Saturday, February 16, 2019

SUZANNE EMMANUEL SHONEL - Wonder Woman CEO of Shonel's studio...

Omo! Who say Niger State dey carry last for Beauty? De person no think am well ooo because Suzan Emmanuel Shonel na testimony... No be mouth! No be scopes!  No be rhymes!  But dis na reality... Even though the Niger State born Queen no dey like to talk too much,  Atleast she been get time give us small insight for who she be,  wetin she dey do and other stuffs like dat wey go interest us wey be her fans dem...

Oya,  make we hear her; "My name na  Suzzan Emmanuels shonel..." Shey I tell una say she no dey talk too much but with her voice wey dey like ogbonge menu, wey dem teleport from white house,  any person wey dey near her,  con hear her talk,  go forget wetin carry am come near her because she get Beauty and she get Voice... Make I no talk too much... "Na 5th June na im dem born me... " Toh,  na there she draw fullstop  o!  No be my fault... Ontop her education, she talk say, the one wey una suppose to know be say,  she pass through; "Passion media academy..."
Ontop her hobbies she say dem be; "Taking photos, traveling, making money..." No be lie!  To make money na d real deal especially for the present dispensation wey we dey so . True-true, dis babe get sense... She never finish ooo... When e reach for her to tell us her likes and dislikes, she talk say;
"I like music, truth and peace..." Awwwwww ๐Ÿค—when she dey talk ehn if you get evil plan, you go just repent byforce... She con talk say; "I dislike lies..." She just dey simple,  soft and straight to the point... When we ask her say true-true who she really be?
With Angelic smile and voice she talk say she be; "CEO  Shonel's studio..." Dis babe na madam of her own Oh!๐Ÿ˜ฎ  Babe wey sabi her craft plus babe wey get plenty talents๐Ÿ˜... She talk say she don act for plenty big films too,  some of them include:
Searching

Karma's Law
*Searching
*Silent Conscience,
*Karma's Law,
*God of Impossibility(Inalegwu),
*Acid Test,
*Sacrifice,
*Aloma Kingdom.... Etc

Hmm,  ontop how she take reach where she dey now,  she say; "Na Prayers and support from family..." But as e be so, with plenty experience so far, she say; "Now I be Photographer, Cinematographer and an Actor..." Interestingly,  she be one of the very few females for Abuja wey dey do dis kind thing.  You no do mistake at all,  if you say dis babe na Wonder Woman, plus Small But Mighty African Queen wey soji...
Ontop wetin she hope to achieve in the nearest future she talk say; "I Hope say I go fit achieve Greatness with my office by starring in Hollywood..." Hia!  Dis one na biiiiiig dream ooo... In case you no understand, she mean say very soon una go soon dey see her ontop and inside American movies dem... And the way wey dis babe dey go, e be like say e go soon happen o!   For her Final message to youths wey dey like her,  she say; "Don't give up because nothing is impossible before God. Do not give up on your dreams, aim at it and go for it..."

See some of her photo shoots wey she don do by herself;

 
 
No forget to comment under here in case you wan reach Suzzan Emmanuel Shonels especially for business concine and make sure say you try encourage am too with small talk...

Dem Don Naked One Female Kidnapper, After Dem Catch Am As She Wan Use Juju To Theif Children For Ibadan (Oyo State)




From Fadabubu... 


Dem don catch and beat one female kidnapper as she been try to kidnap 3 children for inside Oyo state. This suspect wey dem identify as Tawa been meet this children for Mokola area of Ibadan wey be the state capital, where she been one kidnap them.
As one person wey see as this thing take happen talk say the woman touch the children with charm naso dey loose control and  she been wan carry dem commot for the area.
 She know no say one person wey dey sell goods for roadside been dey look her as she been dey dey do wetin she dey do. Naso the the trader come ask her say na where she dey carry the children go, as she no answer na so she shout make pipo come na so everybody come decend ontop this kidnapper.
Dey been give her serious beating before dem carry her go police station

“I don dey do dis thing for more than four years”- 35-year-old man wey dem arrest because say him rape underage girls





 From Ali Ina...

 As this rape matter just full everywhere, dem don arrest one man, Clement Nwachukwu wey be papa to three children. Dem arrest this man sake of say im rape two under-age girls for Niger state. This man wey be 35 years old bn rape these two girls wey one na 7 years old and the other one na 8 years wey she be, as he use #50 take deceive them. According to New Telegraph, this man, Clement nwachukwu bn use koni koni deceive these small girls make dem follow am go one uncompleted building where he come rape them. As dem dey sama am hot treatment dey interrogate am, n aim he come confess say im body dey sweet am anytime wey he see all these small small girls sotey he go lose control of imself. Say he no know wetin don enter am so wey if he see small small gils for im area he go just go rape dem even as im get three children. By himself by himself he come dey talk say wetin he done dey do too bad say he done dey do this tin pass four years now and e come be like say person curse am. Say he feel say he don sin against im destiny, say im dey always ask himself say what if him wife catch am. He come talk say he know say im own don finish and im wife no go ever forgive am. According to wetin Police dem talk, dem go soon carry Clement go court. God help us oo! Which kin thing be this na? kai. Nawa o

Ehyaaa, See Young Corper Wey Robbers Butcher For Nasarawa





 From Ali Ina...


 Luck don shine for One corps member wey dem dey call corper, wey dey serve for Mararaba for Nasarawa state as im just manage still dey alive after some robbers wey bn dey try snatch im phone bn use cutlass design im body. This corper wey be Omoregbe Hossana wey be graduate for Houdegbe north American University, bn just step out last night make e show person road. Na im these rugged guys just come attack am with cutlass come dey ask for im phone. Na one security man wey show for the place, n aim come rescue the guy even tho dem cut am with the cutlass too. Dem come rush dem go Mararaba Medical Centre sharp sharp where till now dem still dey try get theirself. According to him fellow corpers wey dey that side, dem talk say dem dey always fear because robbers dey always show for that side. So dem dey always fear make dem no come thief from them. This one now dey happen after Police people wey dey nasarawa state bn arrest three suspects say dem bn kill one other corper, Samuel Makene for Akwanga Local Government wey dey nasarawa state. I no understand wetin dey happen with these bad people and corpers oo but make we dey careful, make we no dey waka for night, at least make we kuma do our own part to avoid all these tins because this country hot o! people no dey smile again o! Sha sha we hope say our Police dem go catch these bad people wey do this bad tin.

See Drama As Victim Cut Rapist Manhood With Razor For Katsina




 From ALI INA...


 Information wey Police been obtain from the Kankara General Hospital, Katsina State, naim lead to the arrest of one suspected rapist, wey na the victim commot him manhood. The suspect, Bishir Yau, of Yargase village, dem been rush am go hospital for treatment. After, information about all him atrocities con leak for police, na there him bolom-bolom con burst. We learn say the victim struggle sotay, she been no dey successful to free herself from the way wey Yau been hold am. Na so she just commot razor blade wey she con use cut off the man manhood. According to the police, the 30-year-old suspect, been use cunny-cunny carry the 14-year-old victim wey been dey live for the same compound with am, go one nearby uncompleted building, where him con rape her. Na so she struggle till she no firt again, she con commot razor blade wey been dey with her, take commot the man manhood… The police don already charge Yau with rape under Section 283 of the Penal Code. The suspect, wey dey currently on bail, dem don direct am say make she appear before one Katsina Senior Magistrates’ Court on April 4, 2019, for arraignment. The police prosecutor, Inspector Sani Ado, tell the court on Friday say, investigation for the case don complete. The presiding Magistrate, Fadila Dikko, con direct say make Yau appear before her too… Katsina

Man tortured to death for buying stolen goat in Bauchi





 From ALI INA...

 Some suspected members of one vigilante group, Yan Kwamiti, don torture one 28 years old butcher, wey dem identify as Abdulrazak Hassan, till him die, because say,him buy stolen goat inside Wunti Dada area of Bauchi metropolis. The father of the man wey dem butcher, Sarkin Pawa Wada, talk say the incident been happen last Friday. As him been dey explain, him talk say, “Wetin happen be say, I been no dey for house, but one man wey dem dey call, Malam Abbas, wey be the leader of Yan kwamiti, talk say, dem been catch person with goat and dem carry am go their office. So, when them carry am go their office, my son been dey busy for him place of work.” Him talk say, na so Malam Abbas con send him boys make dem arrest him son just because they ask the man wey steal the goat whether him know Hassan and him talk say yes, him know am… “When dem bring (Hassan) to their office,” Wada continue say, “them con discuss. I no know wetin dem discuss sha, because I been no dey there, but I learn say them later release the suspected thief. Them con call the owner of the goat, con return the goat to am. “After that one, them con bring another issue of ram, something wey my pikin no know anything about o. Malam Abbas con give them fine of N10,000, while the other people been pay N7,000 and him collect am. Then they con kill my son; carry him money, him handsets, before dem con carry him dead body come my house but thank God say people been see them.” Him add say, “when I come, I quick-quick, rush go see the community leader of Wuntin Dada. I con inform am about the matter. Na there him con draw the attention of the Divisional Police Officer, GRA.” Wada talk say the DPO sharp-sharp con send him men make dem go find out wetin really happen. As we dey talk, Police still dey ontop the matter as hospital as dem dey plan to bury the boy according to Islamic rights… Bauchi
Confusion As Residents Beats Pregnant Woman To Death For Alleged Witch craft

 From ALI INA... 


 The Commissioner of Police for Adamawa, Mr. Moses Jitoboh, don confirm the arrest of five suspects because say dem beat one pregnant woman to death because according to dem, she dey practice witchcraft. Jitoboh tell talk-talk people inside Yola on Saturday say the 32-year-old woman, Ayina Afraimu, wey come from Falu village inside Guyuk Local Government Area of the state, and dem been kill am with sticks and rope. According to Jitoboh, the Suspects wey committ this offence na; Abraham Adamu, 18, Malachi Yilafane, 35, Thomas Aji, 54, Zakariya Chorum, 56 and Miss Newana Ilihal, 20. Him also add say, dem go charge the suspects go court for wetin dem call culpable homicide, criminal conspiracy, and defamation of character. Make we no forget say, Witchcraft or witchery na the practice of and belief inside magical skills and some kind abilities dem wey person or people dey exercise. But for Africa, dis one naim we dey call “juju” Adamawa

TRAGEDY! Notorious Kidnappers Killed Reverend Father In Sokoto State (From Ali Ina...)

 Some suspected Kidnappers don kill one Reverend Idris Jatau inside Sokoto State. This man, we hear say na graduate from the Crowther Graduate Theological Seminary, Abeokuta, Ogun State. Dem been kill am on Saturday while him been dey travel with him family wey these kidnappers don catch and dem dey hold dem hostage as we dey talk… Na one close friend of the Reverend, Chike Onuigbo, na him enter him Facebook to mourn the loss with other people dem. Him write say him dey feel pain, and say make him brother Reverend Idris Jatau, Go rest in Peace! Police don recover the Reverend corpse already and dem dey ontop investigation to release d other people wey still dey with the kidnappers and to catch these bad people dem… Sokoto 

Selling your vote is like selling your destiny' - Lai Mohammed

 From Fadabubu...

 The minister of Information and culture, wey be Lai Mohammed don carry advice give Nigerian people say make dem no sell their vote o, say to sell their vote go be like say dem dey sell their destiny. Him talk this one on Saturday for one workshop for Broadcast media coverage for the 2019 elections wey National Broadcasting Commission (NBC) for Abuja bn organize as dem dey talk about fake news, hate speck, vote buying and PVC buying. As im dey represented by Miss Grace-Isu-Gekpe wey be the permanent secretary for the Federal Ministry of Information and Culture, im talk say make we no sell our destiny because if we do like that, we know wetin e mean. Dem come dey advise journalists say make dem use their position take work with government, so that dem go help to handle the matter as e take concern fake news, hate speech and vote buying. Even as election don near so, make we shine our eyes well well and make we vote for person wey we know say e go fit lead us well.   
Lady shares touching story of how her colleague died while being rushed to the hospital because of Apapa traffic in Lagos

 From Fadabubu...

 One twitter user @otybe don share one story of how her colleague been die as dey been dey rush am go hospital becos of Appa Traffic for inside lagos. She talk say this thing pain her well well as this her colleague dey very hardworking as she talk say her colleague wey die for no die if to say emergency road been dey and if to say trafik no dey. May the soul of this person rest in peace.
Man, woman found dead inside car, Lagos state.

From Fadabubu...


Dem see one man and one woman dead body inside one motor, but we never know wetin really kill dem. Police talk say dem don start to dey shine eye for the matter to know wetin really kill dis pipo. Dem been see this man and woman wey dress well inside one motor for Maryland for inside lagos on Saturday morning. Pipo belive say dey fit dey talk because of de way their body position. The nation newspaper hear say dey fit done die becos of say dem inhale Carbon monoxide. Some detectives talk say dey been see some kind beverages and substance wey get alcohol inside and dem suspect say na some kind herbal things wey dem mix wey dem dey call agbo for this side naim dey see inside the motor. Them done put their body inside mortuary. The police command talk talk person Chike Oti wey be Chief Superintendent of police tell the nation say the commissioner of police Zubairu Muazu done give their forensic un it one week make dem submit weetin dey find out from this matter. He talk say dey been call police come where dis thing happen around 8:30 for morning. He talk say d body of this pipo don strong when their detective reach there. Him talk say dey been see the ID card of the driver and some other things for inside the motor . as dey done hand over everything give the forensic experts for analysis. The name wey dey d ID card na Emmanuel Chetan I. creative director, image world visuals. Oti talk say dey done call the family of the woman wey be Annie Bose Akhadelor.

One Man Dey Court Now Sake of Say Him Go Burn House Wey Him Rent...



 From Fadabubu ...

 One Iyaganku Chief Magistrate court wey dey for inside In badan wey be the oyo state capital done remand one 38 years old man wey him name na Oluwasegun Areegbe inside the Agodi prison sake of say him go burn the house wey him rent. Areegbe wey dey stay for no 1 obatola street, Aroro-Makinde , Ojor Ibadan dey face the charge of arson. Chief Magistrate Mrs. Olubisi Ogunkanmi remand Areegbe for inside agodi prison. Ogunkanmi, wey send the case file go the ministry of justice for legal advice as she come move the case go February 22 for mention. The prosecutor corporal bewaji Ojo talk say Areegbe on January 20 for around 1 in the morning been burn the house wey him been rent. Him talk say this man been lit candle for inside him apartment when dey been no get light, wey cause the fire and e been burn the house come damage the wall and roof. Ojo talk say the house wey burn na the property of the man wey bring complaint come wey him name na Mr Toba Awolusi and e reach 900,000 naira. He talk say this offence dey against section 443 of the criminal code of oyo state 2000.

One Driver Don Hit One Okada Rider For Lagos...



 From Fadabubu...

No be small thing wey happen inches 11th of February 2019, as one bus driver jam one okada rider for Toyota end of apapa-oshodi expressway. One person wey dey there tell the Guardian say the okada rider been die almost immediately. The okada rider been dey ride enter Toyota Iyana-Isolo for the service lane while this bus wey de plate number na LSR 438 XR been dey go towards oshodi. We hear say the bus driver been run immediately this accident happen as him been leave the bus so that other okada riders no go do am bad thing. Naso pipo wey dey vex come scatter the bus and dey been wan even burn the bus before the men of the police force come show face as dem no allow dem burn the bus.

Chai! Mother Arrested Because Say She Assault Her Two-Year-Old Daughter Because of Poor Knowledge Of Maths...







From Fadabubu...

Dem don report One woman wey her name na Mrs Anthony sake of say she been use rod beat her 2 years old daughter for Danjuma street inside Akure south local government for ondo state. The operatives of the Nigerian Security and Civil Defence corps wey dem attach to the child development of the ondo state ministry of women affairs and social development don arrest the woman wey her full name na Bisola Anthony, sake of say she been assault her daughter becos say she no sabi recite 123. Neighbours been go save this small girl after dey her her cry and when dey reach dey see say this small girl done get plenty wound becos of the rod wey dem use beat her. As neighbours been try to rescue this girl from her mother dey see say blood been full this girl body And na her mother been dey teach her 123 wey be numerals for English. Punch Nigeria report say the Director, Child development Ondo state ministry of Women Affairs abd social development, Oluwaniyi Ogunleye don confirm say dey done arrest the suspect as the pikin done dey recover.

Police don rescue five-year-old girl as her abductor been carry her for dedication service



From Ayim Raymond


The Police for Enugu State talk say them don rescue one five-year-old baby girl weh them been kidnapped from her parents’ house.
We hear say them do this arrest for one church for Emene, Enugu state, weh the suspect been the do thanksgiving and dedication service for church.
This woman been change the name of this pikin for the name weh her parent been give her weh be Felicia to Gift.
The Enugu Police Command talk this one for one statement weh him signed  come issued by him Public Relations Officer, SP Ebere Amaraizu, on Monday for Enugu.
Amaraizu talk say operatives for the Command don also arrested one Edith Ewulu, weh be one of the two prime suspects.
Amaraizu still talk say operatives of the Emene Police Division na them gbap the suspect on Sunday, February 10, after them talk say she steal the pikin from the mother on February 6.
The Police talk talk person talk say the suspect, Ewulu, admit say she buy the pikin for N470,000 from one Chioma weh them claim say she the run one welfare home for Aba, Abia State.
The suspect talk say she buy the pikin on February 7 from the seller from one big hospital for Umuahia, inside Abia State, and say the seller tell her say the process dey genuine and say she no know say them seal the pikin from mother for Enugu.
Amaraizu, talk say the real mama of the pikin,  weh be Mrs. Philomena Godwin, been talk say them steal her pikin on February 6 for Emene for Enugu State.
“On that day, she say she been get headache, she come go sleep for inside while her small pikin been the play for out side.
“But when she wake up, she no come see her pikin again, she look for am, but she no see, na so she come go report the matter for police.
The woman, come the happy as police quick quick go arrest the person weh steal her pikin come recover her pikin give her back. 
Amaraizu talk say them don cari the pikin give him parent while the suspect the help the police for their investigation

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land