Wednesday, February 27, 2019

HAPPY BIRTHDAY FATIMA TOVIA KASHIM...(Photos)

Yes! The D-Day don come again when we go celebrate One Beautiful Queen wey her dimples fit make you faint, e fit make you float and e fit correct your head... Her broad smile alone, dey like say na signature wey only Papa God fit sign am...

I sure say the day wey dem born am, wey be today, many years ago, everything in heaven and on earth been stand still... I no dey talk about any other person but MISS FATIMA TOVIA KASHIM...
This Kogi State born Beauty, na confirm North-Central Babe, wey dem born on the 28th Of February many years ago, today... She fit speak, her native language wey be Bassa-Nge very fluently, even join Tiv, Yoruba and Hausa on top ...
If you ask her she go tell you say her hobbies na; smiling, reading, cooking, researching, doing business and making friends... I no wan talk too much but, she believe say "anyhow wey you want make person treat you, make you treat another person like that..." That is why me and her plenty-plenty fans, dey celebrate her today...
And before i forget, she no dey take her siblings(Sani, Linda, Tessy, and Mohammed) and her Mama play ooo... This babe na correct Action Babe, One in a Million, Heaven's Special Golden Girl, A Rare Gem with no Replica. The Most Beautiful friend wey any deserving man go fit get and a very wonderful and romantic sisi-eko...
On behalf of me, myself and I, make I wish you the best of your hearts desires plus all the happiness wey you dey always look for. Today wey dey mark another beginning for your life, na so you go rise up like the Phoenix to fulfill the plan and purpose wey Papa God get for your life...
Happy Birthday Fatima Tovia Kashim!

Abeg, make una help me wish this unparalleled Diva, and Most Distinguished Beauty Queen Happy Birthday too ooo!






ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land