Tuesday, October 15, 2019

Between M.I vs Vector, Who Win The Diss Battle?

I throway salute o Country people!! Dis na the first time inside plenty years, wey the Nigeria music industry dey feel rap... Like, almost everybody, including "me" dey pay attention to rap this year pass before, and dis one na because of gbege wey dey happen between Vector and M.I.  Rap lovers kukuma know say Both Vector and M.I na two kings for Nigeria rap game and dis their recent "diss fight" Don make everybody buy chair siddon face television sake of conscious rap.


 How This Diss Take Start?
Una already know say the "diss battle" bin start from Martel Cypher wey bin get M.I and im team before we con see The Purge Cypher by Vector and im team reach down go “Tetracycling“. Meanwhile, e take M.I two weeks to reply Vector after him diss am for “The Purge” cypher. The Chocolate City boss bin reply with “The Viper“, one kind diss track wey bin target Vector.

M.I “The Viper” diss track bin get betta contents as him utilize the opportunity to throw some kind gbege shots ontop Vector wella...  All of us con dey think say M.I don succeed to make Vector close mouth because of some of the hard knocks wey him give am inside that diss track but Nah!
Na so Vector bounce back like few days later with another diss track wey him title “Judas The Rat” where him bin give M.I some kind deep gbege backlash as him respond to some kind claims inside “The Viper” diss track. The song na correct jam and na perfect response to M.I diss track.

Now Between Vector and M.I, e be like say the diss battle line don finish for now till further notice, but for our minds, we still need to pick one as the winner.
 The question now be say πŸ‘‡ Between M.I vs Vector, Who Win The Diss Battle? 
Pick one, give your reason and make sure say, you dey very sincere 
 Drop your comments!

#FOGMMON2019: National Congress With Betta Kingdom Sound!!!

Wetin be FOGMMON?

FOGMMON na acronym for Fellowship of Gospel Music Ministers of Nigeria.

Make you notice say dem dey use the Word "Fellowship" and no be "Association".
Meaning say dis wan na actually fellowship for Music Ministers and e no just be one kind gathering of gifted Artists;
and for there, nothing like wetin oyibo dey call discrimination, segregation, ethnic games of domination and class distinction(na here you go consult dictionary for better explanation oo... Lol!);
Dis na place where every Music Minister, both those wey be upcoming(just dey start) and even established(those wey Don tay), dem dey treat each other as one, for one kind brotherhood style, love and friendship...
Omo! If you love to worship God with songs na better place to dey be dis o!

Na for the 18th of August 2014, na im dem born FOGMMON and dem Don Dey reach 5years now with testimonies wey pass how ordinary things dey happen...

As  E Be So, Dem Don Dey Prepare For One of Their Ogbonge, Spirit-Filled And Life-Changing Congress and Many Voices Around the WORLD 🌎 Dey Talk About Am!
Many Tribes Sef Dey Come...
To do wetin?
To produce one kind better K I N G D O M S O U N D !!!

Make You Save the Date ooo because, Na 26th and 27th of October 2019

Time: 10AM & 3PM

Venue: NA LIVING BROOK PARK, JESSE JACKSON STREET OFF JIMMY CARTER STREET OPPOSITE BON HOTEL ASOKORO ABUJA, NIGERIA

#FOGMMON #FOGMMON2019 #Music #FNC2019 #Entertainment #Spirituality #Nigeria  #KingdomSound
#FNC2019
#Music #Entertainment #Spirituality
 #October26th

Oya! No waste time ooo, Spread the good news give your friends and make you no "tryyy" come only you o, carry people come too!

Share Dis Message with friends on top Social Media sharp sharp!

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land