Sunday, December 22, 2019

D THREE COMMANDMENTS FOR DIS CHRISTMAS...

Make una try dey encourage our correct hustle ooo... E nor easy but we go reach there... D only thing wey we dey ask from una, na to just click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/4PwgπŸ‘ˆπŸ½, skip d add and God go do d rest... We no go fit thank una enough but THANK YOU!!!

D THREE COMMANDMENTS FOR DIS CHRISTMAS

1. If you no fit buy new clothes, abeg make you jejely wear the ones wey you get before. Them no dey gadge pass who get party; na Jesus birthday no be your own.

2. If you no fit obtain the kind food wey you dey dream of make you eat the one wey dey ground. Belle no get show glass so nobody go know Wetin  dey inside if your mouth no dey leak

3. If you no fit travel stay where you dey, no be for your village dem born Jesus. Abi dem tell you say na your village the party suppose hold? Any of your village person wey badly wan see you go find you come where you dey.

For all the things wey him say make we do take remember am, Christmas no join.

Take life jejely make you avoid wahala

I don yarn my own

Translator: Philip Geoffrey
PHILIP GEOFFREY






Make una try dey encourage our correct hustle ooo... E nor easy but we go reach there... D only thing wey we dey ask from una, na to just click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/4PwgπŸ‘ˆπŸ½, skip d add and God go do d rest... We no go fit thank una enough but THANK YOU!!!

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land