Saturday, October 12, 2019

"Every body wey be film maker, wey Sabi im work na my mentor"... Chia Tiga Micheal

Sometimes i dey dey Tempted to call dis my brother "Mai gemu"... But dat na based on how far we don come o, no be based on logistics... Lol! And you no fit spend 5 minutes with dis guy wey your jaw no go ache you from plenty laff laff... But anyhow wey you see am dis na another tori session with one guy wey im charisma dey self announcing, im presence na sure-banka because im na dedicated and disciplined craftsman wey dey deliver when you want, plus na very admirable Thespian wey dey gradually step up him game for Nollywood and the career wey him don choose... Make we take style meet Chia Tiga as im carry us through dis journey of no dulling...
 "My Name na Chia Tiga Micheal. And na for Kontagora Niger state na im dem born me..." No wonder im keep beards wey don dey gradually become one kind identity. Una see why sometimes I dey tempted to call am "Mai gemu" Abi? Lol! Make we continue sha... On top schools wey him don attend, him talk say; "Faith nursery and Primary School, and Baptist comprehensive school. All for Kontagora Niger state. Before him con go Benue State University makurdi for him Higher education... Wow! From Niger State to Benue State where him no wan tell us say him study Theatre Arts... Issorite! Make we continue... On top who him be now, Chia Tiga no waste time to tell us say him na;
"Actor/Film maker" wey dey "hope to become the best film maker of my generation" No be small thing ooo! When we ask our Nollywood Thespian how far him don go, him talk say; "I never too go far for my career but I don climb the ladder small small" Na correct talk be dis o as all of us kukuma know say na slow and steady dey win race... Tiga no stop there as we ask am say who be him mentors, him yarn say; 
"Every body wey be film maker, wey Sabi him work na my mentor" Ontop how long him dey hope to pursue dis career, the Thespian wey know wetin  oyibo dey call resolute, con talk say; "I wan be actor and film maker till I die but later Sha I go join other business o!"
Tiga with Zack Orji & other Actors on set of Pillars of Africa
What of Legacy wey you wan make people use remember you? Tiga yarn say; "I go make films wey this world go dey remember till thy kingdom come..."
Hmmmmm as things dey go so, e no look like say dis Thespian dey ready to slow down or dream small dream o, na big dreams him get... Toh, when we con ask am wether project dey wey him go like make we know about, him talk say;
 "Right now I dey Edit Pillars of Africa. Na big film wey feature Hollywood actor Hakeem Kae Kazim and Nollywood veterans like Zack Orji, Segun Arinze, Shola Sobowale, Chidi Mokeme... I even act for the film too." 

Hakeem Kae Kazim

Zack Orji

Chick Mokeme

Segun Arinze

Sola Sobowale
Chai! So you no even wan tell us say you be Editor! Omo! See profile... If him don reach dis level den we fit expect am to give better advise and dis na wetin him yarn;
"The only advice wey I get for upcoming talents na say make them dey committed to their work because Na hard work dey pay..."
 Instagram @tigachia
FB: @chia tiga micheal

Happy Baiday To Amb.(Comr)Ebere Adaku NwachinemereπŸ˜†

Dis wan sweet my belle well-well as we don finally get opportunity to meet the one and only Empress Chizy herself... Woman wey no just be Lady, but one wey i personally fit describe as "Iron Woman"... Lol! D better thing now be say today no be ordinary day for her ooo, na today be d day wen Heaven & Earth been stand still as her Mama born am enter Planet Earth... Oya! Introduction don do, make we meet the Empress herself....;
"My name na Amb. (Comr) Ebere Adaku Nwachinemere aka Empress chizy." Omo! From the intro alone, I no need to tell you say shebi you dey feel d "ironness of the lionness"... Lol! Make we continue jare!
"Dem born me for Abia State but i be Imo bae on the 12th of October..."(and na today o!) E no go too tey we go wish her Happy Birthday but make we enjoy the tori from dis confam Igbo Queen mouth...

"I been attend Pope John Paul School for my nursery and primary education, Divine Grace Academy for my secondary education Dorben Polythecnic for my tertiary education but presently i dey national open university." Wow! No wonder she get the titles "Amb/Comr/Empress" and I sure say more still dey come... As she take continue ontop wetin she dey do, she talk say; 
"I be Filmmaker/Nollywood Actress and also i be Entrepreneur." 
Chai! You no need native doctor to tell you say dis babe na complete Packaged Nigerian Woman... Toh, make we continue as her profile don dey make me almost wan piss for my trouser... Lol! On top wetin she hope to become for dis her Career, she yarn say;
"I hope to become one of the best producer/filmmaker worldwide."  Hmm mm the weight of this dream no be here oo!
She no stop there o! When we ask am, how far she don waka for dis journey, as an Empress wey no dey waste time to talk her mind, she yarn say; "I don go far small but i still wan go more farer..." 
Na dis wan con make our curiosity tall small as we con ask am which stars she don act films with, & which projects she don do, she no form as she call;
Zack Orji
Larry Koldsweat


Amaechi Muonagor

Tony Goodman

Victor Decker
"Zack orji, Larry Koldsweat, Amaechi Munago, Tony Goodman, Victor Decker and lots more. And i don do projects like The Untold story, Zarah, the forbidden kingdom,    Nneka the sorrowful girl... Infact i no fit remember all o!
Correct! Oya, we go soon finish dis session so dat we fit go celebrate the only Empress without Cabon Copy but make we go front small. We con take style ask her who be her Mentor and she talk say;
"Na my Pastor be my mentor as the guy teaching too make sense." Whoever dis man be, we dey tell am weldone boss!
On top how long she wan dey do dis career, she yarn say;
"I wan do am all my life or as  my strength go fit carry me."

"Legacy wey i wan leave na the fearless spirit of not loosing out anywhere, anytime despite the persons wey dey race."
Hmm the tori with Empress Chizzy no be one wey person go wan leave sharp-sharp but like every other wan, we must to finish... Las las, ontop wether any project dey wey we suppose know about, she yarn say; "Well for the moment, none but i still dey work on Something. No worry, na una go first know" πŸ˜†
On top her final words, she talk say;
"Me too na upcoming shaa but i go advice make we jes take am easy say na slow and steady deh win the race."

Na here we go take style match brake with Empress Chizy but before we caput as oyibo dey talk am, make we also use dis opportunity wish our Sis the kind betta-betta orishirishi wey baidays dey come with, plus plenty money inside her account. Happy Birthday Empress Chizy!
Country people, make we celebrate person wey dey celebrate and as today na Empress Chizy day, make all of us join hand celebrate am especially for her social media handles;
Fb: Adaku Nwachinemere Ebere
IG: @officialempresschizy
Twitter: ebere chizy

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land