Friday, December 20, 2019

Bandits abduct three from Katsina community school

Abeg no forget to click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/39PZπŸ‘ˆπŸ½ to support us for our correct hustle... God go bless you well well!

From
GENES AMINU
 Some Suspected bandits don  kidnap three people from the staff quarters of the Government Science Secondary School, Dutsin-ma, Katsina State.
we gather say these kidnappers, kidnap the wife of one of the WORKER  for the school, her sister and her daughter. 

The talk talk person of the state Police Command wey be SP Isah Gambo, talk say this thing wey happen na true and say these kidnappers na from the stretch of rugu forest around the town. But say dem still dey checkmate the matter make den see say den don rescue dem...


Abeg no forget to click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/39PZπŸ‘ˆπŸ½ to support us for our correct hustle... God go bless you well well!

RCCG Pastor For Yola, Dem Don Kidnap Am...


Make una no forget say we need your support ooo! How? Just click here πŸ‘‰πŸ½ http://ducolomal.com/37AgπŸ‘ˆπŸ½, skip d add and God go bless you because you dey support our correct hustle!!!


From
GENES AMINU

 NAWAWO EVEN MEN OF GOD  SOME PEOPLE NO GET FEAR  OF GOD AT ALL    
Some unknown gunmen  don kidnap one Pastor Kayode Shogbesan of Redeemed Christian Church of God (RCCG) Yola, Adamawa State . 

The pastor wey den kidnap na Professor of Fishery FOR Modibbo Adama University of Technology Yola. 

The talk talk person of THE  Adamawa state police command wey be, DSP Sulaiman Nguroje, say den kidnap dis man  for the university as hin close from office dey go house around 8-9 for night . 

The talk talk person of the police command say, investigation dey go on for the matter and the kidnappers never call or demand for any ransom. 

Hin con beg say make we dey security conscious and make we report any kurukere movement wey dey go on for our area .

Make una no forget say we need your support ooo! How? Just click here πŸ‘‰πŸ½ http://ducolomal.com/37AgπŸ‘ˆπŸ½, skip d add and God go bless you because you dey support our correct hustle!!!
               

Them don carry one student go court sake of say him thief 16 ATM cards



Support our correct hustle... Just click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/303cπŸ‘ˆπŸ½ and make you dey patient... Skip d add...  
God go bless you!!!

From
PATIENCE SARUUN

Hmm this one no sweet to hear oo!

Dem don carry one 22-year old student of the Department of Guidance and Counseling/Social Studies, for  Benue State University (BSU), go one Makurdi Magistrate Court, sake of say  him thief 16 ATM cards. Hmm!😲

Them charge am with criminal conspiracy and say him dey in  possession of 16 ATM cards wey them suspect say nah steal him steal them. And say this  offence break the rule of Sections 97 and 318 of the Penal Code Laws of Benue, 2004.

The person wey carry the matter go court talk say this boy nah 300 level student of BSU OOO and say them arrest am with 16 ATM cards with different names inside examination hall o hmm!

 And this boy con confess say true true nah wetin him dey do, and say him dey send all those ATM cards to one Ayo James wey dey stay for Kaduna, and say this man they use them commit plenty plenty crimes ooo!

The person wey carry the matter still tell court say dem stil dey carry investigation for the matter.

As e b so the Magistrate, Mr Isaac Chaha don grant am bail of N200,000 wit one surety wey get d same amount of money and him don carry the matter go Jan. 8, 2020.
Support our correct hustle... Just click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/303cπŸ‘ˆπŸ½ and make you dey patient... Skip d add...  
God go bless you!!!

Police don save one seven-year-old pikin from kidnappers inside Benue


No forget to support our correct hustle... Dey patient as you click hereπŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/2z2cπŸ‘ˆπŸ½ All of us need encouragement!


From
PATIENCE SARUUN
Chai! Chai!  Why b say people no go use their lives take do better thing? Some people, d mind wey dem get strong pass stone ooo!😩 The Police for inside Benue State don save one  seven-year-old boy,  from the hands of kidnappers ooo.🀷🏽

As we con the checkmate dis matter .. we con find out say nah for him papa house dem take kidnap am oo..
Nah so this kidnappers con dey ask for N30m before dem go allow the boy go, but God con spoil their show... Nah so dem take arrest them!
As e b so d command Public Relations Officer, DSP Catherine Anene,  don confirm dis matter say e happen true true.
As some people no wan take their life do better thing, nah so God go continue dey spoil their market!!!😏


No forget to support our correct hustle... Dey patient as you click hereπŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/2z2cπŸ‘ˆπŸ½ All of us need encouragement!

Police Don Catch Woman Wey Dey Do Ponzi Scheme Wuru-wuru

Support our correct hustle... Dey patient as you click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/2yt9πŸ‘ˆπŸ½ just skip d add and dey patient.... God go bless you well !

SIMON MERCY

For this Christmas so, no be small wuruwuru matter we go dey hear o!

The Economic and Financial Crimes Commission wey be (EFCC) don arraign one
Maryam Shinga before the federal high court for kano over Ponzi scheme wuru
wuru

This woman don chop forty five million, four hundred and sixty thousand naira wey
belong to the people wey she deceive invest for one Ponzi scheme wey she call am
Golden Premier.

How the woman take do am be say she deceive people say make dem invest with
Golden premier. Say if dem invest N500,000 dem go get one million five hundred
thousand in return, na so the woman cum dey do as she talk o for about six months,
before she begin dey do some kyn wuruwuru dey join am soteh she carry people money run o! Na so dem begin dey look for this woman o, las las na for inside Abuja dem catch her, na so dem carry her go back to the lkano zonal ofice. But the woman say she no dey guilty of these accusation wey dem read give her o.

We hear say the judge don push the matter go January 23 2020 for trial. Abeg o una
wey dey invest make una dey dey very careful because dem no dey write scam for
Face o!


Support our correct hustle... Dey patient as you click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/2yt9πŸ‘ˆπŸ½ just skip d add and dey patient.... God go bless you well !

SHOCKER: Man chop with friend… con take cutlass ‘knack am to death’ hours later...


Support our correct hustle... Dey patient as you click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/2xsRπŸ‘ˆπŸ½skip d add and God go bless you!


From
Olanrewaju Halima
My people dis tori wey I wan tell una na tori wey go touch ur liver cumeme oo!
Police don arrest one man wey hin hame na Waheed for Oke Oyi inside Kwara State, sake of say hin kill hin friend wey be Ajayi Allah...

As we dey check mate d matter we con find out say dis man wey hin friend kill,  na business man wey get money for hand well well... When Police con dey investigate d matter dem see phone wey belong to dis man wey dem kill and cutlass wey get blood stain for Waheed house.
Na so he begin dey confess say nah hin dey behind everything wey happen oo... But hin know no wetin make am do wetin hin do... Hin talk again  say hin friend  promise say hin go buy motor for am.
The wife of the person wey dem kill wey be Modina talk say, her husband make dis man hin friend sake of say dem just pack come that area say dem know no anybody for there. Nah hin make dis man enter dem oo, she also talk say before the thing happen, her husband and hin friend chop together that day... As e be now, the wife dey cry say she want justice.
The talk talk person wey be Ajayi Jeffery talk say dem still dey investigate d matter and dem go make sure say dem carry d man go court.

Support our correct hustle... Dey patient as you click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/2xsRπŸ‘ˆπŸ½skip d add and God go bless you!

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land