Tuesday, December 17, 2019

16 Year Old Barber Don Enter Gbege Sake of Say, Him Steal Phones For Church...


We still dey beg una to take at least one minute make una click dis link πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1PlsπŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½ na una own way to encourage our correct hustle so dat we go dey encouraged to do more...





HALIMA OLANREWAJU

Police don arrest one 16 years  old barber, sake of say hin steal phone for inside church...
As we dey checkmate d mater, we con find out say dis boy and hin friend act  enter d church say dem be member... As praise and worship dey go, na so den take thief one Mr Joseph  phone wey worth N145,000. As Joseph shout say dem don thief hin phone, na so d boy friend wey den join body go  thief take run ooo... As e be now, dem don carry dis boy go court, and  him dey face two count charge of magumagu and thief...

The magistrate wey be Osunsanmi say, make dem bail am with N400,000 as d crime wey hin commit break d rule of section 287 and 411 of the state for d year 2015
She con carry d case go December 27...

We still dey beg una to take at least one minute make una click dis link πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1PlsπŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½ na una own way to encourage our correct hustle so dat we go dey encouraged to do more...

Person Go Hire Kidnappers, To Kill Him Brother 7 Year Old Pikin After Dem Pay N300k Ransom...


Abeg, make una no forget to support our correct hustle ooo click dis link πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1OvVπŸ‘ˆπŸ½ to show say you support us... God go bless you nyafu nyafu!!!

HALIMA OLANREWAJU


My people dis one wey I wan tell una, na d one wey go touch ur liver kumeme...
 Police don  arrest  one man wey hin name na Faruk Seidu  with hin friend inside Abeokuta, sake of say  dem join body go kidnapp and kill hin brother son.
As we con dey checkmate d matter, we con find out say dis Faruk wey kidnap hin brother pikin, say make hin brother give am money say he wan use am marry another wife but as hin brother no gree give am, nah hin make am kidnap d pikin oo...

Another tori wey dey inside dis matter be say, dis man don marry two wives before, but one don die and hin don divorce d second one... My people, hin matter con be  like cow wey den carry for head wey know no say, to waka na work, hin con tell hin friend make dem call hin  brother say make he bring N5million con carry hin pikin, na so hin brother begin dey beg dem say hin no get money wey reach like that oo. Hin con tell dem say, he fit raise N300,000 naira give dem, na so dey gree collect dis money... After den collect d money finish, nah in Faruk kill hin brother pikin  go throw am for river, sake of  say d pikin don see hin face and hin brother fit kno hin secret if dem allow d boy go.

Abeg, make una no forget to support our correct hustle ooo click dis link πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1OvVπŸ‘ˆπŸ½ to show say you support us... God go bless you nyafu nyafu!!!

BLACK GIANT SIGNATURES FABP QUEENS DON DEY TOUCH LIVES TOGETHER...


Dis na part of d correct hustle wey we dey promote... No forget say your support dey needed to encourage us well well... Just click here πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½
http://ducolomal.com/1πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½



ENTERTAINMENT GOOD BUT E NOR DEY ENOUGH... NA DIS WAN MAKE BLACK GIANT SIGNATURES, GET BETTA πŸ‘ΈπŸΎQUEENS πŸ‘ΈπŸΎWEY DON ALREADY START TO MAKE IMPACT JUST ONE MONTH AFTER DEM CROWN DEM...😊
SO ON THE 6TH OF DECEMBER WEY JUST PASS, NA SO FACE OF ARTS NIGERIA 2019/2020, WEY BE HRM QUEEN ANNA OCHIGBO AND HER FELLOW QUEENS,
FACE OF ARTS CHARITY 2019/2020 WEY BE HRM QUEEN EWA FAVOUR, AND FACE OF ARTS ENTERTAINMENT 2019/2020 WEY BE HRM QUEEN FLORENCE OMOTAYO
BIN CARRY OUT THEIR FIRST PROJECT WITH THE HELP OF THEIR MANAGEMENT WEY BE BLACK GIANT SIGNATURES WEY DEM TAG "PROJECT TOUCHING HEAVEN CHARITY VISIT"πŸ€— FOR ONE SCHOOL WEY D NAME NA SCIENCE BOARDING/DAY SECONDARY SCHOOL, WEY DEY FOR NASARAWA STATE...
 THESE BEAUTIES SHOW THE WORLD SAY DISTANCE NO BE BARRIER, AS DEM DEY READY TO GO AS FAR AS THE END OF THE WORLD JUST BECAUSE DEM GET PASSION TO TOUCH LIVES...😍 ONE BETTA THING WEY TRIP ME ABOUT THESE QUEENS AND THEIR MANAGEMENT BE SAY, DEM NO JUST WAKA GO THERE EMPTY HANDED... NA SO DEM FULL MOTOR PLUS BUS WEY DEM CARRY GO, WITH ENOUGH SANITARY PADS AND SOME KIND GIVE AWAYS LIKE DAT, AND E NO DEY SURPRISING SAY  OVER 250 FEMALE STUDENTS BIN BENEFIT FROM THIS ACT.😯
APART FROM THE FACE OF ARTS QUEENS WEY WAKA LIKE SISTERS GO THERE, ANOTHER BEAUTY QUEEN WEY BE πŸ‘ΈπŸΎHRM FACE OF ZAWAYA HOSPITALITIESπŸ‘ΈπŸΎ BIN ALSO JOINBODY WITH THEM TO TOUCH THESE YOUNG LIVES.πŸ€— AND NA SO THE SCHOOL AUTHORITY PLUS THE STUDENTS NO FIT HIDE THEIR JOLLY WEY DEM DISPLAY AS DEM RECIEVE THESE ITEMS....

WHEN WE THINK SAY THESE BEAUTIES DON DO SOMETHING AND TIME DON REACH TO GO REST, πŸ€”NA SO DEM TANDA AGAIN ON THE 13TH DECEMBER 2019
GO KONTAGORA FOR NIGER STATE, WHERE DEM GO FEED 500 BEGGARS FOR THE STREET OF NIGER STATE...πŸ˜³πŸ™†πŸΎ
 AND DIS TIME AROUND NA HRM QUEEN FLORENCE OMOTAYO (FACE OF ART ENTERTAINMENT 2019/2020) BIN LEAD THE OTHER QUEENS EVEN AS BLACK GIANT SIGNATURES WEY BE THEIR MANAGEMENT BIN GUIDE DEM AS USUAL TO ACHIEVE THIS KIND BETTA THING...
THIS ACT WEY THESE BEAUTY QUEENS DON PULL, SHOW SAY, THEIR MANAGEMENT WEY BE BLACK GIANT SIGNATURES DEY ON THEIR WAY FOR GREATER DAYS AS THE CALIBRE OF QUEENS WEY DEY ON BOARD NOW GET UNDYING AND UNDILUTED PASSION TO TOUCH LIVES PASS THE WAY WEY OUR ORDINARY EYE FIT SEE... WE GO ONLY DEY PRAY MAKE GOD HELP THESE SET OF QUEENS AND THEIR MANAGEMENT SO THAT THE REMAINING MONTHS FOR THIS THEIR ONE YEAR REIGN WEY JUST START GO MAKE SENSE WELL WELL...

SO FAR BLACK GIANT SIGNATURES DON ENJOY SUPPORT FROM;
KING DEROX MEDIA
DIRECTOR DADDY
JOY SAPPHIRE SWEMESHI
CHIA TIGA MICHAEL
FAITH OCHIGBO
TIV MAN PROPER
SHONELS STUDIOS
AYAGWE BENECDICTA
AND SOME INDIVIDUALS PLUS ORGANIZATION WEY NO WANT MAKE WE MENTION THEIR NAMES BUT BLACK GIANT SIGNATURES DEY USE DIS OPPORTUNITY TO SAY ONE KIND OGBONGE THANK YOU TO ALL OF UNA WEY DON DEY THERE FOR THEM FROM THE BEGINNING TILL NOW...

MAKE UNA ALSO DEY AWARE SAY THE JOURNEY JUST DEY START AND AS ALL OF US KNOW SAY, "ONE TREE NO GO EVER FIT MAKE FOREST" NA SO BLACK GIANT SIGNATURES PLUS INCLUDING THE QUEENS WEY DEY REIGN NOW, GO NEED UNA SUPPORT WELL WELL... SO, FOR SPONSORSHIP/PARTNERSHIP/PARTICIPATION, UNA FIT CALL 08060959221, 07036353673

AND PLENTY OF THE TIMES DEM GO NEED SPONSORS/PARTNERS... SO IF YOU GET THE CAPACITY TO SPONSOR/PARTNER WITH THEM, YOU FIT ALSO
CALL/TEXT/CHAT 07036353673 MAKE UNA YARN...

AGAIN FOR SPONSORSHIP/ PARTNERSHIP/SUPPORT/INVITATION/BRAND AMBASSADORIAL CONSIDERATION OR BOOKING, YOU FIT ALSO CALL 07036353673, 08060959221...

BLACK GIANT SIGNATURES (CREATIVITY IN MOTION... DECENCY IN LIFESTYLE)
Dis na part of d correct hustle wey we dey promote... No forget say your support dey needed to encourage us well well... Just click here πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½πŸ‘‰πŸ½
http://ducolomal.com/1HeVπŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½
God go bless you well well

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land