Monday, December 2, 2019

JOSHUA CALEB: "Na filmmaking I dey do and na me be the CEO of Team Josh production (tjp) and also the CEO of Josh Ola films..."

Support legitimate hustle wey talented guys like Joshua Caleb dey do, just click here πŸ‘‰πŸ½
http://legeerook.com/cZV πŸ‘ˆπŸ½

Person wey wan grow for dis life go grow... And na d reason why we dey advocate for legitimate hustle no matter how hard d country be... Nollywood no dey any different as even d practioners and veterans dey advice Cast and Crew say make dem try dey get handwork so dat dem go fit stand when wetin oyibo dey call 'rainy day' go come... But d truth be say, Crew dey mostly under celebrated because people no dey get to see dem as dem dey see Casts for on top screen. And na wetin dey produce stars wey we dey celebrate today. But without these crew guys and ladies, some of d stars no go even smell limelight ooo! Na dat wan make our waka carry us reach d domot of dis talented young man wey don joinbody as crew member, dey pursue him legitimate hustle jejely. Dis attempt na to celebrate am and those crew guys and ladies wey dey tirelessly work day and night for d stars wey we dey celebrate today. Dem ma, need celebration. Make we meet Joshua Caleb...;
  "My name na Joshua Caleb. Dem born me for kaduna state for d year 1990 for the month of November 20th..." Omo! Nobody need to tell you say pidgin sweet😁 for Joshua Caleb mouth like say him follow create am...πŸ€£πŸ˜‚ Kai! Make we continue jare... Ontop him educational background, him talk say;
  "D school wey I go, na Christ Children School and Christ High school. Den I come go Yaba Technology School for Lagos..." OK as we don hear dat wan, na so we con ask am say as we dey talk, na wetin him dey do now? Him still comfortably answer say; "Now na film making I dey do and na me be the CEO of Team Josh production (tjp) and also the CEO of Josh Ola films..." No be small thing oo! So how you con take become film make? Joshua still yarn say;

"hmm as I take be film maker no easy oo.... First, film na wetin dey give me joy so my first step wey I take na determination... Dat wan mean say I carry am for mind and I follow am up... I serve people so dat I go learn and Sabi..." Unto dis level now, wetin you dey hope to achieve with Filmmaking wey be wetin you dey do? Him yarn say;
  "Na plenty things dey to achieve with am ooo... First, people go Sabi u. After dat wan, u go get respect for society and if you plan ur life well, u go use d money do betta things for life..." Na true you talk bros... Just as oyibo dey talk am 'proper preparation preceeds proper performance'... Oya make we continue before we use Joshua Caleb session do philosophy seminar...😁 Na for here we con ask am say, how long him don waka on top dis him filmmaking career? Sharperly, him respond say;

"hmm I don Waka far oo sotay my shoe self Don chop untop the Waka πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚but I thank God say the Waka Don dey pay..." Correct! E nor easy for guys like Joshua Caleb if you know how him take start but as oyibo still dey talk am, 'd end go justify d means'... OK so as you don reach dis leave, I sure say you get mentor(s), who dem be?  Joshua tell us say;

"For my field I go like be like the top film makers wey Don make big name oo..." Correct guy, him sabi dodge some kind questions but him answer am well well... Na for here we con ask am say, Precisely like how long him don dey do dis waka and how long him wan dey do am? Him still yarn comfortably say;
  "I Don dey do am for 10 years now and I go do am till d end of my life oo..." See passionate youth wey wan do positive things with him craft. I know, because na me and him dey yarn right now...πŸ˜‹ But Make we leave matta for Matthias... Unto wetin him go like leave as legacy for dis career path wey him don choose, him talk say;
  "Plenty things dey... But First, I Don follow some people build their dreams, for now i dey okay with dat legacy and i believe say more go come..." As time don dey give us signal say make we begin find where to match full stop, na so we sharperly ask am wether some projects dey wey him don do or him joinbody with odas do? Him sharperly respond say;
  "so many projects dey... Like 'Cockcrow' na me do Gaffer for the film. 'Stained' na me do Gaffer. 'From The Street' na me do Gaffer. 'Seizure' na me be the DOP. 'Unfailing Vow' na me be the Director, the project na my film..." Omo! Joshua Caleb don achieve well well ontop him 10 years waka for Nollywood ooo... Nuff twale for dis young guy wey dey contribute him own quota small small through filmmaking... As we don dey near to pack kaya escort am go him private 🚁helicooter🚁 wey dey on standby to carry am go d next set, we kukuma con ask am say wetin be him advice to those wey just dey start?;
  "my advice be say make dem dey focus and make dem no dey too big to Serve because If dem too big to serve, na im be say, dem go too small to rule... Make dem get respect for people wey dey their front for dem career and make baba God be their back bone..." Las las ontop another thing wey him go like add, him say;
  "another thing wey I go like talk about be say, anything or any position way u find ur self, I beg take am help others wey need help..." Dis na betta advice from betta person wey don do well so far for ontop him career. Make those wey get ear, hear word well well! I know say many of us go like chook mouth ontop dis interview, no sweat, you fit do am under here to celebrate and apprecaite Joshua Caleb and in case you wan also reach am, you fit do so ontop him social media handles wey be:
FACEBOOK: Joshua Caleb88 or Joshua Caleb
INSTAGRAM: Joshua Caleb 88 


ROSEMARIE PAMSIC (MISSY): "I bin take the lead for inside the movie STOLEN ROSE..."

We dey advocate for legitimate hustle... If you get good heart, click here πŸ‘‰πŸ½http://legeerook.com/N6s πŸ‘ˆπŸ½ to encourage handwork for survival and discourage social vices!!!

Legitimate hussle don become d ingame for dis era and e make sense to see say plenty talented youths dey engage inside so many legitimate hussle because dem wan atleast take style contribute their own quota ontop nation building... And na d reason wey we dey always waka for Naija to find these kind talented youths so dat we fit celebrate dem and encourage dem to take style boost their morale... Anyway our guest for today na another talented youth wey don dey try for Nollywood for sometime now sotay she recently take lead role for one of her recent films... But as we dey always do am, make we allow our guest use her own mouth chop d onions(na im dey sweet pass...Lol!πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚);
 "My name na Rosemarie Pamsic (Missy). My Papa and Mama born me for Beji, for 1997 and na Niger state I come from..." Hmm mm I hope say Niger state people dey see how their daughter dey make dem proud ooo as she no wan carry last inside dis her legit hussle... Make we continue sha. On top her educational background she talk say;
  "I bin attend Beji primary school, Government girls secondary School kaffi-koro Niger state, and National Open University Abuja from where I bin Study environmental science and toxicology..." Omo! Dis Niger young babe know d value of education ooo! See how far she don go... I twale for dis babe I swear! But make we continue sha... Na for here we con ask her say, because of people wey fit no know who she be, make she tel us who she be and wetin she dey do now... With her sweet Niger State pidgin voice, na so She sharperly talk say;

"I be Model and i be Screen Actor..." Ehen☺ she don use her mouth talk am and I sure say people especially Niger State people go wan know which films she don do but dat wan na later gist... On top wetin she go like to achieve with wetin she dey do, like say she don rehearse am well well, she sharperly talk again say;

"True true ehn, i go like achieve influence, Fame money and d kind things wey joinbody with these kind things..." Lol!πŸ˜†πŸ˜… Na who know like betta thing na! Dis babe na correct open book wey no dey hide her mind... As we continue, na so we ask her say, as e be so, how far you don waka on top dis your legit hussle? To clear d minds of people wey wan know if she don dey act films tay tay before now, she respond say;

  "i don act inside reasonable number of films wey don commot as we dey talk... So I fit consider say my journey far already... Lol!" Okay, for dat case, on top dis level wey you dey so, who you fit say be person wey you dey look up to? Her answer shock me as e go shock you too because e dey rare to see us dey look up to dem but na d thing wey make Missy different be dis and to dey positively different for dis era wey we dey so, na betta thing... She talk say;
KIM CHIU
"Kim Chiu (wey be Philippino Actress)" Toh i know say many of us no go know her but make i help una small. Her real name na Kimberly Sue Yap Chiu and she be Chinese Filipino Actress, Singer, Recording Artist, and Television Host for the Philippines. If you need more info about Kim Chiu, no forget say Google na your friend... Lol!😁 As we continue na so we con ask her say na how long she precisely don dey pursue dis career and how far she dey hope to pursue am? She yarn say;
 "I don dey pursue am for three years now and I dey hope to pursue am for the rest of my life as  my career..." Hmmmm Missy really know wetin she want ooo! And we go always dey pray make God help her on top her legit hussle... Anyway, time no be our friend for dis point so we sharperly ask am say wetin she go like leave as legacy wey people go dey take remember her? She talk say; "I go like make people always remember me as dat girl wey bin start acting from nothing, con dey take extra roles for movies. And most of all make dem remember say, I no ever bin think of to give up..." Okay unto d betta part of our interview with Rosemarie Pamsic, we ask her say, we hear say she recently take lead role for her latest film, which film be dat?;

"Yes, I bin take the lead for inside the movie STOLEN ROSE..." Wow I don put am for head, I go dey wait for d release of d film and make all of una also anticipate for am... On top her experience for dat set, she talk say;

"D thing bin get as e be sha and some times we go stay for set dey shoot from morning till afternoon or so without food (walfare), some of us go even wound for d process of the shoot and all. But we go just get d mindset of say, we go make am one day... I no dey ever think of to give up..." Hmm dis wan don proof say to shoot film for Nigeria no easy ooo talk less of to pursue career as Actor for Nollywood... But we go always dey appreciate people like Rosemarie Pamsic and hope say as she dey keep hope alive, we sef go keep hope alive say Nollywood go betta pass d way e dey and these young talents go always dey celebrated... Before we match break for dis session, make we hear her advice to upcomers;
  "To upcomers wey dey read dis, make una know say, anything wey you believe in, anything wey you get passion for, go for am and make you no ever think of to give up..." Las las, she still talk say; "I go like to appeal to modeling agencies, I know say na showbiz but make dem no dey do am at the expense of another person. Yes. If we go dey take style welcome young talents and hardwork I believe say we go go FAR..." Toh una don hear am all from Rosemarie Pamsic (Missy), incase you wan chook mouth on top her matta, you fit do so under here and you fit also follow her on top her social media handles;
IG: officialmissy01

Twitter: @Rawgold🌹

Facebook: Mis Sy Rawgold

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land