Wednesday, December 4, 2019

MEET FACE OF ARTS CHARITY NIGERIA 2019/2020 QUEEN EWA FAVOUR IBIANG...

If you support legitimate hustle, abeg, take 1 minute click here πŸ‘‰πŸ½ http://legeerook.com/25zW πŸ‘ˆπŸ½ to
encourage Face of Arts Charity Nigeria 2019/2020, Queen Favour as she go begin her Operation Touching Heavens Charity Project with her Management and Team of Black Giant Signatures... God Go Bless Una Well Well!

We don enter days where young girls dey use modeling as legit hustle wey dem fit use do better thing and still contribute their own small quota ontop nation building... And these days na when Beauties with brain wear crown, na im dey sweet well because dat way, people fit see dem for d good wey dem be and d betta things wey dem fit do with their legit hustle... Anyway our waka don carry us reach d domot of Queen Favour wey be another Beauty Queen wey wan do betta thing with d opportunity wey she don get... Make we meet Face of Arts Charity Nigeria, Queen Favour... 
 "My name na Ewa Favour Ibiang..." Chai! Honestly e dey sweet me to hear Beauty Queens blow pidgin... For me e dey bring out dat typical Naija homely lady to our level so dat we fit talk betta... Lol😁! Anyway, she no stop there, she talk say; "Dem born me for Ugep on 8th June 2001... My state of origin na Cross River..." Hmm see betta Cross Riverian young Beauty with Brain wey don dey already make her people proud and above all, she dey make Nigeria and Nigerians proud... Oya, on top her educational background she talk say; "I bin attend Gifted Nursery and Primary School, Rudo Excellence school, Beulah Land Montessori Private School, Government Science Secondary School and very soon I go enter University..." Wow! D way wey these Beauty Queens dem, value education, e dey trip me because e dey show say our future generation dey for safe hands... Dat wan na tori for another so no begin ask me why or how...🀷🏽 Make we continue sha... As we ask am say, na who she fit say or tell general country people wey no know her say she be, she talk say;
  "Right now i fit say, i be model because na my passion..." Okay as you con be 1st runner up, con win Face of Arts Charity Nigeria for d Face of Arts Beauty Pageant(FABP) wey dem just finish, tell us how d experience bin be go you?; "Na very good experience for me because i meet new people, i learn plenty things for our camp activities too. Although E bin stressful some days, But we still get some fun..." For dis level, na so we con ask am wetin she go like achieve as Beauty Queen, as a sharp girl with betta brain, hear wetin she yarn;

"As a beauty Queen i wan help put smile for people faces. Because the biggest achievement for life na to keep our brothers and sisters happy and to share their pain, Encourage them and tell them sey better things dey ahead of them and also help them build their Self Esteem..."
Hmm you need see how dis young Queen dey talk with confidence, you ma go confess say, Omo, dis babe know wetin she dey do and she go go far... 🀫Make I no talk too much again...🀭 As we ask Queen Favour say, na how long she feel say she go wan do dis pageant thing, she no waste time as she bin talk say;

"I go like do pageant for as long as i fit do am o... Lol!😁" Toh on top dat case, na which kind legacy you go like leave wey go make people remember you well well? She yarn say;
"I wan be dat Queen wey people go remember sey she really Impact lives and she bring out the best versions of people and help those wey really dey in need..." Wow if you also dey trip for d kind way wey dis young Queen dey think, no forget to comment under dis page ooo! Unto wether she get Mentor(s), or person or people wey she go like to be like, she tell us say; "I go wan be like my mother..." Oh Sweet Mother! If her Mama hear or see dis wan na I sure say d kind blessing wey she go pour on top her Beauty Queen daughter ehn, no be here ooo! Anyway,  as we don dey round up dis session of interview with Queen Favour, na so we sharperly ask am say wetin go be her advice to upcoming models? She yarn say;


"My advise to up coming models be say inside everything wey u dey do, try make u follow d right track and try make u be betta model with impact..." Hmm 'try be betta model with impact...' Dis na very strong and serious word of advice from dis young Cross Riverian Beauty Queen... I go only hope say, person wey get ear go dey hear dis wan well well... Las las she con also add say;
  "I go also like tell d up coming talents sey, No give up, continue to dey push, believe sey anything wey u set ur mind to do with Diligence, Hard work and Perseverance go surely work out for u''... As we don finish matta for now on top tori with Face of Arts Charity, Queen Favour, make una dey aware say she don begin her project with her Managers, d people wey crown her, Black Giant Signatures and dem dey call dis one Touching Heavens Charity Project... In case you wan support, you fit refer to d poster for betta details and you fit also comment under here. You fit also reach her for ontop her social media handles wey be;
FACEBOOK: Favour Ewa
INSTAGRAM: Favour Ewa

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land