Thursday, November 14, 2019

OYIGBO BLESSING: "I be Makeup artist"

If soup wey sweet na money kill am, wetin we fit con talk about woman wey sabi do make up like dis fine, very young talented babe wey be our guest today? Dat wan na puzzle discussion for another day... Make up don be serious business especially for ๐Ÿ‡ณ๐Ÿ‡ฌNigeria๐Ÿ‡ณ๐Ÿ‡ฌ of today... As simple as some people think say the thing be, e still get processes and training wey person go gats follow to become professional wey go dey make betta money as we dey see today... But make we take style chook ear for ground hear from her as she go take her mouth chop d onions like we dey always talk...; 

"My name na Oyigbo Blessing. Dem born me on 11th November, 2000. And I be undergraduate for University of Abuja..." Dis babe na very respectful babe and e dey evident for the wey she dey respond even as we yarn pidgin together... On top who she be, she yarn say;

"I be Makeup artist and na Passion wey I get for the trade make me dey pursue career for there..." Hmm if you see wetin i dey see, you sef fit talk say, na one of the youngest if not the youngest Make up Artist wey dey area be dis ooo because dis babe sabi her work well well I no go lie... But anyway, as we move like motor wey nor get break because of time, we con ask her say wetin she want make people remember her for, as she dey pursue dis her career... She talk say;

"I wan make people know me for good, and as the best entrepreneur." For any young babe of her age, wey go talk like dis, e mean say she know wetin she dey do when e concine make up... D thing sef don dey make me wish say I be woman so dat she go make me fine and fresh as she dey... Lol!๐Ÿ˜Š๐Ÿ˜š☺ Onto how long she don waka for dis make up business, she talk say; 

"Na just 3years now..." Omo! 3 years o and she don go far like dis ooo... ๐Ÿ˜ฎ๐Ÿ˜ฏDis wan na wonder babe oo! Toh, on top who for her field wey she go like to be like, she no waste time to say; "Myself..." Lol!๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚ Blessing really like herself ooo... Anyway as we take waka go front small, na so we ask her say wetin she go wan leave wey people go take dey remember her for... Straight up, she yarn say; 

"Good example..."๐Ÿ‘๐Ÿฝ๐Ÿ‘๐Ÿฝ I reason am, e make sense because if people know say you be betta person, na you dem go wan work with. Dem go even make their friends friends kuma wan work with you... As time no be our friend again for dis corner, na so she tell us say some kind project dey wey she dey inside and she dey learn knitting and na to add to her entrepreneurial knowledge... 

Dis babe no wan dull at all and na betta thing be dat... Dis wan mean say she go waka far far for dis thing wey she dey do... But we wey be her fans go only dey pray for her and take style support am when e no far from our hand to do am... I don too talk too much and na here we go wan match break but as we dey do am, make we hear wetin she yarn as advice to other talents wey dey like her; "Be yourself, dey patient, understand ur customer, do ur best, make sure say ur customer dey satisfied, communicate with people, dey humble, respect people cos u no no hu b hu"

AGATHA GAMBO: "I wan be Director, I wan try add ma own salt and maggi to d soup..."

"Na our work o!"๐Ÿ˜‰ I dey try remix Falz song dat year wey make people just dey proud of their handwork... Me sef dey proud of my handwork o because dis work dey make me meet betta people like dis fine babe wey I just jam so... Omo! I dey tempted to wan tell Una some kind things about d babe but make I leave matta for Matthias so that she go take her mouth chop the onions wella... Who be our guest today?;
"My name na Agatha  Gambo. Dem born me for Kaduna state..." ๐Ÿ˜„Drama full dis babe body I no go lie... Hear wetin she talk when we ask her say make she tell us about her educational background?๐Ÿค”; "I no understand this question oo. Na primary school,(handmaid international primary school) secondary school ( Regina pacis girls secondary school) or university ( Madonna university )?" Chai! She be typical Nigerian wey dey answer question with question but anyhow wey e be, shebi she take style answer d question wey make me con discover say me & her even go thesame primary school sef...๐Ÿ˜ Lol!๐Ÿค— As we sharperly move from there, na so we ask am wetin she dey do currently? She talk say; "I dey work for one media house wey dem dey call fresh news for Garki..." No wonder she fresh like fresh tomatoes so...lol!๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ Anyway make we go front coz with dis babe, no dulling moment... Onto when she start dis her career? She yarn say;
 "hmmm I start to act for church choir den for university I join one theater group where I come know say I like to act..." Na so! E mean say all d gra-gra wey dey her body wey don make am betta Actor today, e don tay wey e start, no be today...(if you sabi, you sabi... Lol) As per wetin she go like achieve with wetin she dey do now, she talk say

"las las I wan be Director, I wan try add ma own salt and maggi to d soup..." Hmmmm Correct babe with correct sauce! I know say film people and people wey sabi her intototo go dey talk go their mind say;(no be small thing o!๐Ÿ‘Œ๐Ÿฝ) If you Sidon dey yarn with dis babe, make I talk true, she dey boost morale(no ask me how o!๐Ÿคท๐Ÿฝ) Make we continue... Na for dis corner we con ask her say, how far she don waka inside dis her career? She talk say; "hmmm I Don waka small sha, like joke e Don dey reach 8yrs..." 8 years na im be small?๐Ÿ˜ฎ Chai!๐Ÿคฏ Senior Agatha!๐Ÿคฆ๐Ÿฝ Anyway, Make I reserve my comment for there...๐Ÿคซ Na so we still con ask her say who be the person wey she go like be like for her field? Dis one she talk say; "choiii make I think this one well o. I wan just do ma thing and finish am well. I no wan limit maself..." OK... How long you wan con dey pursue dis your career? She no waste time to talk say; "I wan do am till I dey see white hair for ma armpit lol..."๐Ÿ˜‹๐Ÿ˜‹๐Ÿ˜‹ Omo! E dey too sweet me to hear Agatha Gambo dey talk especially for pidgin coz she be correct babe inside out(make I no too talk ooo๐Ÿคญ)... As we con go front small, we con ask her if Anything dey wey she go like leave wey go make people fit take remember her? She yarn say; 

"Make people no listen to anything wey anybody dey talk about dem. Dem go talk wether u do am well or not. Just dey do d mumu thing wey dem dey see u do, as time pass dem go dey use to am, come like am..." ๐Ÿ‘๐ŸฝCorrect ๐Ÿ‘๐Ÿฝtalk from person wey don tay small (as she take talk am)for the field... Any project wey dem just do wey you dey involved or you join body do, na d next question wey we ask her. And on top dis wan she talk say; "ohh yes o. I Don do some jobs... Now like dis we just finish the second season of Palace wey I do house help and e dey show for AIT. Dem dey show am every Sunday by 9 pm. And I Don kukuma produce ma own first movie wey d name na DEMYSTIFIED. So yes..." Omo! See levels na...๐Ÿ˜š☺... We go chuck ear and eye for ground dey wait for when Demystified go comot so all of us celebrate with you... But as e be say we don dey talk too much and time don dey give us signal to vano small before we match break, she con advice others wey dey come up inside this same filmmaking field wey she dey, say;
"make una no ever give up..." Las las, for her last words before she enter her ๐Ÿšflight✈ tell us bye bye, she yarn say; "yes oo . I wan tell u say I dey very proud of u. U na one person wey no dey ever give up no mata how e dey burn ur nyash. Kudos!" ๐ŸคฉChai! Make una hold me oo my head wan burst oooo!๐Ÿคฉ Lol!๐Ÿคฉ I no go only Thank Agatha Gambo for dis kind exclusive wey she give us but i wan also Thank all of una wey dey make time to read every information wey we dey bring for inside dis blog... Na only God go bless una Nyafu nyafu! Make una stay tuned for more ontop Gbedu And Gbege Information!

Dis na Agatha Gambo social media handles;
IG: Cup_ids
TWITTER: agatha gambo
FB: Agatha sarauniya Gambo

ONUH ENE JOAN - "I DON ENTER 8 DIFFERENT CONTESTS; I WIN 6"

As to dey waka upandan no dey ever do bloggers like me, sake of say plenty gbedu biography gist full town, wey be our own way to take style celebrate and promote d many talents wey full we country. Na so my waka con make me jam dis Idoma Beauty Queen wey don waka well well for the pageant industry sotay right now she be one of the contestants of Miss Idoma 2019... As una know how we dey do am, no be me go use my mouth take chop her onions but make we take style relax con follow her as she sama us with betta gist wey go sweet una belle... Oya make we meet our guest today;
"MY NAME NA ONUH ENE JOAN AND NA ON THE 17TH OF MAY 1993 MY MAMA BORN ME FOR INSIDE UGBOKOLO FOR OKPOKWU LOCAL GOVT WEY DEY BENUE STATE..."

Chai!๐Ÿ˜ฎ D way wey some of these fine babes dey take style scatter pidgin ehn, if you dey for their front, you go just dey smile๐Ÿค“ mumu ๐Ÿค“smile bcoz as oyibo dey talk am "it can take your breathe away..."(if you fit translate am for pidgin, you be BABA... Lol!๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚) Make we continue. As I take dey lost inside my mumu ๐Ÿคกsmile as her pidgin dey sweet my belle, na so she just take style pinch me back to reality wey make me remember say I suppose ask her about her educational background and wetin she dey do... She continue say; "NA FOR BENUE STATE POLYTECHNIC I FINISH FROM, AND NA THERE I STUDY SCIENCE LAB TECH... RIGHT NOW, I BE FASHION DESIGNER, I DEY INTO ACTING AND MODELING TOO..."
Omo! Dis babe na no dulling babe o! She get swag, she get skills, she sabi book and on top of dat one, she be wife material oo๐Ÿ˜Ž(no be talk am ooo!๐Ÿ™„) Anyway, as d gist dey sweet dey go, na so we con ask her wetin she dey plan to achieve with wetin she dey do... Na so she yarn say; "I DEY PLAN TO STILL GET  ADDITIONAL SKILLS AND TO CONTINUE MY JOINBODY WITH BETTA PROFESSIONAL ASSOCIATIONS DEM..." Hmmm babe wey sabi book ehn... Make I no talk too much sha... Unto wetin she want make people take remember her, she yarn say; "I WANT MAKE PEOPLE REMEMBER ME FOR MY HUMILITY, MY HARDWORKS, EVEN SAY I NO DEY EASILY GIVE UP AND THE KIND BETTA QUALITY OF DELIVERY WEY I DEY GIVE..." As per how far she Don Waka for her career, she still con yarn say;
"I BIN START TO LOVE WETIN I DEY DO, SINCE WHEN I DEY PRIMARY SCHOOL. E BIN NO DEY EASY EVEN TILL NOW, BUT GOD DON DEY HELP ME WELL WELL... FOR MY MODELLING CAREER, I DON ENTER 8 DIFFERENT CONTESTS & BY THE GRACE OF GOD I WIN 6. EVEN FOR INSIDE ACTING, I DON FEATURE INSIDE DIFFERENT MOVIES . AND MY FASHION CAREER NA IM DON ALWAYS BE MY BACK BONE WEY I USE TAKE ACHIEVE THE OTHER TWO. AS E BE SO, I NO WAN STOP HERE BECAUSE I STILL GET PLENTY ACHIEVEMENT WEY I WAN GRAB..." Hmm true true dis babe no dey easily give up ooo... Her talk sef dey make English finish for my mouth because she, na very interesting person to dey yarn with... As we go soon off light on top her interview session, we con kukuma take style ask her how long she wan do dis thing wey she dey do? As a sharp babe, na so she yarn say;
"SINCE WEY I BE PIKIN I DON DEY DO AM AND I GET PLAN TO CONTINUE DEY DO AM AS FAR SAY I DEY HAPPY AS I DEY DO DEM..."
Omo! See strong passion! I hope say young ladies go learn from dis experience sha... As per who con be her role models wey make her passion strong reach so, she no waste time to talk say; "FOR FASHION DESIGNING, MY ROLE MODEL NA...
Lanre Da Silva
LANRE DA SILVA...


FOR INSIDE MODELING, MY ROLE MODEL NA...
Agbani Darego
AGBANI DAREGO... 


AND FOR INSIDE ACTING, MY ROLE MODEL NA... GENEVIEVE NNAJI..."
Genevieve Nnaji


As yoruba dey take talk am "lobatan"(take style ask yoruba person wetin e mean๐Ÿ˜‹)



Las-las, as we wan take style match break ontop d interview with Ene Joan, her advice to upcoming and younger talents be say; "MAKE UNA WORK HARD. DEY CONSISTENT. STAY POSITIVE. DEY UPDATED. IF DEM CRITICIZE YOU, ACCEPT AM CON MAKE CORRECTIONS. FOLLOW YOUR HEART AND MAKE YOU NO FORGET TO ENJOY YOURSELF FOR WETIN YOU DEY DO..."
As una kukuma know say she dey currently contest for Miss idoma 2019 make una show her love and support and still take style vote for her from this link;
https://www.quiz-maker.com/poll2603139x19a24387-74
Incase you need the code to vote for her you fit comment under here and we go provide una with the codes wey una go use vote for ONUH ENE JOAN...
IG @officialenegold

facebook. Enejoan onuh


ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land