether some kind projects dey wey she don do or she joinbody do, and wether some kind starz wey we know, dey inside, she happily talk say; "D projects wey i don joinbody do plenty small, like Alero's Closet, Illbegotten, Talodaran, The Kins, Mother's Will, Road to Hell. For Stage na: Our Husband Has Gone Mad Again 1&2 Abuja and Lagos. Stars wey I don act with and dey some of these projects na: Keira Hewatch, Ik Ogbonna, Art Alaniyo (sp), Anthony Monjaro sp, and plenty others..." 
IK OGBONNA



KEIRA HEWATCH

ANTHONY MONJARO
Chai no be small journey wey Jennifer carry us waka ooo... As time don reach to March break on top her private jet wey we bin dey cruise since, na so we ask am make she give us her las las advice to upcoming talents... Na so she simple talk say; "My Advice dey simple: Be Yourself always..." Make I confess, dis journey with Jennifer Utulu sweet me no be lie... I con dey wish say e no go end but as normal, any interview wey get beginning must to get end too... Make una no forget to comment under here to take style appreciate Jennifer Utulu on top her legitimate hussle!

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land