Wednesday, November 27, 2019

EAGLE EYE PRODUCTION(EEP): "We dey into Film Production, Comedy, Event Management, Script Writing and Photography..."

Talents plenty for dis country and plenty young people dey try on top their own small way even though say money no dey, to take style do something wey go help bring their talents on top the general stage, so dat dem go dey recognized locally and internationally even globally... Hmm our waka today don carry us reach d domot of one special group of young people wey dey try no be small, dem no dey among d "lazy youths" but d "vibrant youths"  wey dey do legitimate hussle and e go good if we really appreciate dem d way wey we dey always do am... But before den, make we know dem;

"Our name na ‘EEP’ wey mean Eagle Eye Production..." OK EEP, before we go know wetin Una dey do, na which time Una start officially?; "We start officially for 01, Oct, 2018, for Karu, Nasarawa state..." Wow, dem don dey since 1 year plus now but as Una take start, shey Una get training and na where Una con get d training to dey do wetin Una dey do?; "Yes, we get our training for Biusphorus Creative wey dey for Abuja..." Dis wan mean say dem no just wake up say dem wan do something, dem go get training before dem con start. And if you look am well, na d first step to help d society reduce d rate of unemployment wey don plague we society... My respect for EEP don increase but make we hear wetin dem dey into... Dem talk say; "We dey into film production, comedy, event management, script writing and photography..." Okay, as e don be so, how una con take meet to start EEP? Dem talk say;

"All of us meet for industry. As up comers, we dey go audition, go set, but we con notice say we just turn friends, we get dis same vision. Na im we come enter dis mission..." When we con ask dem if things dey, wey dem wan achieve, dem respond say; "A lot. But first we wan dey use our comedy dey put smile and laughter for people face. We wan be d face of entertainment for Africa when e come to film making, make we carry Nollywood go de next level..." Dis wan sweet my belle well well but make we leave d matta as dem don talk... Onto how far dem don waka for dis career pursuit, dem yarn say;

Simon Anthony Nwoye AKA Nonsy
"Within d small time wey we come together say make we do dis, we don waka small go place like Asaba, Abuja and we know say d waka just start now..." Na so! Anyway, As we don dey draw near, when we go put full stop on top dis interview, na so we sharperly ask dem say people dey wey dem dey look up to, or who con be their mentors or groups or organizations wey dem dey look up to? Dem no think twice to tell us say;
Kenneth Terseer Gbande aka Kenny Terand
"Yes, we dey look up to people like HD film, Soul mate and Disney, u know say every boy wan pass im master, we aspire to dey greater..."
Omo EEP from dis interview don come to stay and if you check am well, dem don do their homework well well... When we con ask dem say we hope say dem go stay long well well to make impact, dem sharpely respond again say;
Jessy Anthony AKA Blacki
  "Na our life be dis..." Toh as we don hear firsthand from EEP, na so we kukuma con ask dem say which kind legacy dem wan leave wey go make people remember dem every time, dem talk say; "We wan make our work give us good reputation and legacy, na wetin we wan leave be dat..." As e don reach dis level, we con still ask dem wether projects dey, wey dem don do or join body do, na so dem con talk say;

"Apart from our comedy we don join body with other production house produce Tv series wey still dey on post production, we don join body do Award event wey be STIJA(Sometimes In July Award)..." Wow! As oyibo dey take talk am, na small small steps dey make person reach im destination... We believe say EEP go definitely reach their destination with all these things wey we don hear from dem today. Before we escort dem go their Luxurious Space Bus, we just say make we ask dem wetin be their advice to people wey just dey start? Dem talk say;
     Peter Obi Ekenedirichukwu AKA Sir AK
 "Put God first, hard work and direction..." Las las nko, wetin una go like talk about?; "We go like to talk about d industry structure, make goverment come in and also make policy  wey go help tackle piracy. Thank you..." Toh, dat na how much we fit take for today but In case, you get job for dem or you go need their services as your own way to encourage dem, you fit comment under or reach dem for their social media handles:
FB: @eppcomedy
IG: @eppcomedy
Dis na one of the many jobs wey dem don do so far;

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land