Thursday, October 10, 2019

FABP 2019 informate + Pictures of The Fine Damsels Wey Dey Contest

Face of Art Nigeria Beauty Pageant(FABP) na one Pageant wey don make her name from consistent delivery ontop standard and promises. We strongly believe say anybody wey dey come to contest for FABP go dey vision minded and purpose guided for pageantry(no mind the grammar but if you confuse, check dictionary)
and that one na as the organizers wey be (Black Giant Signatures) take understand am... This place no just be place to display Beauty, but na place to groom and project better Role Models and Brand Ambassadors.

OYA! TIME DON REACH FOR UNA TO SEE THE CONTESTANTS FOR FACE OF ART NIGERIA BEAUTY PAGEANT 2019, SOCIAL MEDIA, WEBSITE AND CODE VOTING don START oooo.














IF YOU WAN VOTE, LIKE OUR PAGE; https://m.facebook.com/story.php?story_fbid=737671939991302&id=350438315381335...  LIKE THE CONTESTANT PICTURE WEY YOU WANT AND TALK SOMETHING ONTOP(COMMENT).

OUR INSTAGRAM PAGE NA
@Faceofartnigeriabeautypageant.
TO VOTE ONTOP, FOLLOW OUR PAGE
LIKE THE CONTESTANT PICTURE WEY YOU LIKE, TALK SOMETHING ONTOP (DROP A COMMENT)

To VOTE FOR WEBSITE FOLLOW THIS LINK http://elfrique.com/s/fabp2019
OMO! THESE QUEENS NEED UNA VOTES OOO!

SOCIAL MEDIA VOTING (INSTAGRAM/FACEBOOK)  NA 5%
CODE/WEBSITE VOTING NA 10%
TICKETS NA 30%
CAMP NA 5%
GRAND FINALE NA 50%

SAMBLESSED; "I be Gospel Music Minister, I be Song Writer and Singer."

These na the days of worship when bobos and guy men dem, suppose dey worship God with their Spirit and with truth. And na the reason why God don raise people like Samblessed so dat dem go take style spearhead this cause... Oya! You know as we dey do am na; make una siddon relax as we meet one of Abuja better Gospel Artist wey love to use music communicate to him generation...
"My name na Samuel Agbo and my stage name na Samblessed. Dem born me for Bauchi, Bauchi State on the 6th of July. My early primary school na partly for Bauchi state and Benue State. My secondary school na for St Michael's college, Apa-Agila wey dey for Ado LGA. I come proceed to Benue state polytechnic where I get both ND and HND respectively."
I no say person go dey expect say people wey dey sing like Samblessed fit no sabi to scatter pidgin but no be so oo. Our brother sabi pidgin like say him follow invent am... Him continue talk say;"I be Gospel music minister, I be song writer and singer. Although for now, I still dey do government work too." 

Omo! See levels na... Anyway, when we ask am wetin him dey hope to achieve with him music, hear wetin him talk;
"Wetin I hope to achieve dey plenty especially for music. My assignment for earth na to bring souls back to Christ. I wan reach the world with the Word through music the way wey  God want make I do am. I wan reach where  I go fit put smiles ontop the face of people. I wan see people healed as dem hear my songs. Basically, I wan see God glorified through me."
From Samblessed we learn say e go good make person sabi him calling for this life early ooo. Dat na why when we ask am say how far him wan go with him Music, him con talk say; "I wan go as far as my life reach ontop earth."
When e con reach mentorship matter, as in who him dey look up to or learn from, him yarn say;
"I still dey pray make God direct me to the right person wey Him choose for me. Although that one no mean say I no get people wey I admire or look up to. I love and admire people like Samsong, Chris Morgan and Donnie Mclurkin well-well. Samsong in Particular don influence my style of music well-well."
As the matter con reach dis level na so curiousity con make us ask our brother how long him don dey do gospel music, as him talk say;
"I just dey write songs dey sing for Church before, but official time wey I start music na 2012 and I hope to dey do am for the rest of my life." Mehn, dat one mean say Samblessed don dey around for about 7 years now ooo!
Anyway, on top legacy wey him wan leave wey people go take dey remember am, him talk say;
"I don suffer and struggle especially for this career. I wan make sure say I raise talented people and assist them. Make them find am easy to take style expressly explore their God given talents." Correct! See better person for dis generation... Him no stop there o. On top wether project dey, wey him dey work on, wey him go like make we know about, Samblessed yarn say; "No current project dey for now." Toh na here we almost shake hands tell am bye bye as e be say, to get Music Artists to siddon one place no easy but as a cool, humble guy wey him be, him still get time advice people wey dey plan to start or become gospel artist like am. Him talk say;
"My advice to upcoming talents be say make them dey focused and determined. Make the passion for wetin dem dey do, dey strong pass the appetite for quick money. Also, make them no let anybody despise them. People go must one look down on you, but make you no look down on yourself. If them look down on you, just look up to God, na only Him dey up and Him no go ever look down on you but watch over you." 
Hmm person wey get ear, make him hear because dis one na strong words from person wey don go far o! As him take finish him interview, him talk say;
"If e never happen d way wey you want, e no mean say God no love you. Na Him make time, Him no dey late. God bless you!"

That na the plenty gist wey we fit get from our brother Samblessed, but incase you wan reach am or follow am, social media don make am easy;

Fb: Samuel Agbo
Fb page: Samblessed
Twitter @ SamblessedA
Insta: Samblessed1


ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land