Friday, December 6, 2019

MEET QUEEN TAYO... FACE OF ARTS ENTERTAINMENT NIGERIA 2019/2020...

Make una support dis betta legitimate hustle by Queen Tayo... Just click here πŸ‘‰πŸ½
http://legeerook.com/3ELo πŸ‘ˆπŸ½ e no go cost you anything, just click before you start and God dey bless you!


To be Beauty Queen for Nigeria no be only betta spring board wey some ladies with brains dey use affect positive change for their society, but na also something of pride because e dey turn dem to role models and give dem one kind betta sense of responsibility... Today our waka don reach d domot of Face of Arts Entertainment wey be one Beauty Queen wey wan use Arts for Entertainment touch lives differently... Oya, as usual, na she go use her own mouth take chop d onioins make we meet her;

"D name wey my mama and papa give me na Omotayo Florence..." You know say d way wey Beauty Queen dey speak pidgin😁 dey different from d way wey normal ajebo girl dey scatter her own🀣, but Omotayo Florence just dey calm dey dish am out like say she follow create pidgin... πŸ€”Chai! She just dey so natural....πŸ€— But make I maintain my lane before gist turn to gongola( no ask me wetin e me ooo.. Lol!πŸ˜‚)... As she continue, she talk say;
 "Where my mama born me na for Minna general hospital, on August 22nd 2000..." Wow Miss Omotayo na young girl with brain wey don dey ready to shoulder responsibilities wey dey come with Beauty Queen crown... Because of her name, na so we ask her say na which state for Nigeria she commot from? She talk say; "i commot from Oyo state..." On top her educational background she talk say;
  "I do my nursery, primary and Jss for New Creation Academy Bida Niger state... I con transfer go Federal Polytechnic Staff Secondary Sch, finish am for dere... D higher institution wey i go na Federal College of Education Kontagora wey dey for Niger state... And wetin i bin study for dere na Computer Science/Mathematics..." Omo! As young as dis Beauty Queen dey, she don waka far for education oo... Why she no go sabi wetin she dey do? Anyway, make we continue... As we con reach dis point, na so we kukuma ask her say, na how she take become Model? She no think twice as she tell us say; "Na because say i get deep passion for modelling, and i dey try for dance too, na so I find myself inside dis career oo!" Down to d koko wey make us notice her, as you bin recently contest con also be 2nd runner up for Face of Arts Beauty Pageant(FABP), tell us how d Experience bin be for you? She sharperly answer say;

"Yes ooo, i bin recently contest for dat Pageant... Omo! Nothing easy o, buh i manage am because, me na survivor, i must just survive nah... Lol!" Wow see survival Beauty Queen wey don dey already prepare for survival projects too wey go touch lives pass ordinary... We dey wait sha but before then, make we try waka go front small as time no be our friend for dis point... On top wetin she go like to achieve inside her career as model and Beauty Queen, she talk say; "Wetin i go like achieve na my goal... Goal of to become super star wit impact and screen diva..." Wow e no easy to be screen diva oo but if you fit think am, you go fit achieve am... Na here we con ask her say na how far she go like waka for dis her career? She con talk say; "very far oo, as fa as e lead me to wetin i want... i go do am for as long as I dey satisfied..." Correct girl! On top who be her mentor(s), she talk say;

TYRA BANKS
"Tyra banks nd Genevieve Nnaji... na dem b my main main person..."
GENEVIEVE NNAJI
Wow! No comment sha but if una know who these ladies be and how far dem don waka ontop their own career, una go undertand... Dat wan na another day tori sha... What of d kind legacy wey she go wan leave wey go make people dey remember her, she talk say; "Yes na my good deeds and impact i go like make people take am dey sabi me wella..." What of any project wey you don do or you join body or you we do now? She respond say;
 "I never do any one, and i never join body do anyone too... But me and my Management wey be Black Giant Signatures don dey plan to do some kind charity projects wey we call Touching Heaven Charity project... Dis wan na our own way of helping d less privileged and even to help betta our society for our own small way..." OK, so we go put eyes and ears for ground until when Touching Heaven Charity Project go begin so dat we sef fit show support for dis betta move wey Queen Tayo and her Management wan do... Las las, on top her advice to people wey just dey start and her last words, so dat she fit sharperly go enter her limousine waka go her next point of duty, she talk say;
  "My advice na im b say, b yourself, copy copy no dey pay at all.... and pursue ur dreams till u catch am... Las las I wan tnk u very much for all d questions.... Only to say dem plenty small...πŸ˜πŸ˜€ But thank God i see d end of am..."
I don enjoy dis session with Queen Tayo, Face of Arts Entertainment Nigeria 2019/2020 and I sure you sef don enjoy am with her too... Make una dey aware say she wan begin her project with her Managers, d people wey crown her, Black Giant Signatures and dem dey call dis one
Touching Heavens Charity Project... In case you wan support, you fit refer to d poster for betta details and you fit also comment under here. You fit also reach her for ontop her social media handles wey be;
FB: ClassicTiara
IG: ClassicTiara
As you don finish to read am, make you no forget to support dis betta legitimate hustle by Queen T... And if you forget to click, e no hard Just click here and skip d adπŸ‘‰πŸ½
http://legeerook.com/3ELo πŸ‘ˆπŸ½ e no go cost you anything, just click and God dey bless you!

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land