Thursday, January 31, 2019

Slay Queen + plus Okra Soup = Breakup With Boyfriend... Lol!




From Ali Ina...



Make I first laugh for pidgin before I bring una this story… Kwakwa-khikhi-heheehehehe-lhualhualhua…(if you sabi, you sabi) ………  One Slay Queen wey dey for Facebook as Ntiwuka Jessica don carry cry come social media, after her boyfriend been dump am because of the okra soup wey she cook for him family.
According to the Slay Queen, the boyfriend never pick her calls since then, wey mean say him been dey disappointed at the Okra soup and maybe him no longer dey interested for the relationship.
The Slay Queen come carry her matter come social media platform, dey request say make the boyfriend refund the money wey she spend ontop the cooking of the food because she sef no longer dey interested for the relationship.
Ntiwuka Jessica write say:
“Abeg I want justice ooo. So this guy wey say him wan marry me, con call me on Saturday make i come make food for him whole family and him also introduce me to him parents, so I con ask for money to buy foods stuffs wey I go need, him talk say make I use my own, say him go pay me back later, I say Ok, after I make the sweet soup and Eba, I con go, up until now this guy never pick my call, and him never call back, infact I no wan marry again ooo, all I want now na my 10k wey I used for the soup ooo, abeg make una advice me how I go take get am back.” Toh, you wey hear am, na which kind advice you wan give this kind person now?

Photo: One Woman Thief Pikin Inside Anambra Hospital






From Ayim Raymond...



The Anambra State Police Command don arrest one 35-year old Dorathy Sunday, sake of say she go steal one five day old twin baby boy for the maternity ward inside Nnamdi Azikwe University Teaching Hospital Nnewi, Anambra state.
One statement from the command police talk talk person, SP Haruna Mohammed, talk say the suspect sneak into the Nnamdi Azikwe University Teaching Hospital Nnewi around 5pm yesterday January 30th come steal one five day old twin baby boy for the maternity ward inside the hospital when the mama of the baby, 22-year-old Mmadu Happiness Miracle weh dey com from Uruagu, Nnewi, been dey the hospital compound dey wash her clothes.
Anyways, bad market been follow the suspect, when the Nurses fo the hospital gate com see her kurukere waka, na so them come raise alarm as dem com arrest the woman.
Meanwhile, dem recover the pikin weh she steal, and the case dey the hand of police and very soon them charge her go curt fo prosecution.

OH NO! Chai! People Wicked o...




From Ayim Raymond...



Chi! Glory Omo-Ohwo, weh go the her 20s and mother-of-four children, them don kill am after them rape am for Yenagoa, Bayelsa State.
We gather say this woman weh be fish seller  wake up around 5a.m, on Tuesday, January, 29, 2019, to smoke some fish, as she the prepare for the weekly Mbiama market day.
 when her children later wake up, them come see her only one leg of their mother’s pair of slippers. An the next day weh be yesterday morning na him them go see her lifeless body for one uncompleted building near their house, na so this people skater skater her head.
Any way we never hear anything from police ontop the mater sha.
May her soul reasce in peace





Ha! Pant Matta Again!!!



From Fadabubu...



Dem done arrest one 25 years old panel beater wey him name na Adejoh Ojonugwa for ondo state sake of say him been steal himbrother wife underwear.
The officer of the Ondo state Police Command after them been report the case. Dem been catch the suspect with one prophet Olajide.
As dem dey ask am questions na so Ojonugwa wey come from Kogi state talk say as him visit the prophet for spiritual cleansing na there  dem pray well well for am , him come talk say d prophet come ask am which work him dey do, naso the prophet come give am something for hand sake me him swallow am.
As him swallow am naso him come dey look for him brother wife underwear as him come see am, na so him come carry am go give the prophet for ritual, him come talk say some minutes later na him the brother wife come shout say dem done steal her underwear and naso dem arrest am.
Him still come talk say when dey arrest am, dem carry am go Uso police station before dem carry am come Akure. Him talk say two of the things wey him steal na for him brother wife and the remaining three na for him sister.
The prophet talk say him no no wetin dem dey talk about, say the suspect been dey lie for him head.
Femi Joseph wey be the talk talk person for the ondo state police command talk say dem arrest the suspect and the prophet last week.
Joseph wey be deputy superintendent of Police(DSP) talk say this case of say dem dey steal female underwear done too much as him advise ladies make dem dey shine dre eyes well well,he talk say dem go charge the suspect go court soon.

Na wa o! 45-year-old Man, Rape Him Daughter, Say Na Devil Cause Am...



From Fadabubu 


The ogun state police command done arrest One 45 years old man wey him name na Idowu Owolabi... Sake of say, him use force enter him 21 years old daughter.
As the state talk talk person for the police wey be Abimbola Oyeyemi talk say Owolabi wey get 3 wives start to dey enter him daughter last year for their house wey dey for Papa Olosub area for inside Oja-odan for inside yewa south local government area of the state.
Them arrest this suspect after him daughter been report am give police pn January 28.
This girl been report say she follow her father go farm for inside Fagboun village and na so her father come use by force enter her for inside farm for march 2018. She still talk say na so her father continue to dey use by force enter her and him still come tell her say him go kill her if she tell anybody.
As dem take get the report, na so the DPO of Oja-odan wey be CSP Olayemi Jacob been lead police pipo go this suspect house and na so them arrest am sharp sharp.
Abimbola still come talk say the commissioner of police Ahmed Iliyasu done give order say make dem transfer the case go one state criminal investigation and intelligence department  so that dem go shine eye inside the matter well well and make sure say d law take en cause.

Hmmm knife Attack 4 Human Rights Radio 101.1fm Abuja...




From Ali Ina


See Pictures of one middle aged man Boniface Abba wey carry first-class wickedness, attack one man with knife in front of Human Rights Radio and Television, Kaura district Abuja today Thursday 31st January, 2019 just when the Brekete family program dey go on.

The attacker wey say him be painter and dey live for Gosa, along airport road inside Abuja, talk say him come Human Rights Radio sake of say him wan lay complain.

But we con gather say, Boniface don dey come Human Rights Radio for the past four days but because of him nyamma-nyamma behavior,  security officials wey dey attached to Human Rights Radio and Television con block road for the man so that him no go gain access to the premises.

Dem Don carry the victim go hospital as dem hand the attacker, Mr.Boniface Abba, over to the police for further investigation.

We go keep una updated as we get more tori ontop the matter...

#bbcpidgin #newsinpidgin #pidginblog

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land