Friday, November 15, 2019

EVELYN OBASI aka ENO - "Presently I be OAP(On Air Personality)For Human Rights Radio 101.1fm."

If you dey listen to Human Rights Radio 101.1Fm everyday(monday to friday) from 8pm e mean say you don already know our guest for today... But before i introduce her make i let una know say her pidgin na original pidgin ooo... Who say Pidgin OAP's no sabi? Den you dey ontop long thing ooo but levels dey sha for that category because e nor easy... So we gats celebrate our pidgin OAP's for the kind work wey dem dey do for Radio and TV... Oya i don talk too much, Make we meet our guest for today
"My name na Evelyn Obasi a.k.a Eno. My mama born me for OJo Lagos State for June 16..πŸ€©πŸ˜†πŸ˜†but na 199 something sha. I go Enugu State University Of Science and Technology, Enugu State. I be Graduate of Psychology." See as the babe just dey flow inside pidgin like say na she invent d language... Lol!🀣🀣🀣 Anyway in case person dey read reach here and you never know who she be, hear her as she talk say; "Presently I be OAP(On Air Personality)For the station wey dey redefine broadcasting  Human Rights Radio 101.1fm." 😍Omo!πŸ€— See levels na... As Eno like talk well well, even though say e no dey show for her  body na so she begin yarn about how she become OAP
"Eeh..E dey important for anybody wey dey read or hear to know say, before person go reach one particular noticeable stage, e go don dey run some kind package underground. No be Human Rights Be the first Radio Station I don work with. I don work with SolidFm(Understudy co anchor) and Radio Nigeria wey dey Enugu(IT), When I been dey work with them, I work like say dem dey pay me sotay even when I suppose collect money I leave am... I collect knowledge and I dey appreciate God wey carry me meet some kind people dat time for the work before I con come Abuja... Truthfully I no know how I take get this Job cos I no struggle get am. Na just 1 day na im the Ordinary President see me give me opportunity. When CEO asked why I wan join or become OAP, I tell am say na because I love to talk to impact..." No wonder when we ask her say toh, na wetin you wan achieve with wetin you dey do presently, she no think twice to talk say; 
"I wan change lives... I wan make people betta through words and talk-talk and that goal never change and by Grace of God, e dey work like that." Unto how long she don waka for dis career path wey she dey follow, she talk say;
"If I wan calculate the other years wey I dey underground dey learn things with now, I go fit say 3 years and I still dey carry dey go..." Hmm when Eno start to talk e go be like say she dey under anointing and if you siddon dey listen to am, you go sabi say true true dis babe dey her correct ministryπŸ‘πŸ½.. Lol!πŸ˜‰
If for say dem dey give degree for talk-talk, I sure say Eno go don collect reach 3, if you take style consider how long she don spend for dis industry... Make we move ahead o! When we ask her say na who she go like be like for her career, she yarn say; 
The Ordinary President
"For who I wan be like for the career..I go say I wan be who God say I go be and who me I say I wan be. And if at all I wan be like any person wey no be me I go say the Ordinary President because e be like say na the same goal we dey pursue so..." Omo! If woman get role model as The Ordinary President, e mean say Nigeria don betta na😁(no ask me how ooo!πŸ™„) OK the moving train never catch break so make we dey vano dey go... We con use style ask her How long she feel say she go wan pursue dis career path she don choose so? She yarn with ease say
"I go dey carry dey go as long as life dey. I trust God for that one." If you dey follow her talk you for don realize say "God" dey for all of her answer from beginning... E be like say she don dey get small-small pulpit ministry calling ooo(no be me talk am oo🀫🀭) As betta simple babe wey she be, hear wetin she talk when we ask am say na wetin go like leave as primary advice wey go make people remember you anytime dem think about you? She yarn from her church mind say;
  "Live life Simple - Take life jeje. Do your best so you go fit be your best. No look down on yourself. If every other person tell you say you no go make am, tell yourself say, you go make am and e go happen for you like that. Always go meet God and dey grateful for the little wey you get..." Chai! Eno sabi advice for Africa, no be small thing o! Anyway any project dey wey you don do or wey you dey do and you go like make we know?;
"I don join things o but then personal projects go come by Gods Grace wey I go fit take reach out to people..." Correct! I don already dey see traces of the Ordinary President for her talk sef... Dis babe na high flier o! Make I no talk too much sha... Wetin be your advice to new talents and upcoming OAPs?; "Upcoming OAps ..for media for a start...money no suppose be the main aim. Learn learn and learn. Wetin u dey do, if you dey do am well, e go speak for you. That time money go start to dey pursue you. You need patience and humility to work as OAp or any other job sef. Work hard and you no go regret am." 
As oyibo dey take talk am dis wan na 'words on marble'... Make person wey get ear, hear am well well! Las las, as she wan sign out go enter her 🚘limousine🚘 wey carry her come studio, she con talk say; "I go really wan thank dis your great platform and opportunity Thank you say Una remember me. Make God increase Una in every every. Anyhow e be I go chuck hand so e go work. Thank you my Ali Ina..." For dis corner as we kuma dey sign out we no go fail to say Thank You Eno and Amen to all the prayer wey you pray for us...
Make una forget  in case you wan follow Evelyn Obasi aka Eno, her social media handles na;
FB: Eve Lyn
IG: Eno damsel
IG: Eno - damsel

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land