Tuesday, February 5, 2019

Backyard Wahala; Landlady dey warn slay queen about her "backyard ", say dem dey distract her husband




From ALI INA...

One Nigerian landlady don warn one of her well-package tenant say make she no dey wear  trousers within the compound, say her backside dey distract and confuse her husband.
The lady, wey we discover say her name na ID James, share the warning ontop her Facebook timeline.
ID James talk say the landlady almost dey cry as she dey give am the warning.
She con talk say she don kukuma stop to dey wear trousers around the house o, so that she go fit avoid to break another person marriage.
See as she take talk am;
“My landlady almost cry yesterday when she talk say,  make I stop to dey wear trousers anytime wey I dey inside her compound, She say my backyard dey always distract and confuse her husband. Toh, As a respectful girl, make I just jejely go start to wear my skirts ooo before person Papa go die o…” Hehehehehehe Chai!  From frypan to fire... No be only skirt,  na village wrapper...

Ehyaaa! One Nine-year-old girl don drown for Jigawa State...



From ALI INA...

One nine-year-old girl wey dem identify as Hassana Aliyu wey dey stay for Kasarau Yamma quarters inside Dutse, for Jigawa State, don lost her life after she fall inside well.
The Director, Jigawa State Fire Directorate, Alhaji Ahmed Danyaro, tell the News Agency of Nigeria NAN for Dutse on Friday say, the incident happen around 1:30pm on Thursday.
Danyaro talk say, “Nobody fit talk how the girl been falll inside the well, as we just receive one call like that say she been don fall inside well for her Parent's house.
“As we receive the information, na so we sharperly send our rescue team, wey con bring her commot as she dey unconscious and na later when we carry her go hospital,  dem talk say she don die.”
Him add say, dem don carry the girl dead body, hand over to her parents so that dem go fit bury am...
The director still con advise parents, wey get well for their house, say make dem try to raise the height of the well and make dem make sure say dem provide better covers for them so that e go fit protect their children and wards.
According to am, the agency go continue to sensitise the public ontop how dem go fit to use well for their house...

Islamic cleric, three others wey dem arrest with human skull for Ogun State


From DEBORAH ODOEKWU ...


Wetin person no go just see for this world ehn
Hmmm e don happen for Ogun state where we hear say dem don arrest one Alfa together with three other people sake of say dem catch dem with human being skull.
Hian! I no know wetin go concern alfa with human being skull. Anyways, some Police people wey dey for Agbara Division don carry two of these suspects; Teslim Ayeniromo wey be 45 years old and Sunday Kolade wey be 35 years old, go Kofedoti for Ogun State.
The chuen chuen wey we get for this matter be say as dem dey do one searching searching na im dem find this human being skull for inside the bag wey one of them been dey hold, na so dem come quick carry them go police station.
As the Divisional police Officer, CSP Adegbite Omotayo dey ask dem serious question for the station, na im dem come talk say na one Michael osanyinbi, na him give dem the kin skull, say dem dey carry am go one Alfa before police dem come gbab dem.
The Police talk talk person for ogun state police command, DSP Abimbola Oyeyemi wey confirm this arrest come talk say these suspects dem bn carry dem go the house of the man wey give dem the skull. This man kuma come carry the police go the Alfa house. DSP Abimbola come still talk say the Alfa don confess say true true im bn request for the skull wey Michael Osanyinbi talk say he go bring for am for #25,000 plus #1,000 wey im go give the bike man wey go bring am come im place.
Las las the alfa come talk say him need the skull for one ritual wey im no gree talk wetin e be. As e be so the commissioner of Police for the state, CR Ahmed Iliyasu don give order make dem transfer the matter go the Special Anti-Robbery Squad so that dem go fit chuk eye well well for the matter.

Chai! Mother in-law die after her daughter in-law pour hot water wey dem mix pepper ontop her



From DEBORAH ODOEKWU... 

Heeyyy! Some people no dey fear face again o! but this one bad oo kai!
Na so one woman wey go dey dah kin 40 something or fifty something don die as her daughter-in-law use hot water wey mix with pepper come pour on top her body. This woman, Mrs Rebecca oladosu bn die after her daughter-in-law, Taye lamidi bn plan with Basirat lamidi and one other person to pour am hot water wey get pepper inside.
According to wetin police people dem bn talk basirat and Taye attack this woman for 30th October, 2018 for her house wey dey Okeyelu village, Ilie for Olorunda Local Government wey dey Osun state. From the chuen chuen wey we hear, dem arrest these two women immediately this tin bn happen and since then, dem don dey enter commot, enter commot, like dat like dat for one magistrate court wey dey for this osun state so.

As dem resume the case for this Friday wey just pass wey be 1st February, 2019, the Police prosecutor wey be Inspector Muslim Jafani come talk for court say Mrs odunsanya wey don dey hospital since this tin bn happen, don die. He come tell the court say make dem commot the judgement wey dem bn give these women before, say make dem change am to two new crime wey be felony and murder.
The court come change am to two count charge of felony and murder wey dey against section 516 for the criminal code, vol 34, laws for Osun state of Nigeria, 2003.
Na wa o… I know say some mother-in-law dem no too get good character but why you go take am far like dat na?
Sha police and court dem don handle the matter...

Gunmen Don kill Retired Prisons Officer...

Retired DCG, Dr Adewale Oloyede.

From Fadabubu...

Some rugged guys wey carry gun done go kill one retired Deputy Controller general of the Nigeria Prison Service  Dr. Adewale Oloyede.
Dey been kill am on Friday him and him orderly wey him name na Dauda Michael near osara town for inside Kogi state.
Oloyede been dey travel go lagos for him car when him and him ordely been dey under attack around 3 o’clock
Oloyede na doctor and before him retire for 2007 na him be d oga of the Directorate of health and Social welfare of the Nigeria Prison Service.

"My husband Dey Owe Me N40,000", Na so wife wey want divorce talk...



From Fadabubu... 

Maryam Abubakar wey be the wife of one Shamsu Lawal done carry her husband go one sharia court for inside magajin gari area for inside kaduna state and she want make the court scatter her marriage.
She talk say the reason wey she want make court scatter her marriage na because her husband no dey take cae of her.
Maryam tell court say her husband been abandone her for six months with no food ,medical attention and shelter as she talk say her husband dey owe her 40 thousand naira.
She come beg the court say make them scatter the marriage and make dem compulsory her husband to pay her the 40 thousand naira wey him dey owe her.
Shamsu Lawal, come talk say no oh him no do like that ,as him talk say him no leave him wife even for one month. As him confess say na true say him dey with her 40 thousand naira wey she talk say make him keep for her.
The Judge wey him name na Musa Sa’ad-Goma tell Shamsu Lawal make him give him wife her 40 thousand naira back.
As him tell the two of them make them come with their parents on febuary 13.

Wife Of Senior AirForce Officer Don Attack Soldier With Machete For Port-Harcourt....




From Ayim Raymond

The Nigerian Air force base for Port-Harcourt, Rivers state, been dey very confus as Mrs Irobuisi, weh be the wife of Air Commodore C.C. Irobuisi weh be the present deputy director of safety, Defence headquarters Abuja, been attemp to kill one of the airman for Air force secondary school inside the city.
According to reports, this airman been flogged the woman pikin sake of say she do wrong thing, na him one female civilian teacher come give the girl phone to report the matter give her mother weh, immediately drive come the school with knife.
As the the try talk the mater, na so Mrs Irobuisi come remove the knife as she try to kill the airman, but as God go help, the knife no meet am for wey him go die quick quick like that, him com survive the atteck.
As I the talk to you now, him the respond to treatment for NAF reference hospital for Port-Harcourt.
We also hear say Mrs Irobuis don the assaulted airmen and officers plenty plenty times and for different locations. In fat them been do suspend her from Nigerian Air force Officers Wife Association few years back sake of say she been slap and bit another officer's wife.
From the way me I see the matter, iee belike the woman na gbege person ooooo…… anyways we never no as the matter take end sha….. 

Dem Don Gbab Fake Naval Officer For Cross River State



From Ayim Raymond

Them don gbap One man weh them identify as James Solomon, weh  parade himself as one naval officer weh them attached to the office of the Chief of Naval Staff for Calabar, weh be the Cross River State Capital. 
The commander, Nigerian Navy Ship Victory, Rear Admiral Julius Nwagu, confirm the arrest as him talk say the 25-year-old man the come from Abi Local Government Area for the state, and him agree say him commit the crime and them go soon hand am over to the Police for prosecution.
Some of the items weh them recover from am na, Nigerian Navy camouflage weh him been the wear as the arrest am, one fake Nigerian Navy Identity Card, copies of recruitment forms and applicants credentials for the Navy, ATM cards, and a computer.

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land