Sunday, December 1, 2019

Okpe Lawrence Okpe, Black Giant Signature CEO, give out im car, con dey trek, just to fulfil him promise of Car as star prize for FABP 2019...


Click here to encourage legitimate hustle and discourage social vices:
http://legeerook.com/dJZ

Recently, Black Giant Signature bin do her 3rd edition of Face of Arts Beauty Pageant(FABP)/African Giants Strides Awards(AGSA) on the 17th of Nov 2019 and dis event bin attract who be who for Nollywood, and even some kind ogbonge people sef from all works of life, bin show face, even as social media nearly catch fire on top d gbedu...🀷🏽 But dat wan no be d gist for today... D koko be say, true true, to fulfil him promise to give car as star prize for d FABP event, d CEO wey be Okpe Lawrence Okpe, give out him one and only car 😲to  d winner of d Beauty Pageant wey be Queen Anna Ochigbo...
QUEEN ANNA OCHIGBO
FACE OF ARTS NIGERIA 2019/2020
 Con return to dey climb okada and enta araba(public transport) Ha!πŸ™†πŸΎ But as him do dis wan, i know say plenty people go dey wonder say ahn ahn how come? 🀷🏽... Dat na why i con say my waka must carry my two left legs, go him domot so dat him go explain how e reach dis level of wetin oyibo dey call "dogged humanitarian service..."
Oya, make we follow Okpe Lawrence Okpe, CEO Black Giant Signatures, as him begin say; "If I no do as I promise my vision go suffer, I rather give my car so dat people go know say we dey do wetin we talk..." Hmm as far as dis thing don concine us so ehn, na only men of integrity dey get liver to talk like dis or do dis kind thing ooo!😦 Anyway, gist plenty today, but make we dey patient follow jeje... Him continue say;
  "FACE OF ART NIGERIA BEAUTY PAGEANT no be one of those pageant wey go dey talk wetin dem no fit do... For d first edition na laptop we fit afford, second edition we give car but on top tight Conner... Dat time, I no even get one myself, dis year I been dey hope to get more sponsors but e no come as I think, so I decide to give my car to the winner..." Omo! Dis one na d direct translation of 'na condition dey make crayfish bend...' How many CEO's go fit sacrifice like dis to save their integrity?🀷🏽
To be CEO, no be small thing oo and e dey evident as i dey hear Okpe Lawrence talk so... No wonder him continue say;

"No visioneer wey ever succeed, dey normal, you must do things wey some people go see like say you don mad..." Chai!πŸ™†πŸΎ Chai!πŸ™†πŸΎ Na here my 'agbada hook wire' as i just surprise with d kind wisdom wey full dis young man... Him no stop there o, as him still talk say;

"Another car go come, d vision go dey grow..."... Now, d car wey you give the Queen, she fit carry am go without doing her work for one year? Him respond say;
"base on the fact say most times when we crown Queen dem dey abandon d work wey we crown dem for, but dem go wan Keep the car... D car go always remain the Queen OFFICIAL car until her one year successful reign. During dis period of her reign, she go dey do charity work, help people, advocate for the voiceless, be brand ambassador, promote the Organization wey crown her etc. On top case whereby she con decide say she no wan dey under the management complete her reign, she go forfeit all her benefits, no be wetin she do on stage make her merit the crown and car, na the work wey she show say she fit do make her merit am. After her one year successful reign, she dey carry the car go
Hmm no be small thing ooo... Anyway make we Change gear small, onto wetin con be d outcome of d event dis year as per if you compare am to last years? Him talk say;
  "If you bin attend d event you sef go agree with me say e pass the last one plenty times... African Giant Strides Awards wey we present last year to merit category, get Nomination categories this year and we impact ontop more lives..." Ah na true him talk for here, bcoz even as i siddon inside dat hall dat day I bin dey inside wetin oyibo dey call 😳'state of hullaballoo'(no ask me wetin e mean o) because of d turn out... But how you fit rate d recognition of Black Giant Signatures so far as CEO? Him no think twice to talk say;
  "Today BLACK GIANT SIGNATURES don dey recognized for Abuja and we don dey spread small small, my pastor dey talk say no amount dey too big to invest for your vision..." Na here I con ask am say shey na d reason you give your own car as d winning price as you no even think about how you go cope? Again him talk say;
  "D thing no shake me at all, I dey climb Keke, climb bike or use commercial vehicle for now, my mama no born me ajebo, na barracks I grow so no be new thing..." Hmm Anyway make we move go front small as time don dey already give us signal... So after all dis wan, na wetin be d next level for you and d Queens wey una just crown? Sharperly, him yarn say;


  "As we dey talk now the new Queens don dey plan for their charity visits and pet projects. For me, Impact betta pass income... Everything go good soon, by that time people go say na dis and dat... Dem no go remember all these sacrifices... D car na just one among hundreds of sacrifices wey we dey do everyday. I go even do more sef, just that we go dey pray for God's favor so that I go replace am soon to ease d stress wey dey on top to carry the vision..."  Before we match break full stop ontop dis session of interview, make i ask, I hear say your main Queen dey school for Togo, wetin go happen to the car when she dey school since no be Nigeria?;
 "Ehn d thing be say no be only her we crown, we go understand with her bcos school dey very important, but d car go dey under d management care untill she come back from Togo... When d others get official movement to make, we go carry them inside go work wey she suppose do if she dey here, the management and the other Queens go dey do am. We wish say na Nigeria she dey school, even if na Lagos, we for carry d car follow her go, make she dey drive am there..." Ehyaaa! But anyway, As we don reach dis stage, na so we ask if him get message of appreciation to people wey him feel say dem joinbody with am to see say him reach d level wey him dey or d success of him events so far? Him yarn say;
  "Yes make i use dis opportunity say Big Thank you to people wey joinbody with me like ZAWAYA HOSPITALITIES, TONAK MEDIA CONSULTANCY AND ENTERTAINMENT, AYALLA HOTEL, SHONELS STUDIOS, LOVE OF GOD MINISTRY, ALI INA PIDGIN BLOG, BARR. AFE, MR BEVER, MR UTTUH, KING DEROX TV... Even to PROOF CLASSIC wey sow all the clothes wey I wear during d camping and d event and FAMILY and FRIENDS wey support, MY WONDERFUL CREW... Las las make i no foget NTA ABUJA... We believe say next year we go get all kinds of sponsors and partners..."

Dat na how much we fit take for today but incase you get betta mind say you don see how Okpe Lawrence Okpe and Black Giant Signature dey hussle ontop dis legitimate hussle and you wan joinbody with am, For sponsorship and partnership, make you no waste time to contact 07036353673.
Facebook: faceofartnigeriabeautypafeantfabp

Instagram:  faceofartnigeriabeautypageant/AGSAwards

Follow d CEO ontop FB: okpelawrenceokpe

Make una no forget to tell us how this gbedu Chook you for liver? Just comment under here...

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land