Monday, November 18, 2019

JENNIFER DANIELS: "I be Actor. I be Dancer. Fitness trainer. I be motivational speaker..."


Wether we like am or not, pidgin language na language wey don come to stay, e no fit go extinct like some oyibo people dey think but we fit refine☺ am so dat e go fit d mode of communication for the century wey we dey so & na wetin me dey try do for dis blog... But dat wan no be d koko, as per say na d language wey me dey use communicate through dis blog... 😁Today, like we dey always do am our guest na another fine babe from Benue State wey dey try for her own hussle no be small... And as we dey always do am, na she go use her own mouth take chop d onions as all of us go siddon to enjoy her story... Oya make we meet our guest;
"My Name na Jennifer Daniels. Dem born me on August 4th 1995. I do Primary school for all saint academy. My Higher institution I do am for National open university Abuja and na mass communication I study."
  Make we stop am there... See as her name take sweet for mouth ba? I hope say somebody no dey salivate as she dey yarn oo, because I no trust some young boys of nowadays... Lol! 😁😁Anyway, make we continue... I bin tell una say dis fine Benue babe don hussle no be small so make we hear wetin she talk when we ask her say na who Jennifer Daniels be?;
"I be actress. I be Dancer. Fitness trainer. I be motivational speaker. Also i dey work on one project wey i call Miss Regal right now."πŸ€” Hmmm πŸ€”see babe wey no wan carry last... Na dis kind thing dey prove say d hussle for dis country dey real... Anyway, she no stop there as she talk say;
"I don also work with several entertainment. Like Sibos entertainment. Godap innovation. Owoicho entertainment. And plenty odas dem..." From the look of things sha, Jennifer Daniels get experience ontop dis her hussle no be small... As we ask her how she take start, she just smile as e be say na her signature mode of communication be dat, as she yarn say; 
"I bin start to dance since I be pikin and I dey act for stage plays since my primary school and I so much love sports. Na from Benue state i commot from & we be 8 for my family and na me be the 5th born. I dey Live for Abuja FCT." As i dey listen to dis babe talk, i dey happy say d crop of young ladies now wey dey come up, na ladies like Jennifer Daniels wey no let circumstances or background or beauty hold dem back or use dem as excuse make dem for no achieve wetin dem suppose achieve... As she go front small answer d question of wetin she dey hope to achieve with wetin she dey do, she talk say;
 "With wetin i dey do now, i go like to impact inside people life, sake of say i wan help them achieve their dream. And again, i wan help other people when dem want make I help dem and i don dey do dis thing for six years now." Wow! Any Papa wey hear dis wan now, go dey wish say na im daughter be dis walahi... Dis babe get good heart and we go dey pray make Papa God bless am nyafu nyafu so dat she fit do pass all wetin she dey do now... Anyway, we go soon match break for her interview but we take style ask her who her role model be, na im she talk say;
Angelina Jolie
"Angelina Jolie wey be Hollywood Actor, na my role model."
As per how long she go wan dey do wetin she dey do, she talk say; "Dis na something wey i always bin wan do, so I go continue to dey do am like for ever..." When we ask am if any project dey wey she do and wey she go want make people expect or look for, she no think twice so yarn say;
"I Just finish to shoot one movie wey d name na Peninna...And I want make una keep ear and eye for ground, for my next project wey go soon show, the name na MISS REGAL..." Las las as per her advice to people wey just dey start, she talk say; "Anything wey you dey do, make you no stop to dey do am... Continue to dey push your dream because one day, you go surely hit the point..." In case you wan reach Jennifer Daniels (for betta talk ooo😑), her social media handles na;

FB: Jennifer Daniels
IG: Jennifer Daniels 99

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land