Tuesday, November 5, 2019

Humanity or Inhumanity?

Dis picture of vulture wey been dey wait to begin chop one Sudanese pikin, bin dey everywhere ontop social media and dis wan na during the 1993 famine wey bin happen for inside Sudan. And na one Kevin Carter, wey be South African photojournalist wey later win the Pulitzer Prize for dis kind 'amazing' shot... And na so everybody just dey celebrate am for dis achievement...(Dat wan no be d tori).

Kevin bin however, con live just few months to enjoy im supposed achievement because depression con choke am, and later him use him hand cut him own life short(suicide)!

Him depression bin start when during one of him interviews (wey be phone-in  programme), person call for phone inside d Program con ask am; wetin happen to d Sudanese pikin? Him con answer say; "I bin no wait to find out after i take d picture because i bin get flight to catch..." Na here d person con reply say; "Make I tell you something wey you no know, two vultures bin dey there dat day; and one bin get camera for hand".

As him continue to dey think about dat statement, na so e lead to depression and las-las d ultimate suicide.

Make una listen o, For Inside anything wey we dey do, make humanity come first, before wetin we fit gain for d situation.

Kevin Carter for dey alive today and people for even celebrate am well well, if for say, him bin just pick dat Sudanese pikin from d ground, con carry her go the United Nations Feeding Center where she bin dey attempt to reach.

Inside everything wey we dey do, make we always dey think of others and how we fit help humanity.

And even when we dey pursue elective office, make we dey think of how we fit use am to benefit the people first before anything...

Better and New Nigeria dey possibleπŸ™πŸΌπŸ‘πŸΌ

Why Oscars disqualify Genevieve Nnaji 'Lionheart' feem


Image examAccording to BBC Pidgin, Di Academy of Motion Picture Arts and Sciences wey dey organise di 'Oscars' for America don disqualify Lionheart from di 'Best International Feature Film' category because dem use English act am.

Di feem wey Genevieve Nnaji direct dey for English and Igbo, however d koko be say, dem speak English pass Igbo for di feem.
One of di requirements wey di Oscars dey give for dis category, wey dem dey call 'Best Foreign Language Film' before, na make dem no speak English for di film.
Tori pipo The Wrap tok say di Academy tell voters say dem don disqualify di feem for email wey dem send on Monday. Di feem supposed screen for voters on Wednesday.
Last month, di Academy announce say 93 kontris submit dia films for di category and ten of di films come from Africa. Lionheart disqualification don take di number down to 92.
Ogbonge American director Ava DuVernay wey comment on di mata, feel say dem no supose disqualify di movie as English na Nigeria official language.
Genevieve Nnaji tok for Twitter say di movie represent how we dey speak for Nigeria and how English be di bridge between all di languages for di kontri.
Other pipo don dey para ontop social media wen di news of di disqualification reach dem.
Nigeria Oscar Selection Committee for dia response to di disqualification for inside statement wey dem release say dem go learn from dis experience.
Chairperson of di committee, Chineze Anyaene tok for di statement say because filmmakers wan produce film wey go get wide reach, dem gats do am for English.
Dem add say dis one na eye opener as Lionheart pass all di oda requirements wey oscars want.
"As we dey move forward we go dey submit film wey dem no speak too much English inside. We want ask filmmakers say make dem shoot film wey no get English as wetin we go use measure di ones wey go represent di kontri for di ogbonge award."
"Di committee go work to organise workshop, seminar and use available media to create more awareness on wetin di guidelines be to submit feem for di International Feature Film Entry." she tok for di statement.
Lionheart movie na Nigeria first submission for di Oscars.

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land