Wednesday, January 8, 2020

TENIOLA DALTONS: "I be student ooo but I also be OAP & Actor..."





Na new year we dey so ooo... Make una try help encourage us so that our hustle go pay... Just click here πŸ‘‰πŸ½ http://pladollmo.com/1oAAπŸ‘ˆπŸ½ shikena! You don do your part!!!



D era wey we dey for Naija now, na era wey everybody no matter how old or young, need encouragement so dat dem go still hold their head high on top d legitimate hussle wey dem dey do... Na people wey dey try on top their legitimate hussle na dem we dey always like to waka go meet so dat dem go fit share their stories with us plus their experiences wey go make us appreciate dem well well... Anyway introduction don do, make we meet our guest for today, wey be one young lady wey dey try on top her legitimate hussle...;
  "My name na Adeniran Deborah... Dem born me for Plateau State... But my state of origin name na Oyo state..." As per her educational background, she yarn say; "I do my primary school for first baptist school jos. I con do my secondary school for Ambassador Academy Nassarawa. Now, I dey study Theatre Arts for higher institution..." Wow dis young babe na Thespian wey wan hussle to make name for herself... E dey always good to see young people especially young ladies wey get mind say dem wan hussle so dat society fit recognize say dem dey contribute their own quota ontop nation building... Anyway, as per who she be, she no waste time to let us know say;
  "I be student ooo but I also be OAP & Actor..." For dis age, dis young lady don understand say e dey good to diversify for career pursuit in case of incasity(anyhow wey you understand am, na so e be... Lol!) Where we been notice her na for d Face of Arts Beauty Pageant wey bin hold on 17th November 2019 and she bin do well for her outings even though say she no win, na dat wan con make us ask her how d experience be? She yarn say;

"Yes I dey among the contestants of FABP 2019 and interestingly, na my first time even though say I bin feel neglected..." Ehyaaa e dey happen like dat most times... Anyway sha, when we ask her say wetin she go like to achieve with dis career path wey she dey pursue, she yarn say; "I go like make I become celebrity wey dey do people better..." OK if e be like dis, na how far you wan con go for dis career path? She talk say;
  "I wan go very far for pageant so that I go fit dey do better things for people..." D only thing wey dey dis young babe mind na how she go take dey do betta things for people... We go only pray make God help am achieve so dat she go do d betta things wey she dey always talk about... Na here we con ask her say, she get any mentor, if yes na who him or her be? She no think twice as she talk say;
  "my mentor na Okpe Lawrence and na better person him b..." Toh I hope say Okpe Lawrence dey hear dis wan ooo make him head no swell scatter... Lol! Unto how long she go like pursue dis career, she talk say; "I wan do am for 2 years..." OK so if na d case be dat, which kind legacy you go like leave wey people go take dey remember you? She still continue say;
  "I go like make I leave good character wey people go fit follow..." Make sense sha... As time don dey give us signal to take style match break for dis session, we sharperly ask her wether she don do any project or she join body with others or person to do any project? She talk say; "I never do any project..." All na small small sha... We believe say with time, we go still come here again to celebrate her on top d many many projects wey she don do and wey she dey plan to do as her own contribution to betta we country... Las las she con dey advice newcomers and upcomers say; "I go like make I advice upcoming OAPs make dem focus for wetin dem dey do..." No forget to comment under here to encourage Teniola Daltons and these na her social media handles;
Facebook: Debbi Teniola Daltons
Intagram: Teniola Daltons

Na new year we dey so ooo... Make una try help encourage us so that our hustle go pay... Just click here πŸ‘‰πŸ½ http://pladollmo.com/1oAAπŸ‘ˆπŸ½ shikena! You don do your part!!!

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land