Wednesday, January 16, 2019

Some Gunmen Don Attack One Woman, Her Driver As Dem Dey Go Bank For Port Harcourt; kill Police Escort And Theif Their Money Run...




From Vivian Sunday... 

We hear say some gunmen wey dem suspect to be armed robbers, don kill one mobile police officer for garrison roundabout, Port Harcourt Rivers State.
Eyewitness say this people dey follow company vehicle wey just dey comot for bank and say na the police man been dey escort the vehicle.


This thing happen on Monday, as the vehicle wey the police officer escort reach garrison, na so another motor con block am , two men comot from the moto con shoot the police man... 

As dem shoot this man for different places,  na so im die for the spot, the driver and other people for the company moto sustain injury but they carry them go hospital. The police talk talk person don confirm the incident.

#10YearChallenge Mistake! One Lady Boyfriend Dump Her After Him See Say She Been ‘Dark’ 10 Years Ago



From VIVIAN SUNDAY...


Shey I de tell una, no be every thing wey una see una go dey copy... See where dis one own don land am now... Dis thing wey just enter naija now, wey dem they call "ten years challenge",  wey u go put ur picture of how u dey ten years ago and how you dey for this 2019... The thing don make some people relationship scatter now...  Hmmm,  but as people dey use their own catch fun some people , some they cry as e scatter one lady relationship... This lady wey we hear say her boy, see her picture of how she black ten years ago and now she don yellow like pawpaw; that is to say she use bleaching cream for her body and now e don make their two years relationship scatter, sake of say the boy friend say hin no dey do again .
She con still say the boyfriend say e don dey see her now as person wey no dey proud of her skin complexion and say hin no go fit marry her...

Chai! See How 17yrs Old Boy Spend 2 Years For Delta Prison For Crime Wey Him No Commit ...



From VIVIAN SUNDAY

 We hear say one teenage boy wey dem imprison for two years over crime wey hin no commit for Delta sate, we hear say they don finally release am ...

According to reports wey we get , the 17 years old boy wey  dey sell for road wey him name na John Ogbonna , dey catch am for crime wey him no commit and this crime wey they blame am na say him be arm robber na so dey carry am go prison
After thorough investigation by the  Behind Bars Initiative (BBI), we con hear say this boy dey innocent of the crime wey they say hin commit.
But finally with report wey we get we hear say the boy been get misunderstanding with one motorist while hin been dey sell wrist watch along okpanam road  for Asaba Delta state, na so the man report am to Sars wey con lock am up unjustly. ..

Hmm One Uncle Use Byforce, Force Widow To Remarry, 17 years After Her Husband Don Die For Kaduna




From Ali Ina...



One widow, wey be Ramatu Kabir, on Tuesday don take by force, carry her uncle, wey be Wada Dan-Fulani, go one Shari’a Court II wey dey siddon for Magajin Gari, Kaduna, sake of say him force her to marry one Yahaya Alhaji.
The complainant, wey dey live for Hayin Dan-Bushiya, talk through her counsel, Nasir Abdullahi, say she been dey too mature make him dey force am into marriage, she dey pray to the court say make dem use their church mind take scatter the union.
“My client been lost her first husband 17 years ago, inside there, dem been get one daughter wey don be teenager now. Your Lordship, Na only after dem don enter marriage with Yahaya, naim she con even know say dem don force am enter… ” Na so Her counsel talk.
Abdullahi talk say, e dey very wrong for Islam, make Papa or Uncle force woman wey don marry before or never marry sef, inside marriage without her consent.
The defendant, wey dey represented by him counsel, Shuaibu Lawal, kuma con pray say make the court give them time to prepare their defence.
The judge, wey be Malam Musa Sa’ad-Goma, after him don hear matter from both Prosecuting and defending Councels, come shift the case to February 4 for hearing.

Police For Niger State Don Grab Two Suspected Armed Robbers....




From Ali Ina ...


Ha! NA wa o! When I hear this matter, I begin dey wonder how armed robbery take start, con take get grounds for Nigeria? Naim I discover say the thing get roots wey strong pass bamboo tree own oo, especially when you hear names like Badoo and Gadogodo of Lagos state, Shina Rambo also of Lagos State, Dr Oyenusi, Derico Nwamama of Onitsha , And Lawrence Aninih of Benin… Anyway that one na matter for another day…  The police for Niger State don catch two suspected armed robbers, wey dem accuse say, dem dey terrorise the people of Kpada village inside Lapai Local Government Area of the state.
The suspects names na, Umar Mohammed, 26, of Barkuta village for Bosso Local Government Area of the state, and Abubakar Abdulmumini, 20, of Kpada village, and dem been arrest them for motorcycle theft.
We hear say the suspects, been dey armed with dangerous weapons, wey dem use attack the house of one Ayuba Bako inside Kpada. As d thing no do them, na so dem con injure am join.
Them con thief him Q-Link motorcycle with number plate Abuja QC 326 YBA wey him say,him buy am for N220,000.
Northern City News, wey be online newspaper talk say, Mohammed and Abdulmumini, dey part of one  six-man gang, wey don dey terrorise Lapai since, plus including other parts of the state.
Mohammed talk say, dem dey always attack their victims based on tip-offs. Meaning say e get person wey dey always tell them before them attack… Him talk say,
“The moment wey we get information about our victim (Bako), na so we move go him house, con thief  him motorcycle. We don dey target am for some time now,” Na so Mohammed talk.
The Public Relations Officer For The State Command, Muhammad Abubakar, talk say the suspects call other gang members wey still dey run and their names na Gagare, Lere, Bature and Alheri.
Las-Las, him say the suspects go soon go court after dem finish with their investigation.

19-yr-old Boy Don Defile Him Sisters Wey Be Aged 6, 8...




From Olutimain Alvin...

One Ogudu Magistrates’ Court for Lagos State , yesterday, been remand one 19-year-old man, wey him name na Andrew Chinedu for  prison, because of say, them say him been dey sleep with  two sisters, wey be eight years and six years.
Them dey try Chinedu, wey be apprentice, wey dey live for Irawo, for two-count charge for watin oyibo dey call child defilement and sexual assault.
As them start the case, the prosecutor, wey be Inspector Lucky Ihiebie, tell the court say make them keep the accused for prison, as them dey wait to receive legal advice from the State Director of Public Prosecutions
Him talk say the accuse been commit the offence between June 2018 and September 2018 for Abayomi Street, Irawo, for Ajegunle area of Ikorodu for Lagos State. The prosecutor talk say the Lagos State Domestic and Social Violence Office, wey been first handle the case and confirm say true true , say Cinedu been clear the bush of the girls. Them come tell their papa make him report the case to police.
Ihiebie talk say the accused been dey live for the same compound with the girls papa and mama. According to ram, when them ask the senior sister question, she talk say Chinedu dey always call am enter room, when her mama and papa no dey arroud. Ihiebie talk say the girl talk say “ anytime wey I tell am say I no dey do, him go beat me. Him go tell me say him go buy me sweet, but him no go still by me the sweet.
The younger sister come talk say, “ Him go tell me say him wan show me something, him go come carry me go bed, come comot my cloth. Na as my sister sick na him them carry her go huspital, na for there she take talk watin don dey happen between them and chinedu.
The magistrate, wey be Mrs E. Kubeinje, talk say Chinedu go spend the next 65 days for prison as them dey wait to receive legal advice from the State Director of Public Prosecutions
Kubeinje, wey been give the ruling, been no gree hear chinedu beg.
Ihiebie talk say this offence contravene Sections 137 and 259 of the Criminal Law of Lagos State, 2015.
 Them don move this case go March 20.

One Tenant, 31, Don Beat Him 63-yr-old landlord For Lagos...



From Olutimain  Alvin


Them been bring One 31-year-old tenant, wey him name na Abass Babatunde, come court for Lagos because of say him beat beat and pons pons him 63-year-old landlord.
Babatunde, wey dey live for No. 8 Omo Osagie St., Iju Ishaga, for Lagos, dey face two-count charge for watin oyibo dey call assault and malicious damage, for one Ikeja Chief Magistrates’ court.
The Prosecutor, wey be Sgt. Michael Unah, tell the court say the accused been pons pons him  landlord, wey be Mr. Rahmon Adewale, him say babatunde been use blow pons pons all him face, because of one misunderstanding wey them get. Him say the accused been commit this offence on Dec. 26 around 9.30 for night.
Unah talk say the accused been spoil the padlock of the landlord gate, wey be like N2, 500.
According to the prosecutor, Babatunde been meet him landlord as him dey try to lock him gate, him come tell him landlord say him wan comot go buy medicine for him pikin wey dey sick. Na him the land lord say him no go fit comot, because of say time don go. And say e don late. Na that vex make babatunde pons pons him landlord come break the padlock.
The prosecutor con talk say This offence contravene Section 172 of the Criminal Law of Lagos State 2015, wey suppose give three years for assault and Section 339, wey suggests two years for wicked damage.
Chief Magistrate A. A. Fashola, been give the accused bail of N5, 000 and one guarantor, and say this guarantor must get work wey him dey do, and him dey pay tax to lagos state Government. him come carry the case go February 18...

Fireworks Wey we Know As Knockout Don Commot Fingers of One Student of UNIUYO As The Thing Exploded While him Still Dey Hold Am...





From AYIM RAYMOND 


 You no say our people talk say, wetin old man sidon for ground see, you weh still young, if you like climb Iroko tree, you no go still see am.
Our Nigeria government and police dey open eyes dey warn us about shooting of firework wey we no as Knockout or Banger, for inside the country so that we no go harm our self or another person. 
 See now as one student for University of Uyo don lost him fingers.
According to reports, the young man been dey follow celebrate on the 1st of January when this accident happen.
Them say the knockout been get seven rounds, as him think say na the one wey them the shake before e shoot, na so him come hold am for him hand come light am. As him light am, na so the thing blow immediately con scatter him hand. And them say the boy need emergency surgery weh go reach N1.6million.
And we hear say the boy na final year student for the faculty of education, for UNIUYO.

Na wa o! Court Don Grant One Chef Wey Rape 13-Year-Old Girl, Bail...




From AYIM RAYMOND

As na to dey waka waka, na him be our own, na him I say make I just enter that Nyanya side to find weda na Okpa make I take hold body before I Discharge, na him I go hear one kind thin weh smell me for Ear.
Na one 31-year-old chef, weh be Innocent Etim, na him dem don cari, on Tuesday to go answer question for on FCT High  Court, weh sidon for Nyanya, sake of say him use by force enter one 13-year-old girl. Them charge Etim ontop two-count, weh be, using by force to enter person weh dey near you (weh oyibo dey call, bordering on rape) and another one wey him say lai-lai, him no commit the offence.
The prosecuting counsel, Mr Samuel Offiah, talk say the man commit the offence on Feb. 13, 2018, for Sauka area inside Abuja. Him tell the court say the man use by force enter the 13-year-old girl. Offiah talk say the offence contravene the provisions of Sections 1 and 5 (1) of the Violence Against Persons (Prohibition) Act, 2015.
 Mr Dickson Umoru, weh be Etim lawyer come apply for bail. The judge, wey be Justice Peter Kekemeke, come give the man the sum of N20 million as bail and one surety wey get the same amount of money, him come adjourn the case until Feb. 21 for trial.

One Revenue Agent Don Go Beat One Catholic Priest To Coma Because Of N500 For Abakaliki Rice Mill..



From Deborah Odoekwu

I don see say any time I enter one state make I get chuen chuen, another one go just hold me for there. You know say chuen chuen no dey pass my ear like dat.
So, we come hear say dem beat one reverend father tinka tinka sotey im land for coma. Na im we say make we go chuk ear for the matta.
We hear say one of these area boys wey dey do “ha! Oga, anything for the boys” don beat up one Catholic Priest for Ebonyi state, wey im name be Rev. Fr. Mathew Orie, for Abakiliki Rice Mill Company, on Monday evening, sotey this reverend father enter coma.
From wetin we hear, the thing wey make this agbero beat am like dis be say the reverend father no gree roger am with #500, no be say im suppose pay am dah money o. we still hear say this reverend father dey the accident and emergency unit for Federal Teaching Hospital Abakaliki (FETHA), dey fight for im life.
From the chuen chuen wey we get this area boy bn standa for the gate dey collect money wey im no suppose collect from people wey dey enter. This Rev. Fr. Orie, na the principal of Girls’ Technical College for Agba wey dey Ishielu Local government Area for the state. Na im e come say make im go the rice mill go buy rice for im students and from wetin we still hear, im pay all the money wey im suppose pay to collect the rice but as im reach gate this area guy wey dem still dey find just block am come tell am say im must settle am before e go fit carry the bags of rice commot for the place. Toh the reverend father bn wan pay am the #500 naira before some other area boys wey dey there come tell am say make im no pay anything say im don finish to dey pay for everything wey e suppose pay for.
Person wey dey when this tin bn happen talk say as dem tell the reverend father say im don pay everything wey im suppose pay, im come decide to carry the tins wey im buy commot for the place, come say e no dey pay the area boy. Na there this area boy just descend for this reverend father come dey beat beat am sotey the man come enter coma. If you no wetin coma mean. Coma na dah time wey person never die but im still no dey alive. Im just dey the middle.
So as e take concern this matter, this person wey dey when e happen still talk say, na some police people wey dem call, na dem come carry the reverend father go hoispital where he dey still collect treatment.
The Police talk talk person wey dey Ebonyi state, Loveth Odah come confirm say true true this thing happen. She talk say dem don carry the motorcycle wey this agbero abandon as im dey run. Las las, she come say dey don carry the matta for head, say dem go make sure say dem find the guy, come gbab am.
Hmmm
Some people just no get fear at all for God. You see say the man na reverend father, you come still get mind to attack am. Hmm na God get your case! I just pray say this reverend father go quick commot from the comma wey im dey so.

Dem Don Catch One Fake soldier inside Ebonyi...



From Deborah Odoekwu...

I no know why some people go use their own hand dey give theirself problem. Trouble go just dey im own, you go just carry your two left leg come dey find am.
Now for Ebonyi state, dem don gbab one 25 year old man, wey im name be Moris Mbam, sake of say im dey parade imself as soldier when true true, no be soldier im be o.
As dem carry am commot for me and my fellow chuen chuen people, Muhammed Mustafa wey be the Commissioner of Police for Ebonyi state, talk say dem gbab this moris Mbam wey come from Izzi Local Government area for one bank wey dey Enugu as im dey try collect the money wey im don get from the kin koni koni work wey e dey do.
According to Police Oga wey dey for ebonyi state, this man wey dem gbab so dey give many many people wahala for that place as im dey use im fake army uniform dey collect people money and their tins. For 25 December last year, this Mbam come use this im style come collect some people house wey dey Abakiliki, say im come collect #40,000 and one Tecno phone form dem after im keep dem for like two hours for there.
Oga Mustafa, wey be the Commissioner of Police for Ebonyi state, come talk say this man don dey hold people, dey put fear for their body say im be soldier . n aim police dem come hear wetin dey happen, come arrest am. He come talk say even before dem arrest am, dem don dey find am since before dem come finally catch am come arrest am for 11 january, 2019. Im still talk say e don tey wey Mbam don dey carry im self as Soldier before some police people wey dey division A wey be the Central Police station for Abakaliki, come arrest am, say as dem dey shout dey ask am question, n aim e come confess say true true im do all these tins.
This man come dey talk say, im from Okpuitim community wey dey for Izzi local government area for Ebonyi state, say im no be correct soldier o, say im just dey carry imself as soldier sake of say im bn sell one phone wey be #10,000 to one person last year but the person come give am #7,000. So as im come back for November, im come ask am make e pay im balance of #3,000 but the man come talk say e no dey pay anything. Im come go meet the person landlord come tell am say make im tell the person say im be soldier, say make e tell the person make e pay am im balance if not kasala go burst o. Mbam talk say im tell this man say im be soldier so that the man wey dey owe am go quick pay im balance, say im never ever use dis soldier tin before, say na engineer wey im be o.
Hmmm, anyways, the Oga of Police for ebonyi State, Muhammed Mustafa don talk say dem go carry am go court very soon.
Oh oh…dis one wey dem don dey use uniform lie, abeg o take am easy. In fact, no even tink am because when dem gbab you, dey no go do you sofree sofree o.

Kano-Jigawa Customs Command Don Impound N100m Worth Of Smuggled Rice...

From BUSAYO OLOWOOEKERE

The Kano-Jigawa command of Nigeria Customs Service don seize over 3,000 bags of foreign rice and different kind of things wey our government don talk say make e no enter our country from this pipo wey dem dey call smugglers wey dey operate for that area.

This item dem if dem carry am go market go reach 100 million naira wey dem seize along Jigawa- Niger Republic road.
As dem take tell news stori people for their command headquarters for inside Bompai, for Kano state on Tuesday, the comptroller wey dey incharge of the command, Nasir Ahmed talk say dem don increase the way wey dem go take dey shine eyes put for those pipo wey wan smuggle things enter our country.
Him talk say this better thing come as dem been do collabo with Customs Intelligent Unit, the headquarters, information patrol team, the strike force, federal operations unit and other unit wey dey the service.
Ahmed begin cut warning give all those pipo wey dey smuggle say make dem commot hand from am and make dem do better work this year.



Police Don Arrest 28 Year Old Armed Robber, Mohammed Sani With Stolen Car, As Him Been Dey Try Run Go Niger Republic…


From BUSAYO OLOWOOKERE...

Police pipo don arrest one suspected armed robber wey steal one car and been dey escape go one neighboring country .
The Katsina State Police command don confirm the arrest of this car theif theif, dey been catch  Mohammed Sani wey dey 28 years old with one silver color Toyota Highlander as him won cross enter Niger republic.
Dem been catch Sani wey been dey live for Akwanga Local Government area of Nasarawa state around 8.30 in the Morning with the help of one good Samaritan.
The police talk talk person for inside the state, Superintendent Isah Gambo confirm am for one of him talk

Hear As him take talk :
"As we dey do our investigation , the suspect confess say him been rob and even collect the car from the person for gun point for inside Jos, plateau state"

"We still dey shine eye for the matter." Na so police take talk.


ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land