Friday, December 20, 2019

Police Don Catch Woman Wey Dey Do Ponzi Scheme Wuru-wuru

Support our correct hustle... Dey patient as you click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/2yt9πŸ‘ˆπŸ½ just skip d add and dey patient.... God go bless you well !

SIMON MERCY

For this Christmas so, no be small wuruwuru matter we go dey hear o!

The Economic and Financial Crimes Commission wey be (EFCC) don arraign one
Maryam Shinga before the federal high court for kano over Ponzi scheme wuru
wuru

This woman don chop forty five million, four hundred and sixty thousand naira wey
belong to the people wey she deceive invest for one Ponzi scheme wey she call am
Golden Premier.

How the woman take do am be say she deceive people say make dem invest with
Golden premier. Say if dem invest N500,000 dem go get one million five hundred
thousand in return, na so the woman cum dey do as she talk o for about six months,
before she begin dey do some kyn wuruwuru dey join am soteh she carry people money run o! Na so dem begin dey look for this woman o, las las na for inside Abuja dem catch her, na so dem carry her go back to the lkano zonal ofice. But the woman say she no dey guilty of these accusation wey dem read give her o.

We hear say the judge don push the matter go January 23 2020 for trial. Abeg o una
wey dey invest make una dey dey very careful because dem no dey write scam for
Face o!


Support our correct hustle... Dey patient as you click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/2yt9πŸ‘ˆπŸ½ just skip d add and dey patient.... God go bless you well !

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land