Thursday, February 21, 2019

Haba! See Wetin Happen To Two Men Wey Go Rape Married Woman For Benue State...


Police don arrest Two men wey dem identify as, Tersoo Joseph, aka Adikpo, and Demenenge Iorwa, because of say dem rape one married woman for Benue state.
Na the Commissioner of Police,  Mr Omololu Bishi, na him parade the two men wey dem arrest sake of say dem rape one married woman, and him reveal say dem also Theif from their victim.
The Benue State Commissioner of Police, Mr Omololu Bishi, as him parade the suspects talk say;
“On February 9, 2019, around 6pm, some armed robbers wey dey operate with motorcycle behind the Bem Hotels, Ankpa Quarters, Makurdi, been abduct one woman, con carry her go Quararafa Quarters, for Wadata, where dem rape am, con theif her phone and N2,000.
“During investigation, Tersoo Joseph, aka Adikpo, and Demenenge Iorwa, from Logo 1, inside Makurd, we arrest them in connection with the case. The suspects don confess say true-true dem commit the crime”

Whatsapp wan begin let users do 'back to sender' for yeye group chat invite



One website wey dey announce Whatsapp features, www.wabetainfo.com don announce say di chatting app dey plan to add feature wey go let users control who dem fit add to groups and who dem no fit add.
One of di tins wey dey vex pipo on top Whatsapp na say anybodi fit add you to group chat without your permission, even if you no wan dey di group.
Whatsapp users don dey complain about am for some time now but complain no more because Whatsapp dey plan to bring solution.
Dis new setting wey go dey di privacy menu for Whatsapp, go give users options to accept group chat invites from everybodi (wey be di current setting), only dia saved contacts or nobodi at all.
Incoming invites go only dey active for 72 hours after which e go disappear.
Whatsapp neva tok wen di feature go dey available but special users wey get di test version of di app go fit begin see am now.

#ArewaMetoo: Fakhuus Hashim say her uncle abuse her wen she dey young


Fakhuus Hashim wey start di #ArewaMetoo movement for Twitter wey dey aim to stop touch-touch abuse for northern Nigeria, say she suffer abuse wen she dey grow up and na why she dey push say make things change for her region.
Madam Hashim wey follow BBC Pidgin tok, say many pipo don give dem bad mouth, say dem wan disgrace northern Nigeria with di movement and some dey even threaten dem.
"Personally I also experience abuse and dis make me rally round to get pipo wey get experience like my own, because na we go understand wetin happun pass.
"Di only thing wey I go tok about my own experience be say na my close relative, and uncle and e happun wen I dey 6 years old.
"Tey tey, di issue of sexual abuse na one wey pipo no too dey discuss for northern Nigeria because dem dey feel say na disgrace but as di movement dey spread across di world, we all know say na mata of time before e reach dis side," she tok.
She say no be only for Twitter dia work go end as dem go do march for Kaduna State next week on di issue and dem don join hands with various NGO's wey go dey help pipo wey get experience of touch-touch abuse.
Im also yan say ogbonge sabi pipo for mental health don already get in touch wit some of di victims wey reach out on Twitter and dem don dey help dem to recover from wetin happun to dem.
On di issue of threats wey she don receive, she say na just verbal abuse from some pipo but na one particular pesin on Twitter take im own go far and dem don report am to security pipo wey dey investigate am...

Teenager wey her Papa give am Belle, don born for Edo State




From Ayim Raymond...


One 13-year-old girl, weh her papa been give am belle, don born Saturday for inside Benin Central Hospital, weh dey for Benin City, Edo State.
The teenager, weh been dey primary six when her papa give belle, don dey the hand of the Edo State Government since.
Na she be the eldest daughter of her 42-year-old papa weh them identify as Mr. Friday Moses, weh come from Cross River Sate come dey stay for Edo State.

Her papa, weh be Okada Rider, start to the sleep with her since she been dey 7years old by the time weh her mama die.
One Edo State Family Court for October last year been sentence the man go 14 years imprisonment with hard labour without option of fine.

The girl com the tell The Nation news people say she go like go back to school to become doctor.  The teenager talk say the time weh her papa been give her belle, she been never write her First School Leaving Certificate examination.
She say she go happy well well if them go fit help support her education.

The Medical Director for the hospital, Dr. Philip Ugbodaga, talk say him don direct make the management cancel the bills of the girl.
Him talk say the hospital been join body with the Ministry of Women Affairs and Social Development to take proper care of the teenaged mother and her baby.
By that time, them been no fit reach the women affairs and social development Commissioner Mrs. Magdalene Ohenhen to hear her comments.

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land