Monday, December 16, 2019

AJAH CHIDINMA PEACE: "I don contest for Miss Empowerment and my experience for all dis thing wey I dey do, help me well well..."


Make una no just jump dis link ooo, help our correct hustle as you click dis link πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/MsS πŸ‘ˆπŸ½ The blessing wey God go embarrass you with ehn, no be here ooo!


As the year don dey end small small, and the season of celebration still fresh, na so to celebrate some of our youths wey dey do correct hustle, still dey fresh for our mind too... Today our waka don carry us reach d front yard of one passionate babe wey don dey do correct hustle for some time now and as our eye jam dis babe, na so we say lai lai we must hear her story ontop here so dat country people go fit celebrate her wella... Make una no forget say we go happy and e go make sense well well if una go try leave comment of encouragement under dis post... Ladies and Gentlemen, make we meet our guest today;
  "My name na AJAH CHIDINMA PEACE... Dem born me for Niger state Bida on the may 9th 1995..." Wow!  Make I wait before I talk so dat my talk go carry weight small... On top her educational background, she talk say;  "I do my primary school for Niger state, con do my secondary School for Government Secondary School Nyanya for Nasarawa State Abuja..." πŸ€”HmmπŸ€” from Niger state to Nasarawa State, dis na power of education but na person wey wan learn like Chidinma Peace, fit get liver to dey move d way wey she bin move... Anyway make we continue as she dey carry us go somewhere... On top who she be now and wetin she dey do now, she yarn say;
 "I go still say I be student because I go love to go back to school next year... But Right now d things wey I dey do plenty small, I Sabi cook, make hair, sing, dance, manage business and most of all ooo I Sabi act..." Chai! Dis babe dey versatile as oyibo dey call am oo(Google na your friend, ask am for wetin e mean🀷🏽) As we continue, na so we remind her say we hear say she also be model and she bin suppose appear for Face of Arts Beauty Pageant but we no con see her, na wetin bin happen? She respond say;

  "I bin contest for FABP, but I no come meet up with the competition base on one tin-one tin money no come dey😭 the tin pain me!!!!! As I see say I no fit meet up, I don contest for Miss Empowerment and my experience for all dis thing wey I dey do, help me well well... I don learn many many things o, meet many people, meet new friends I come get new ideas wey dey help well for some things wey I wan do..."

Toh na betta thing say as she dey ontop her waka for correct hustle, she dey learn things well well... Na here we con ask her say, na wetin she go like to achieve with wetin she dey do? She talk say; "I go like achieve many things... I go love be face for one big companies too or even magazines ooo..." Wow see young girl with betta dream... As we don reach dis level we still con ask am ask her say na how far she go like to go inside dis her correct hustle? She no waste time as she talk say;
  "I go love go far for life to achieve my goals by the Grace of Almighty God..." On top all her talk she still recognize say no be by her power or wetin she sabi but na by d Grace of God... Omo! Dis babe go go far... Make I no start to prophecy ooo but d evidence dey real... As we don dey finish dis session of interview with Chidinma Peace, na so we ask her make she yarn wetin dey her mind make country people follow her reason... She con talk say;

"So I go like make una support me to reach my goals and I go love to contest for FABP next year. And even other many many things wey go follow am... Las las, I wan thank does people wey wan support my dreams. God go bless u well well.πŸ€—πŸ€—πŸ€—" Na so, we don hear am from Ajah Chidinma Peace and we go join her faith to make sure say she achieve her dreams finish...

Make una no just jump dis link ooo, help our correct hustle as you click dis link πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/MsS πŸ‘ˆπŸ½ The blessing wey God go embarrass you with ehn, no be here ooo!

Today Matta With #ESRAPHAEL! VOL 3

Abeg take style click dis link to support our correct hustle... We no fit thank you enough sha but God go bless you well well πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/Lnx πŸ‘ˆπŸ½


Today Matta With #ESRAPHAEL! VOL 3

For inside organizational science of the art, loyalty no be big thing for moral standard on im own but na product of social relations within professional and wetin oyibo dey call ethical standards...

Na me still be your humble boy #ESRAPHAEL(Raphael Stephen)

 No forget to click dis link to support our correct hustle ooo... Na una dey make us exist... God go bless una well well... πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/Lnx πŸ‘ˆπŸ½

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land