Sunday, March 3, 2019

Eze Kingsley Na Him Be CEO of DJ Seal Entertainment...

Dj na person, wey fit play with vibes as if say na him/her toys. Skillful and famous DJs for Nigeria dey continue to get profits with incredible speed. Breathtaking shows, unique sound, and some kind ravishing setting wey dey make the crowd explode every time with joy and pleasure. DJs wey get the DJ space for Naija like Dj Neptune, Dj Spinall, Dj Exclusive, Dj Jimmy Jatt, Dj Cuppy, and most recently Dj Seal wey be our main focus today... As we dey normally do am, make we meet Dj Seal...;
"My name na Eze Kingsley, dem born me on 12 June 1990 and I come from Enugu State, Igbo Eze South Local Government Area..." Wow! Enugu people una suppose dey very proud of una boy ooo! Anyway, the journey still fresh so make we calm down follow am jeje... Him talk say, na for; "New Nyanya Nassarawa State, Nigeria..." Na there be him base... And I dey sure say guys and babes for there no go ever get enough of am because I hear say, him dey scatter ground for any event or club wey him dey...


Toh, as per him educational background, him talk say na from; "Model primary school Nsukka," him start from. Before him proceed go,"Government Science Secondary School Toto..." Con graduate from; "Fidel Polytechnic Gboko Benue State..." Omo,  no be small cross-country you do ooo my brother! Lol! Anyway, as part of him hobbies, him talk say dem include; "Music, traveling, dancing," and na typical of DJs hobbies today...
When we ask am, wetin be him philosophy for life? Him talk say; "You treat me well...and I go definitely treat u better..." Simple! From him philosophy, you go know say Dj Seal no dey talk too much at all... That is why him no dey like; "Lies and Self pity..." This guy na action guy... Him likes also include; "Simplicity, open mind and fear of God..."
No wonder today, Eze Kingsley na; "CEO of DJSeal Entertainment..." Wey be; "Offical DJ to Black Giant Signatures and
Official DJ to Summer Set Intercontinental..." Guy, no worry, na so you go go from Official National to Official International... I hope say fans dem dey shout Amen! Lol...
We con ask am say apart from DJ, wetin him dey into again?
Him talk say; "Movies..." And na One movie him don dey part of... "Touching Heaven Episode 2... Wey na Black Giant Signatures produce am..." Correct! Stars wey him talk say, him don star with, na "Charles Awurum..." We con ask am say, how him take reach there, him talk say; "All wetin I fit talk, na say, na Papa God Do am ooo" On top him hussle, him don make some achievements wey include;
"Best DJ Award 2018/Karu Excellent and Achievements Award..." Wow! Na the beginning be dis my brother...

When we ask am wetin him still hope to achieve, him talk say; "I hope say i go fit achieve more in time to come.... And i dey pray say make God give me better life and Good health..." On top him final advice to especially the youths, him talk say; "For youths...  Make una Dey focused... Dey
Plan well....  And fear God..... Every thing  especially your dream go come to pass..."

Oga-Boss Mic Master na Him Be D Prestigious Chairman, Actors Guild of Nigeria Abuja...


Levels, dem say, pass levels... That is why e no dey hard to see people wey don work hard dey get levels pass other people... But to get high level, na one thing, but to dey humble, con dey maintain that level, and still dey touch lives, na another different thing...
This na the similar story of one gentleman, a mentor, him be acheiver wey dey very humble to the core, plus him na very articulate and accommodating person wey me I dey call Oga-Boss Mic Master and na him be the current Actors Guild of Nigeria (AGN) Abuja Chapter Chairman... Make we meet am;
"My name na Ahmed Alvin Abdulkadir  (Mic Master) and na Kogi State I come from... Currently, I dey base for Abuja..." Pidgin dey sweet for Oga-Boss mouth ooo! Him say; "my hobbies na Playing Football, Writing, Watching Movie..." I believe you die Oga as your current position na very great testimony... If you dey near this gentleman, you go know say true-true; "Integrity pass money..." Hmmm if you get ear, make you dey hear am o! Him still talk say, as per him likes and dislikes; "Sincerity, Lies..." Na dem fall under the category because Oga-Boss na straight-forward person wey no dey like mago-mago (mehn, dis one na topnotch characteristics him get ooo!)
Our handsome Oga-Boss na Oga Kpatakpata for Actors Guild of Nigeria(AGN) Abuja Chapter & him dey work with Hot Touch Productions, wey don produce some ogbonge films... But, that na matter for another day... Previously, Oga-Boss wey dey popularly known as Mic Master been hold positions as; Sec. AGN/ Vice Chairman AGN/ Media Consultant FED UP Nigeria/ Editor Redemption News Magazine/ News Department, Kogi State Broadcasting corporation..." Chai! Una see part of the reason why I dey like to call am Oga-Boss? OK presently, Mic Master na him be the Prestigious Chairman, Actors Guild of Nigeria Abuja/ GM House 2 Entertainment Abuja/ CEO Hot Touch Productions...
Omo! See levels! And if you see am koro-koro, you go dey amazed at the level of humility wey him go take relate with you... Nuff respect Chairmo! Make we go front... As per movies wey him don star inside, him say; "i don Star for MY KINGDOM/ THE CELEBRITY /IF AM PRESIDENT/ THE TWINS/ THE PRIEST/ SECRET VIOLENCE ETC" E plenty o, but no worry, very soon you go know all... On top the ones wey him do by himself nko? Him say; "The movies wey I don make na DEEP HOLE/ MISTAKES / NO WHERE TO HIDE... Apart from movies, Mr Ahmed Alvin aka Mic Master talk say, him be; "MC/ COMEDIAN/ EVENT STRATEGIST / ORGANIZER LAUGHTER OVERDOSE... Hmmm Oga-Boss na container with heavily decorated contents wey dey very attractive...
As him don waka for the movie industry tay-tay, him don rob shoulders with the high and mighty, sotay him don act inside the same movies with stars like; "Van Vicker, Jibola Dabo, Stella Damascus, Olu Jacobs, Joke Silver, Eucharia Anunobi, Clem Ohameze, Ani Idibia etc... Chai! I dey speechless as I dey so... But when we ask am, how him take reach where him dey today, him talk say; "Na Hard work, dedication, and God..." Shebi una dey hear am! On top him achievements so far, him talk say; "hmmm, dem plenty but make I mention few; D'Advertiza Most Innovative MC of the Year/ Radio Nigeria Best COMEDIAN of the Year/ UM Best Entertainer of the Year/ Living Faith Best COMEDIAN of the Year Abuja/ NF Nollywood Leadership Awards / Zeal Awards Best COMEDIAN of the Year Mexico/ Premium Leadership/Merit Awards  eye... Oga-Boss Mic Master, I no go lie, Oil dey your head well-well... On top wetin him still wan achieve for the office wey him occupy presently, him say; "I wan Impact more in People/ Capacity Building/ Make Abuja the hub of Entertainment/ Make AGN Abuja better..." Him still add say, the plans wey him get ehn, no be here oo! And I believe am die... Las-las, on top him advice to especially the youths wey dey read this right now, him say; "Never say Never & Do to others wetin u want make them do to u..."
Dis man don do plenty things since him come on board... Write us tell us some of wetin you know say him don do and him still dey do since him assume office...

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land