Sunday, October 6, 2019

"My name na Agbo Praise Paul popularly called PRAIZEE. I be the Okpura 1 Oyi Igba"

Oya! We don enter market and our entry don produce better result, as we meet one of our young celebrity in the making, wey be one young man wey dey use im head well well as e be say Papa God sama am with better talent wey him don discover and dey use wella. Plus the many many things wey him don talk say him wan use this him talent do... Make i no talk too much as him take by himself talk the matter as e be... "My name na Agbo Praise Paul popularly called PRAIZEE. I be the Okpura 1 Oyi Igba" Hmm no be small thing ooo you go need to dey near am so dat you go fit pronounce am oo... Lol!
"Dem born me for Area 11 Garki, Abuja"

"I finish my secondary school for Government Secondary School, Gwagwalada Abuja as a  boarder for the year 2012. From there I troway leg enter City College of Education where I get my NCE for the year 2015. As God take do am, I con secure admission for Cotonou, Benin Republic where I graduate from Les Cours Sonou University from the department of International Relations." Oh boy dis him story wan make me speak in tongues but I go hold myself coz i dey gbadu the pattern wey him dey follow...


As him take continue, him say; "I don chuk hand for some creative things shaa. I be public speaker, actor, writer, singer and multi-instrumentalist (drums, keyboard, guitar, bass). Base on my personality wey pipo dey say I funny,
I don do MC for we 9ja here till I begin shine small small for Cotonou, Benin Republic." As him dey talk, wooooooooooow na the only thing wey my mouth fit talk aswear!
"But recently, as an experienced, qualified and certified teacher, I dey manage my own school - Royalland Academy. But this one no stop my creativity. October 1st 2018, I start 60 SECONDS WITH PRAIZEE wey pipo go just watch and na so so joy go full their body.

Make I start with the last one, 60 SECONDS na video wey youths and everybody go benefit because na strong message each video dey carry. You fit see am for this link here; https://m.facebook.com/story.php?story_fbid=942162406162941&id=770573659988484
"On top teaching, my passion na to help younger generation make dem sabi life properly."

"I never too tey for everything wey I yan above. But inside acting, I dn act as protagonist for movie and various stage drama within and outside we country."

Ontop wether him get mentor and who him dey look up to, him yarn say; "Make I no troway lie like this. As I dey do many things, I no get MENTOR. But na various ROLE MODEL I get. If I wan mention name, this interview no go finish." And  true true as the thing dey go sef d interview no go finish as I dey see ooo... Lol!

Toh, as him take enter gear 3, him con continue say; "I go teach till I go six feet below the earth. And na the same thing throughout everything wey I dey do. Especially my 60 SECONDS too. I never think to stop for once."

As the matter reach so, hear wetin him con talk when we ask am about wether him get plans to leave legacy wey go make people remember am always, na so him con yarn say; "I never too tey to dey talk about legacy. But make una ask me this question next time." Lol! See serious sharp guy ooo!

Anyway, ontop project wey him currently dey do, him talk say; "Project dey wey I don put my hand. But I no wan loud am yet." Okay, we go put ear for ground until that time when him go wan loud am...

For him final words to everybody especially upcomers, him con blow grammar talk say; "Idiosyncrasies are distinct, identity in personality is a pertinent morality." Na my talk be this and na my best advice to every body wey dey close - FOCUS."

Chai! This na correct guy with correct swagg and true true him sabi wetin him want and wetin him dey do... In case una get contracts for am as him don talk wetin him dey do, Una fit contact am for any of him social media handles wey dey under;
Follow Praizee ontop:
*Facebook: Praise Paul
*Instagram: @officialpraizee
*Twitter: @officialpraizee
*Email: paulpraizee@gmail.com
*WhatsApp: +234 818 412 5646

Check Royalland too:
Facebook: Royalland Academy
Email: royallandacademy@gmail.com

Make Una no also forget to comment, like, share and invite una friends to take style follow us for Facebook @Ali_Ina E2P

BBNaija 2019 finals: Mercy na di first woman Big Brother Naija winner

At Last Mercy Eke don win di fourth season of di Big Brother Naija reality TV show.

Afta plenty plenty drama, + romance + fight-fight, inside three months, Mercy ova take Mike wit 41 per cent to win di Big Brother Naija reality TV show.
Na so Frodd Seyi and Omashola chop eviction on Sunday night before dem announce di winner.
Di show wey begin on June 30th wit 26 housemates bin get three pipo wey become last pipo standing for inside di contest for di winning price on October 6 2019.
Wetin dis one con mean now be say, Mercy go pack 60 million naira waka comot from di house.
So far so good, we fit for dis point carry Congratulations take give Queen Mercy plus her fans dem wey vote am reach the winning level!

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land