Wednesday, March 6, 2019

"My cousin start Yahoo in the morning, EFCC arrest am in the evening"


One man don talk how EFCC arrest him cousin because say him been dey do internet fraud wey dem dey call Yahoo Yahoo.
As him go Twitter, him talk say the cousin start Yahoo Yahoo in the morning and na for evening of the same day EFCC con arrest am…
The Economic and Financial Crimes Commission don dey arrest plenty-plenty Yahoo Yahoo boys these days ooo! 

This one mean say no hiding place for internet fraudstars wey we know as yahoo yahoo boys again. But if you still dey consider to join the business, no worry EFCC don prepare dey wait for you!

Staunch Buhari Supporter, Bala Haruna Don Die, Days After Him Baff Inside Gutter Water


Chai! Na wa o! How I go take start this kind news sef? Ok, we hear say one Bala Haruna, the boy wey promise to spend ten minutes inside gutter and also drink the water if him candidate for the Presidential Election go win, we hear say the boy don die.
Na so dem rush am go the hospital after him been dey complain of serious belle pains and him con dey shit blood.
After dem carry out different kind tests ontop am, na im dem discover say, him get Gastrointestinal bleeding.
Toh the only thing wey we fit talk now na Rest In Peace Bala Haruna…

Abusive Husband Don Disfigure Him Wife Face, But she say she still love am...


One Nigerian woman wey her husband don brutalize am con disfigure her face, dey face heavy yabbings even though say her situation dey one kind after she talk say she still dey deeply in love with her abusive husband.
We hear say, the woman been get serious injuries plus one kind eye wey swell up and wey blood full inside after the attack and this thing make some hospitals been reject her as dem see her…
According to reports, when human rights activists been wan intervene on her behalf so that dem go fit make her husband pay for him action, she con talk say she still love am well-well.
Internet users and social media experts don chuck mouth enter the matter, as plenty people dey talk say, make the woman leave the marriage or look for better solution before she go die inside there…

Abuja Man Don Call Out Mechanic Wey Dey Allegedly Cruise Around Inside Clients' Motor



Oho! Mechanic! Chai! Something don vex one man for Abuja ooo, sotay him carry matter go social media…
E be like say This man wey him name na Frank Madrid, been don witness this kind thing from one mechanic hand na im make him no gree keep quiet this time around as him write say:
If you be the owner of this Honda Accord for Abuja, I sure say your motor been get gear issue and you carry am go give one auto-gear mechanic guy for durumi around Area 1… Well, as e be so, your motor don ready but him no go tell you because him dey use am flex Abuja well-well. And na wetin him dey always like to do. And I know this one because him don do am to me sef…
Hmmm… If na you, wetin you go do, if you find out say your mechanic dey do this kind thing with your motor?

"Thank You, Say You Be My SUNLIGHT" - Annie Idibia Put Full Stop For Marital Crisis Rumors, She Con Express Love For 2face

Annie Idibia wey be wife of correct and Ogbonge musician 2face Idibia don put full stop ontop the rumors wey dey ontop social media about the marital crisis between her and husband. The rumors been start after her man been go social media wetin been start like apology. Plenty people con carry the matter for head as dem been think say 2face been dey expect another baby from another woman… Some even go as far as to talk say, the pregnant woman na banker.
However, 2face con clear people mind as him talk say, he and him wife no dey get any marital issues and say the apology wey him been tweet for twitter, get nothing to do with anything wey people dey talk…
Well, him wife Annie Idibia don kukuma commot sef to say, fire no dey catch her marriage ooo, because her husband na very special person…
She write say:
Last Few days dey one kind-one kind… but Thank u well-well say you be my friend especially when I been need one the most! Thank u say, you no gree sleep for night when me I no fit sleep… Your type dey hard to find! Thank you say, you be my SUNLIGHT ! Na only you be the person wey understand me well-well! Na you be my SUPPORT SYSTEM! #Appreciationpost #MyMine #myWorld
Hia! This one na real love wantiti ooo!

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land