Tuesday, February 26, 2019

Petrol Tanker Wey Explode Near INEC Office For Plateau State Don Dey Cause Panic


Commotion don dey the Independent National Electoral Commission INEC office for Jos South local government area of Plateau State on Monday.
We hear say one petrol tanker for Bok Investment fuel station, close to the INEC office just explode around 4:35 pm, this thing con dey cause one kind panic and fear around Sparkling and Miango junction.
Naija News talk say the sound of the explosion been alert security agents around the INEC office wey quickly block other sections of the road before dem con know where the sound and commotion been dey come from.
One witness tell say the workers for the fuel station been noticed the fire early but dem no fit control am because dem no get fire extinguishers for the station.
But sha, nobody been injure but officials of the Fire Service been come around dey battle to quench the fire.

BUSTED! SEE HOW SECURITY MEN DEHUMANISE KIDNAPPER WEY DEM CATCH AFTER HIM TRY TO KIDNAP VICTIM (PHOTO)


Dem don beat one suspected kidnapper well-well after security men been catch am when him been dey try carry out him mission… According to reports, dem been catch the suspect, wey we never know him name, yesterday for Tsafe local government area for Zamfara state when him come to kidnap the victim. Na so the residents beat am without apology, before dem hand am over to the police.
Thank God say dem catch am sha… dem dey investigate the matter… Na so National Helm reports.

CTA Don Carry Cry Ontop the Performance of Security Agencies During Nigeria Election


The Centre for Transparency Advocacy CTA don carry cry for ontop social media say dem no dey happy with the conduct of security agencies during the presidential and national assembly elections wey happen on Saturday. The CTA been clap for media organizations across the country say dem do very good work as dem guard the democracy of Nigeria well-well especially for their minute by minute report, even up till now. While dem talk say, the security officials been perform below expectation during the electoral process.
The Organization talk say the presence of the security personnels been no make any difference because e no prevent the actions of thugs and hoodlums.
We been get reports of thugs wey show up for some polling units con dey harass and intimidate voters. This kind thing wey dem do, con dey scatter the peaceful course of the election process. We been hear case of Thugs shooting and killing voters for one ward inside Rivers state even of thug harassment of INEC officials for the same state.
More so, Lagos state, dem burn ballot box for one ward for okota and na after people don vote.
For Osun state also, we hear reports say thugs threaten electoral officers, and even electorates for Iba village. This one na  just to mention few out of the many cases wey dey.
Because of  these happenings wey happen for different places across the country, The CTA don call out to the security agencies for one statement wey dem describe as “unpurposeful”, dey accuse them say dem no do anything to stop these criminal actions during the election.
The organization been  issue this statement on Sunday afternoon as dem been gather reports from their  observers wey dem dispatch across the country.

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land