Wednesday, January 30, 2019

Make Una Meet Miss Face Of Arts South West Nigeria... For Face Of Art Contest 2018/19...


                         

Hmmmm some people beauty no be here ooo...  See how God take him time package some ladies like Miss Joshua Tosin  C. wey wan use her beauty touch lives so that Nigeria, wey she come from,  go better... Na this kind one, wey we dey call, "Beauty With Brains"... Make una meet the Beauty Queen wey be Miss Geo-Political Zone Queen For Face of Arts Beauty Pageant wey na Black Giant Signature organize am...

Ontop her sweet voice she say, "My name na Joshua Tosin Christiana...My papa put me inside my mama belle, she con born me 18th December..." O boy this Beauty Queen sabi tear pidgin ooo,  thesame way she dey tear English... She no stop there ooo... When we ask her about her educational background, with humility, she talk say; "I finish from city college of education, Gurku, Abacha Road-Nasarawa State..." From the way wey she dey smile dey talk,  you go see say this one know wetin she dey talk...
 According to her; "I like dey read book... My philosophy be say; Make you no expect anything and you no go dey disappointed...' When we ask am about food, likes and dislikes, trust this natural beauty,  she shout; "Chee! I like food well well, and people wey dey straight forward, I dislike pretenders ooo..."
Toh, to the real koko about who she really be; "I just win Miss Face Of  Arts South West Nigeria... For face of art contest 2018/19..." Na so i shine eye con ask; How you take reach there? "Hmmm! I get there through my mother encouragement and support ooo..." Woooow!  See Mother'd love na... As e con be like dis,  we know say this kind person go one use her Crown do better thing, especially to make her Mama proud. So she talk say;  "I hope to achieve better akpala kpala way I fit use source for widows and their children.." Una see why I say this one na "Beauty With Brain." Onto her final-final tori, especially to people like her, she say; "My final message to youths be say...'Nothing good dey come easy, so any little opportunity way dem get to use explore, make them use am well well...Thank you😍"

Na wa o! Police rescue man from mob wey wan lynch am, after him stab one girl to death for Owerri, Imo State




(From Deborah Odoekwu...)



Ewoo
Katakata don burst for Imo state as people join beat one man rango rango. The story wey follow the matter  be say this man wey dem beat so bn use knife take chuk one girl sotey she die for Owerri wey dey inside Imo state. This people wey gather am come dey beat am for don kill the man if to say Police no show for the place o.
This man so, some people talk say im get sko sko for head, others come talk say na yahoo yahoo boy wey im be, wey wan do money rituals. These people come catch am, come hold am sake of say im use knife take chuk one young geh till she die for Douglas market wey dey Owerri for Imo state.

hmmm dem beat dis man tink tinka nd dem almost use fire take roast am before Police dem bn show for the place come handle the matter.


As dis one come dey happen, n aim people for internet come dey drop comments. One of them wey be Successman moneyman come talk say “ abeg, e get yahoo yahoo guy wey get sko sko for brain?” another person, Vivian reginalds come talk say “he go sha rotten for prison”
Hmm wetin this man do, no be am at all o. but even tho make una no dey take laws into una hands. We get police, army, DSS dem wey una go fit carry dm go when something like dis, abeg. I hope say our Ogbonge Police people go handle the matter well well

Kai! Man Knack Him Own Wife To Death for Niger state





From BUSAYO OLOWOOEKERE. ..

One man done put himself for inside serious trouble sake of say him kill him wife becos of accuse say she dey do love wantin tin around with other men
 The Niger state done arrest one 32 years old man sake of say him beat him wife with firewood till she come die, the punch report say the police pipo wey dey attached to the Lapai dividion for lapai local government araea of the state been catch the suspect Jibrin Abu.


Abu wey come from Dabogi village for inside lapai been kill him wife wey her name na Victoria Aliyu becos say him suspect say she dey do cunny cunny love with other men.

We hear say the suspect been use heavy wood take send him wife go her early grave after him donwarn her well well.

Northern city news gather say d suspect been warn him late wife say make she stop to dey pick calls from her male friends, but she no hear him warning. Abu talk say him use wood kill her because she no hear him warning say make she stop to pick her male friends call for inside him house say as dey start to come get one hot argument na him kill her.

The suspect talk say him wife na disgrace to womanhood say she done drag the name of the family inside mud. Him talk say him late wife been dey bring men come inside their house and say their culture no support am, say that’s why him kuku kill her to save the family from shame.

The Niger state police command Public Relations Officer, Muhammad Abubakar confirm this matter as him talk say the suspect done confess to the crime.

Abubakar  talk say after Abu kill him wife him been wan kill himself as him been try drink one insecticide, but them rush am go Lapai general hospital by police pipo and dem treat am. He come talk say them go carry the suspect go court soon.

Ehyaaa! First wife receive one kind unbelievable punishment from Husband because say she greet second wife




From BUSAYO OLOWOOEKERE


One woman wey her name na zainab Ahmed don carry her husband wey him name na Oare Abdulrazak go one sharia court II wey dey inside, Magajin Gari for Kaduna state sake of say him dey beat her.
As zainab wey dey stay for Hayin Dan-Bushiya take talk Abdulrazak been beat her becos she no agree to greet her co wife when dey been meet for inside market.
 Zainab talk say no be the first time wey him dey beat her say infact na the third time be this, and anytime she wan explain him no go gree hear her.
She still tell d court make him scatter their marriage becos her husband no no how to show her love and care anytime he dey her room
Abdulrazak wey marry three wives, talk say he only beat her ones and since then him regret say him do am and him apologized.
The Judge Malam Musa Sa’ad-Goma come tell the two of them say make dem bring their guardians come court during the next hearing wey be February 11.

Video: Armed men wey shoot and kill one ''kidnapper'' for viral video no be police officers but operatives of one sister security agency – PCRRU


https://cdn.punchng.com/wp-content/uploads/2019/01/30141421/Edo-shooting.mp4


(From Ali Ina...)



On Tuesday morning January 29th, some men, wey look like Policemen been shoot one unarmed man for Benin and this thing con cause plenty Nigerians to dey worry, dey ask why police go just shoot person wey dey unarmed just like that…
According to Instagram user, @CarrickDublin wey share the video of the Police brutality online, the suspect been dey try to run from the scene after them been catch am, na there the police con shoot am and as dem shoot am, him die immediately.
The Public Complaint Rapid Response Unit of the Nigeria Police Force (PCRRU) con disclose details of investigation wey dem carry out because of the viral video, wey according to dem, involve group of armed men wey shoot one unarmed man inside Benin City, Edo State.
For their brief statement wey PCRRU been issue, dem talk say, the armed men no be police officers but operatives of one sister security agency wey dem no call their name. Dem still talk say, dem discover say the suspects including the one wey dem shoot, na members of one notorious kidnap gang. Hear their statement:
"UPDATE ON # PCRRU908001
We don establish say, the armed men wey dey inside the viral video, no be officers of the Nigeria Police Force but dem be operatives of one sister security agency.
All the men wey dem round up inside the video, be members of one violent kidnap for ransom syndicate , wey dem track reach that location.
Meanwhile, Media stations for Edo state don dey give the arrest wide publicity so that people go dey aware of the true story."

Delta family Dey Vex Say Police Release Suspects Wey Strangle Woman...




From Ali Ina


The family of Ehianu Ugbom for Umu-Osi Quarters, Ekwuoma inside Ika North East Local Government Area of Delta State, don petition the state police command, sake of say, dem go release the suspects, wey strangle the mother of one six-month-old baby, Helen Ehianu, till she die…
The father of the deceased, Mr Augustine Ehianu, don call on the police say, make dem re-arrest the suspects and make them face prosecution.
The thing wey happen before now be say, some persons been strangle one Twenty-eight-year-old Helen, con dump her dead body inside pit for Obior community, Aniocha North Local Government Area of the state, and this one na after dem been don declare say she dey miss, since on March 22, 2018.
Na for March 24, 2018 wey d police operatives con find her dead body… The elder brother of the deceased, Samuel Ehianu, dey talk say the victim friend, Precious Mmaduneme, get hand inside the matter… Because according to am, The deceased and Mmaduneme been commot from her compound wey dey inside Ekwuoma for Ogwashi-Uku on March 22, 2018, for the treatment of her epilepsy before she meet her untimely death.
We con hear say, Mmaduneme been joinbody with Precious Nwali and Chikodi Emuka to commit this kind crime.
We also hear say, the suspected killers of Helen, wey be child traffickers, been run with her six-month-old baby, wey dem later recover after the operatives of the state police command been arrest the suspects.
But the family, inside one petition wey  P. E. Okwuokei-Ajabor of P. E. Ajabor & Co (Legal and Property Consultants) been sign, con appeal to the police say make dem quick-quick, re-arrest the suspects for the interest of justice.
As him talk with PUNCH Metro on Sunday, Helen Papa, wey be Augustine, dey complain seriously say, the suspected killers of him daughter, dey waka free without correct punishment by the state police command. Him still talk say, him don make several efforts to make sure say, the Police revisit the case but nobody wan answer am…
Him also dey plead with Governor Ifeanyi Okowa,  say the way wey them kill him daughter no dey fair at all, so make him enter the matter, so that other people wey get mind to do this kind thing for the state no go ever succeed or go free…
When we contact, the state Police Public Relations Officer, Andrew Aniamaka, him con plead for time so that him sef go fit investigate why them been release the suspects.

Chai! See As Fire Burn One Secondary School Student Beyond Recognition For Kano...




(From Ayim Raymond)

Chehh! Ooo, one young man don die for one fire outbreak for one building inside Kano state.
According to reports. We hear say, the kind fire weh burn this boy, nobody been fit recognize am. And we also hear say this boy been just graduate from secondary school come the wait for admission to enter university.


People try ooo, to save this boy but nobody been fit, because of the fire, na after the fire don burn finsh, na him them come go recover him dead body weh don roast finish.  May his soul rest in peace. 

Police Dey Hunt For Miscreants Wey Set FRSC Ambulance On Fire For Abuja




From Ayim Raymond


The police don start to the look for some people weh go burn one ambulance weh belong to  the Federal Road Safety Corps for Abuja.
We hear say this people go attack the FRSC post for Giri, weh dey for Abuja-Lokoja highway, come burn their ambulance.
The incident happen on Sunday weh this bad people go attack the FRSC post sake of say them fail to respond to painful calls weh them been call them say accident happen and four people died.
The FRSC Education Officer, Bisi Kazeem, confirmed the incident, as him talk say, the matter don dey the hand of police for investigation.
one police source talk say the don the make efforts to gbap the people weh get hand for matter
As them call the F C T Police talk talk person, Anjuguri Manzah, talk say, him been no no abut the matter say nobody been don tell am anything concerning the matter.

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land