Wednesday, February 20, 2019

Sick Comic Actor, Baba Suwe Don Get First Cash Gift...


Movie practitioners don try to help iconic actor, Babatunde Omidina wey then dey porpularly call Baba Suwe.

One actor wey him name na Jigan Babaoja, don present money to Nollywood star Baba Suwe wey dey sick seriously.

Since wey the news comot say Baba Suwe dey sick, him colleagues don dey try all wetin them fit do to take help am. As them talk say him need money to travel go America where him dey always go collect treatment.
As them dey call on every Nigerian make them show support to this man wey put smile ontop their face for many years.

From Olu Alvin...

2019 Election: Graphic Photos Of Man Wey Thugs Kill For Akwa Ibom, Con Dump Him Corpse Inside Boat


Thugs don kill One man a day before them postpone the presidential and national assembly elections.
Them talk say this thing happen for Akwa Ibom state.
As them talk say the name of the man na Mr. Samuel wey come from Obughu for  Oron area of the state, and say na thug wey them import to come cause katakata for the election na him shoot mr samuel
As them been postpone election, them come begin dey arrest thugs them for the state, na him many of them been dey try to skampy comot from the state, when them been come jam Mr. Samuel for the water side wey them wan use run. Na him them kill am come carry the engine of him boat.

Army or police wey carri gun no get any bizness near polling unit - INEC



Nigeria election bodi INEC say security agents wey carri gun, no get any bizness to stand for polling units on election day.
Rotimi Oyekanmi wey be di tok-tok pesin to di INEC chairmo, follow BBC Pidgin tok and say di election bodi get dia own "security style" wey dem don dey use now in collabo wit security agencies.
On Monday, Nigeria presido Muhammadu Buhari bin say make police and army, use iron hand take deal wit those wey snatch ballot box on election day. Im say those wey dey plan am, "e fit be di last illegal thing wey dem go do."
Most pipo don reason am say di president dey ask security agencies to "shoot pipo" wey try dat kain thing, but oga Oyekanmi say no be INEC style be dat.
"Na three rings of security we dey get on election day. Police wey dey stay for polling unit and those ones no dey carri gun; police wey dey patrol for car and dem dey cari gun and military also dey.
"Military dey stay for border post and strategic places. Dem no suppose dey around polling units," im tok.

Im add say im no hear wetin presido Buhari tok, but say wetin im sabi be say INEC get dia own way dem dey take work wit security pipo.
Di Nigerian Army on Monday bin tok wit tori pipo PREMIUM TIMES say dem go follow di order wey oga Buhari give. Army tok-tok pesin Sagir Musa tell di paper say "if Commander-in-Chief don give order to di Nigerian Army, den know say we go cari out dat order totally without any ifs or buts."

INEC don promise to take proper care of corpers during election


Nigeria election bodi INEC don promise to take proper care of youth corper members wey go work for dem during elections.
National Youth Service Corps (NYSC) wey dey in charge of corps members, na dem reveal dis one for statement wey dem release through dia tok tok pesin, Adenike Adeyemi. Di statement say as dem see all di foto wey sara for social media of corps members wey suffer for Saturday postponed elections, dem gats carri di mata table to INEC.
Madam Adeyemi say di commission don promise say dem go provide transport, accommodation and security for corpers, throughout di elections. She add say dem don start to pay di corps members training and feeding moni plus dia election duty allowance.
Pishures of corpers wey sleep for open field, classrooms, inside bus and for ground on Friday night breaking Saturday, bin full everiwia. Di one wey come pain plenti of dem pass na say di election no come hold.
Di National Youth Service Corps na by force one year service wey Nigerian graduates of tertiary schools must do. Na dem INEC dey use do poll officers and oda kain work during election period.

See As 'Negligence' Of Asokoro General Hospital Abuja, Don 'Cause The Death' Of Health Advocate, Kafayat

Kafayat Abdulazeez




Young Nigerians don dey accused the Asokoro General hospital of wetin dem say na negligence, wey don lead to death of one Kafayat Abdulazeez.
Kafayat Abdulazeez, wey be 25-year-old lady, been no dey feel  well on Valentine’s Day. According to Yusuf, wey be her colleague, she been go Asokoro General hospital where dem been admit her, and the doctors con diagnose say she get pneumonia. Wey be when cold don catch you till e break you down…
Yusuf talk say, after the initial treatment, she con get her strength but "painfully, the following day, wey be Friday, her situation con worse and the hospital no longer con dey as responsive as dem supposed be".
According to am, "Mobile oxygen, wey dem been suppose to use ontop her, dem been no use. Doctor con prescribe drug wey dem go give am, but the nurses no give the prescription to the family until a day after. By then e don dey too late."
We hear say the late Kafayat be the Co-founder of Al-imran Islamic Foundation. And before she die, she be health advocate.
Yusuf talk say, the late Kafayat been die due to the carelessness of medical practitioners and the unhealthy health system. 
Him say, "dem no fit call dis wan medical mistake,"
"Say e be clear case of lack of value for person life by our medical practitioners.. Her family and friends been dey beg, dey even cry but dem no show any pity. One patient for the hospital sef con call some doctors dey beg dem on her behalf say make dem just treat am, but all her efforts no produce any result."
Yusuf con beg the government authorities say make dem hold those wey dey responsible for this kind acts of negligence, wey don continually lead to some kind unavoidable deaths dem, and make dem bring dem to book.

Chai! Bricklayer allegedly kill him co-worker because of N47,000. ..

The Suspect 

One bricklayer wey dem identify as ThankGod Emmanuel, wey come from Sauka-Kahuta area of Minna, Niger State, dem don arrest am, sake of say, him allegedly kill him co-worker because of N47,000. Chai!
The suspect, been kill one Tita Komla, of the same address, with digger. And na one team of policemen wey dem attach to Tundun Wada Division, na dem catch dis man.
We hear say Komla brother, wey be Tete Joe, of Katampe, inside Abuja, been don earlier report say him brother been dey work with the suspect for him construction company wey dey for Sauka-kahuta.
Him claim say the suspect been call am for phone to notify am say Komla been don die and na some unknown persons na dem kill am…
We hear say the suspect been engage him victim for one kind Jackie chan physical combat like dat, before him con kill am with digger, con theif him N47,000, before him con thruway him body inside gutter.
Emmanuel talk say him kill Komla with digger so dat him go fit take him money.
Him talk say: “Komla been no know say I been wan theif him money. I kill am so that nobody go know say I theif him N47,000. I use digger to injure him head, na so him die instantly.
“I been no suspect say the police go identify me as the person wey kill am. Well, e dey very unfortunate.”
Confirming the incident, the state Police Public Relations Officer (PPRO), Muhammad Abubakar, talk say the suspect been confess say na him committ the crime.
Abubakar talk say the suspect been injure the head of him victim and run away with him money. The PPRO add say dem go carry the suspect go court soon.

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land