Tuesday, December 10, 2019

KWAGHDOO JESSICA IGBOKO: "I be Actress, Reporter, Presenter, Humanitarian ..."

No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link πŸ‘‰πŸ½http://locinealy.com/1FaJπŸ‘ˆπŸ½ and try dey patient. Just skip d ad to view am. We no fit thank you enough but Thank you!



Na fact say when you know your passion ehn, e go give you one kind betta something to take build d rest of your life around am... Contrary to d idea say when you dey do wetin you love, e dey make work look like say e no be work, but d truth be say passion go make you work... Na dis kind passion make us waka reach domot of dis fine, energetic, well rounded, (πŸ€”make una borrow me grammar abegπŸ€”) beautiful, intelligent, Benue born chic wey no get replica or photocopy... Lol😁! Anyway make I stop there before me sef lost for dis session because dis natural babe, skin dey shine like say na Angelic special cream she dey use...😻 Okay, make we meet our guest for today;

"My name na kwaghdoo Jessica Igboko, my friends dey call me Jessybaby lol..." Omo! Even her name get power to make normal man like me fall in love... 😍Chai!πŸ™†πŸΎ God take time create some ladies oooo! Oh😯 sorry I don forget say we dey do interview... Anyway, she continue say;
 "Dem born me for Benue state..." Dem no just born am for there oo, na there she come from and i sure say Tiv indegenes and Benue State in general go dey shine teeth😁 now say their daughter dey really try for dis her correct hustle... Ontop her educational background, she talk say;
  "I been attend Mate Nursery school  for Lagos, I con go Mayflower Junior and secondary School Ikenne Ogun State. The university way I con go, na Federal University of Agriculture Makurdi na for there I read Microbiology..." Hmm her educational background just make me open mouth plus e increase my level of respect for Jessica... No be only say she be graduate but d fact say she value education for her to go dis far, na big encouragement to anybody wey understand... As e be say e go get plenty people wey no go know who she really be, na so we con ask am say make she tell us who she be... She talk say;
 "I be Actress, Reporter, Presenter, Humanitarian ..." Wow! She be babe with many talents oooo... As we dey progress her response just dey give me joy and my respect for her just dey increase sef... Make I no talk too much jare🀭, make we continue... On top wetin she go like to achieve with wetin she dey do now, she yarn say; "With wetin I dey do so far I hope say I go become role model to people across the country and the whole world sef. I wan make am big like the other superstars wey una know lol😁 plus I want take care of my family..." Nor worry my dear, God no dey sleep... Your correct hustle go pay off very soon and your wishes go come true Abi I lie? My people check am out na... Anyway, on top how long she don dey do dis her correct hustle and how d journey be like, she talk say; 
"Professionally na my third year for industry be this.  The only thing wey I fit talk be say Baba God don try for me  Well Well..." I tell una say Jessica na correct babe with sauce and e dey reflect ontop d way wey she dey feed our curiosity with her responses... Okay for here na im we con ask her say as she don reach dis leave who con be her mentor(s)... She talk say; "Hmmmm my mentors them plenty oo lol😁 because, e get some wey I go look dem, pick one thing from dem and i go say I wan be like or more than the person..." Okay na dis kind time oyibo dey say 'fair enough'... Okay what of how long you feel say you go wan dey do dis your correct hustle? She sharperly respond say;
  "HMMM THIS ONE NA MY PASSION OOO so something wey you get passion for, no suppose get end time na... Except God say my pikin e don do, if not na forever be this oo lol...😁😊" Okay d passion wey she possess ontop dis her correct hustle dey enough to last forever from wetin I don observe so far... Time no be our friend from dis point but as we sharperly ask her which kind legacy she go wan leave wey go make people remember her, she talk say; "My legacy be say follow your heart and do you. E no matter how e be or how e hard..." Make we follow our heart and do you na wetin Jessica dey yarn... if you get betta ear, make you hear. Time to advice go come but as per wether project dey, wey she do or joinbody do and she go like make we dey aware of am, she talk say;
  "Current project dey but na small pikin e never mature so una go just wait make e mature then una go see am lol...πŸ˜„" Chai dis babe sabi smile ehn... Na for here she con dey advice those wey just dey start say; "My advice to upcoming actors  and actresses be say follow your passion. We all know say e no easy and nothing good  dey come like that. Just put your mind for wetin you dey do and remember to dey pray. Hard work dey pay oo..." Oya una don hear am, no be magic and no be scopes but na fact say hardwork  de pay as Jessica don talk am... Las las on top wetin she go like talk again before she sign out go enter her ✈private jet🚁 wey dey wait for her to take style jet her commot for Naija so dat she fit continue her correct hustle, she yarn say; "Nothing dey again oo. Make una just watch out for this girl. She dey come!!!  Thank u...πŸ‘ΈπŸΎ" Thank you too Miss Kwaghdoo Jessica Igboko aka Jessybaby for dis time wey you create for us, we no dey take am for granted... Incase you wan Chook mouth on top dis matta wey concine her, you fit do so for under here and you fit still reach her on top her social media handles:

Instagram na @jessiviva 
Facebook  na kwaghdoo jessicca

No forget to try anyhow wey you fit, to support our correct hustle... Just click dis link πŸ‘‰πŸ½http://locinealy.com/1FaJπŸ‘ˆπŸ½ and try dey patient. Just skip d ad to view am. We no fit thank you enough but Thank you!

2 comments:

  1. Oh well I guess I'm still on the spotlight πŸ€—πŸ™πŸ™

    ReplyDelete
  2. Yes you are dear, no one can take your shine... Shine on deary

    ReplyDelete

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land