Friday, November 29, 2019

AACE MONTAGE: "My name na Adebisi Steaphin(Aace montage), i be Cinematographer..."

We don come again😁 and as usual we dey like to celebrate young talents wey try on top their own small way to use the legitimate hussle wey dem find available to contribute their own quota on top nation building...πŸ‘πŸ½ Today no dey different because our waka don carry us reach d domot of Adebisi Steaphin wey film people dey call Aace Montage... As Una know how we dey always do am, we go allow our young guest make him introduce himself with him own mouth as we follow am waka on top dis interesting journey... As way of introduction, him talk say;
  "My name na Adebisi Steaphin(Aace montage)..." πŸ€£Bros no wan scatter pidgin before ooo but when reality hit am, na so him switch sharp sharp... Lol!πŸ˜‚πŸ˜… Him continue say; " Dem born me for inside Idah, wey dey for kogi state. And na on October 30th 199s..." OK see as bros take style put full stop for dat corner πŸ€”but we know say if we no find out today, tomorrow still dey... πŸ™„On top him educational background, him talk say;
  "i bin attend amazing height international school(primary school) then I con do my junior secondary with skyward academy and before i con finish my senior secondary school with St. Paul and Debbie international school and the las las, I do my higher institution for Wolex polytechnic wey dey for Galadima do Abuja..." As we move go front small so dat we go take style enjoy dis smooth ride with Aace Montage,πŸ€— na so we ask am say for benefit of d people wey know really know who him be, make him tell us who him be?πŸ™„ Him con talk say;

"By d Grace of God, i be Cinematographer..." Hmm to be cinematographer for we country today no be small thing ooo,πŸ€” na dem dey control camera shots for film and media and their knowledge of filmmaking and TV dey wide ooo...πŸ™ Meaning say, dis hussle wey Aace Montage dey so, e make sense die...πŸ€›πŸ½πŸ€œπŸ½ No ask me question yet ooo, make we follow Aace Montage finish, we go understand... Unto how him take start to enter dis career path, him talk say;
  "i love entertainment
Because d thing dey run inside my family bloodline, and I bin start since 2006 with Victor afolayan (Jagwa). I dey there dey learn how to light, before I con later dey do booming. Then from there again, I con start editing. Na then, I con go study camera handling..." Hmm if you see person wey go go far for d legitimate hussle wey him dey do, you go know... And Aace Montage na very good example...πŸ‘ŒπŸ½ As we con go front small, na so we con ask am say, who be him mentor(s) or person wey him go like to be like for d field? Him no reason am 2 times Like say him don prepare well well before we con ask am, as him talk say;
CLARENCE PETERS
  "I wan be like Clarence Peters for creativity..." In case you no know who Clarence Peters be,πŸ™„ him na Nigerian music video director, filmmaker and cinematographer. Him na also  founder and CEO of Capital Dream Pictures, one kind betta production company wey specialise for performing arts, film and video...😯 Omo! Why we no go begin to celebrate Aace Montage for d kind radical steps wey him don take? Anyway, make we leave matta for Matthias as we continue... Ontop d kind legacy wey him go like leave as him dey pursue dis him career, him talk say;
"I go like pass message give people through film and preach to the world..." As time no be our friend again, na so we sharperly ask am if any project dey wey him don do and go like make we know about am or d wan wey him joinbody do? Him talk say; "My recent project wey I love well well na "The prophecy" and dis wan na epic movie wey dey preach about sacrifice..." As you dey hear so, make you try go look to dat project so you go know how far Aace Montage don move inside dis him cinematography career... Before him sign out, on top him advice give people wey just dey start, him talk say;

"my advice dey simple "no give up and make sure say you dey focus..." Las las, as part of wetin oyibo dey call "appeal", wey me, I see am as "abeg" for pidgin,πŸ˜‹πŸ˜›πŸ˜œπŸ˜ him talk say; "Film sexual harassment don too much for d industry and all of us must try our best to take style dey always fight am..." Make we no forget to try encourage Aace Montage, comment under here to show say you care for young talents wey dey do legitimate hussle...

DIRECTOR T: "I be Music Producer and Lecturer..."

Show your Support for legitimate hustle like d wan wey Director T dey into... Just click here abeg πŸ‘‰πŸ½http://legeerook.com/dqH

Music na one art for Nigeria wey don give plenty youths wetin oyibo dey call "new lease of life"... As musicians for Naija dey increase, na so Music Directors and Producers sef dey increase... And e go good make we encourage some wey dey try for their own small corner because true true, na small small steps wey person go take waka, na im go determine how e go reach im destination but d most important thing be say, e must reach im destination... Dis na d reason why our waka carry us reach d front yard of Mr Tony Odeh wey dey popularly known as Director T... Oya as we normally dey do am, make we allow dis Thespian use him own mouth take chop d onions;

 "My identity na Director T but my real name na Tony Odeh... I come from Benue State but Dem born me for Lagos..." For those wey no know, Director T get plenty things wey him dey do but humility no go allow am tell us because him no dey Like too much attention.  Again, him na very sweet person to work with because of him training as Theatre Artist and Cinematographer...🀭 But🀫 make I no jump enta water for him sake like Teni Talk... As per who Director T be, him talk say;


"I be music producer and Lecturer..." Omo! E nor easy ooo which mean say na people like Director T dey discover people wey sabi sing well well con give dem platform to showcase and on top of dat him con be Lecturer for higher institution... Chai! I hope say Una wey dey look for Music Producers don ready to hook up with Director T? But make we slow down finish our talk with am... Unto wetin him go like achieve with wetin him dey do, Director T talk say;
  "I go like to help and promote upcoming artiste with small money..." Chai! See correct man with betta heart... If we get more people like dis, why Naija no go betta? Before we go front well well, we take style take am back, make him give us small of him educational background, him talk say;
"I attend Benue State University where I read Theatre Arts and I still do professional course with Mike Adenuga PEFTI school for Lagos..." Ehen! Sebi una don hear am from im mouth now... As Director T don reach dis level we con feel say, e go dey proper to ask am who be him mentor? Him answer sharperly say; "My mentor na Samklef..." For those of us wey no know who Samklef be, him na legendary music producer, artiste and producer of Wizkid hit single, "Tease Me"... 
SAMKLEF
Omo! See how people dey dream big ba! Big ups Director T jare, e nor easy but e dey possible... Unto how long him don dey pursue dis career path, him talk say; "I don dey do music for 2years now..." Wow! No wonder when we ask am say na which kind Legacy you go like leave wey go make people remember you? Him no waste time to yarn say;

"I go like leave same legacy like Samklef..." Omo! If Samklef read dis interview, I sure say betta check go enta our hand... I mean am ooo! Lol! Toh before we match break do dis session, na so we sharpely ask am wether him don produce any artiste? With betta smile for him face, him answer say; "I get plenty artists wey i don produce and i dey promote dem for Lagos from my studio..." Wow Director T no b small Music Producer ooo and him works don dey even speak do am sef... Las las, ontop Director T advice to upcoming artists, him talk say; "My advice to upcoming artists na say, small talent with big humility go take u go far but big talent with plenty pride no go carry u go anywhere..." Hmm dis na betta advice so if you get ear, make you hear ooo! To reach Director T, you fit comment under here or reach am through him social media handles;
Facebook; tonydickson 
IG; cimtechstudios

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land