Wednesday, January 23, 2019

Shuu! See As God Punish Person Wey Wan Use Juju Win Baba Ijebu...





From VIVIAN SUNDAY...

one man wey dey go look for spiritual power so that hin go fit win lottries sharp-sharp, we hear say hin don go blind. This story we get am from the News Agency of Nigeria (NAN)...

Emanuel wey be the victim wey dem no gree tell us him real name, go look for help from dibia wey dey for ishiagu village near ogwashi uku, inside Delta state, say make him for get eyes to see lucky numbers.  Hmmmm one friend of the victim, wey him name na Osita, tell the News Agency of Nigeria on Sunday for ogwashi uku say the incident happen after 12 days don waka comot from January, 2019...


Na wetin hin tell them be this “him go see dibia  make him for help am win lotto game aka baba ijebu. Hin don tell me say hin no dey fear to play lotto game sake of say hin knw say, hin go win..according to am , Emmanuel go look for help for dibia and hin tell am say make hin no worry  hin go help am. Say na so dibia prepare concotion for am,say the dibia give am the concoction make him drink con tell am make him rob am for hin eyes, Emmanuel no tell anybody wetin hin do until the eye no con gree open again na so hin con dey shout, na as I hear am from one of our friend, I con go see Emmanuel before hin con tell me wetin happen...

 We carry am go hospital , as the eyes don swell up, but the doctors no fit do anything... Now hin no dey see again  from wetin the News Agency of Nigeria gather , we hear say the dibia don run go hide for where nobody go see am , and say they still dey look am...

Uwuu! Hyena Enter Kano State, Police Arrest Am For Station...



From BUSAYO OLOWOOEKERE 



Area been scatter small on monday evening after police been arrest one animal wey dem dey call Hyena wey been miss road,  den carry am go inside detention for inside one police station for the area.

Dey been talk say dis thing happen for inside Kura Local government area of the sate.

The strong people for the area  been catch this animal wey na flesh e dey eat, tie am down after den spend hours to take catch am.

Fear fear pipo for the area been gather to take see this animal we den never see before...

According to how the report come den no no weting police later do with this animal wey den put for detention...

Na wa o! Wetin Married Man Dey Find For 7-year-old Girl Body For Delta State...



From Ayim Raymond...

Police don gbab one 44-year-old married man, sake of say him go enter one 7-year-old girl for Sapele area of Delta state.

According to reports, this suspect weh them arrest few days ago na papa of two children, and them say him name na Promise.

After them arrest am, him agree say him commit the crime, and him come dey even talk other bad bad things weh him don do as him confess say him been enter one eight year old girl for him area and use finger enter another one.


The man later confess say him sleep with the girl more than two times. 

We hear say them go transfer the mater go Asaba police command for further investigation
...



9. 28-year old student?jailed for stealing N1.1m in Jos

From Busayo Olooekere



the kasuwan Nama Upper area court for inside jos don sentence one 28 years old student Shamsudeen Suleiman to one year imprisonment sake of say him been break enter inside person house come steal 1.1 million naira.

The judge wey him name na Yahaya Mohammed talk say d punishment go serve as example to the other people wey wan do wetink this man do. Him come order say make the convict pay back 650,000 thousand naira, and say d court go pity am because na d first time wey him been try do this thing.

The prosecutor Abubakar Musa, tell the court say dem been report one case of theif theif  on dec. 19 2018, for Nigeria Security and Civil Defence Corps, plateau command, by one Junaidu Ibrahim. Musa talk say the convict  wey dey stay for inside Nassarawa Gwon, been break enter inside the house of the person we bring complain come and him come go with one box wey 1.1million dey inside.

Suleiman been plead say him dey guilty to the two count charge wey dem talk say e contravene section 287 and 254 of the penal code.


Chai! See Wickedness Wey Woman Do Small Pikin For Edo State ...



From Ayim Raymond...



Na one Edo activist, weh be Kola Edokpayi share this report with us about one young boy weh get plenty-plenty burn wounds for body weh be say na one woman weh them talk say na him friend mama wicked am.

Hear as him take talk the matter; Today for our office one person been dey cry as him cari one young boy weh (Favour Omokaro) get fire wounds for him face, chest and belle.

We come ask the boy how him take get the wounds for him body,

The boy tell us say na him friend mama do am that kind bad thing.  After we listen to am, we come swing into action, first we go report the matter for police station to hear wetin dem get to do and make sure say them summon the accused woman.

Dem quickly cari the boy go for medical treatment as them see the fire weh dey our eyes as we been dey report the matter.

The way we see the matter, e be like say them been no dey take care of this little boy wel-wel, but now we go make sure say him get beter home to stay.

Na so him talk, we never no wetin go make this woman wicked this small boy like that, if na him pikin him go like am??

Any way, wen police enter the mater as them go cari the woman come, we go let wona know.


Ehyaaa! See As Parents Don Dey Mourn As Their Only Son Die Mysteriously For Anambra State...


(DEBORAH ODOEKWU )

Hey God oo! Chai!

As our Igbo people dey talk, ihe ojo e mekwala ozo o!

That one mean say bad tin don happen again o!

Hai! For Anambra State, we hear say one young guy don waka commot for this world wey come make im family and im friends dem dey cry for am. This guy wey die so wey im name na Anunobi Chimezie, na the only son wey im parents born. E come die on Tuesday wey be 22 January 2019 as im come get one kain sickness wey nobody know wetin e be or where e come from.

From the chuen chuen wey we get, the young-young people wey dey Umudiji Ukpor community wey dey Anambra state, where dis boy bn come from, come dey join im family members dey mourn the guy.



One mhiz Decency Ada come carry the cry come on top facebook come talk say this one na black Tuesday o, say the only son wey im parents get don go, say Chimezie, you for no gree to die. Your mama and your two sisters just dey cry like say tomorrow no dey. The whole young guys wey dey Umudiji ukpor don dey cry since morning, still you no wake up. Just 6 days sickness, dis world sef! Chai! I wish say you go fit wake up Ofu mkpuru anya. Person wey follow chop new year rice come clean mouth don die now. Tufiakwa. E hard me to believe say you don go like that!

Na wetin she talk be dat o

May the soul of Anunobi Chimezie rest in peace.






Chai! Dem Don Find Newborn Pikin Dead For Dustbin Inside Owerri ...


(Deborah Odoekwu )

Chimoooo! Which day be that wey I go Uromi wey dey Edo state wey I report say person abandon im pikin for inside one bowl come keep am near one catholic church wey dey the area. We never finish to dey talk dat on o. na im I come go Owerri for Imo state wey we hear say dem find one new born baby inside dustbin! Hey! People wicked oooo!!

We come go chuk ear for the matta well well come hear say dem find this pikin for one dustbin wey dey Ama-wire junction for Owerri.

We hear say this one dey happen just after some months wey just pass wey dem also find anoder pikin wey die after person dump am for dustbin again for that same Owerri. Say dem discover say this pikin wey im mama thruway for dustbin, bn done die by the time dem see am for inside the carton wey person chuk am put.

Prince Victor Ebukason wey come put the picture online come talk say, who be that person wey do this kin bad tin? Say dem find dis baby dead body for the Dust bin wey dey new Owerri World bank market yesterday evening and as im see am, im just weak, say im no even fit chop or do anything because wetin happen to dis innocent pikin still dey pain am. Im talk say make God have mercy on this our generation.

But me I dey wonder why person go carry im pikin go thruway for dustbin? Even if you no fit take care of am, why you no go carry am give people wey wan adopt pikin, ehn? Kai! This one weak me oo come chuk my liver kumemmeee! Hai!

Hmm

Teenager Narrate How One Uncle Wey Be 36 Years, Rape Her...




From Olu Alvin... 



One 16-year-old girl don talk how one 36-year-old man,wey him name na Alex Ogbuagu, been deceive am, make she enter him house, as him come rape am.

Them don arrest Alex Ogbuagu, because of say him touch-touch the girl for wrong wrong place, him come use him mouth to suck her pom pim pom, him come use curney-curney clear her bush, for Isheri area for Lagos where the suspect dey live, for the same yard with the girl papa and mama..

We hear say Alex Ogbuagu been come back early from work, him come use curney curny deceive the girl enter him room, come use sweet sweet words to confuse the girl.

Him first dey touch touch am, wey them dey call step one, him come enter step two, come begin touch and put mouth for her pom pim pom. Na him the thing come confuse the girl, but before you go say jack Robinson, him enter step three, as him begin clear her bush. And we hear say this clearing of bush last well well.

We hear say na as everything don finish, na him the girl eye clear, she come go tell her papa and mama say alex rape am.

Na him them sharply report the case give police for the area, we come arrest Alex con transfer the case go the Gender Section of the Police Command.

As them dey ask, Alex Ogbuagu question, him say him no rape the girl, say the girl na him gree am make him clear her bush.

But the girl no gree, she talk say Alex na him force am as him dey touch her pom pim pom, wey been come make her confuse.

Weather na rape oh or no be rape, police talk say Alex still get case to answer, because of say the girl never reach 18 years. Say them go carry am go court and them go charge am for rape.

Them say this offence na serious and capital offence, And say if them see say Alex dey guilty, him go tey for prison.

The Presiding Magistrate, wey be Mr. Peter Nwaka, com talk say make alex go lodge for prison, and say option of bail no dey.

Court Say One Man Go Die Because Say Him Hack Him Neighbour To Death Over Generator Smoke...



From Olu Alvin... 

one Lagos State High Court, for Igbosere, don sentence one  31-year-old man, wey him name na Ibrahim Tijani, to death by hanging, because of say him kill him neighbour because of generator wey dey comot smoke.

The convict, wey dey live for one uncompleted building with the person wey die, dey live for Okun for Ajah area for Lagos, been talk say him no dey guilty of watin them say him do.

The Prosecutor, wey be Adeniji Kazeem, wey also be senior advocate of Nigeria and  Attorney General of Lagos State, been tell court say Mr. Tijani, wey be 31 years, been kill Bashorun Okan-lawon, wey be 57 years old, with machete arround 2:30 in the morning.

Hin talk say this offence contravene Section 221 of the Criminal Law of Lagos State, 2011.

During the trial, the 16-year-old pikin of the man wey them kill, wey him name na Adeola Okanlawon, tell court say the accused use cutlass kill him father, after him father complain to the accused say the smoke wey him generator dey comot dey disturb am.

According to Adeola, him say him papa been ask the convict say make him change where him put him generator so the smoke no go dey enter him room, but him no gree, na him quarrel start, fight come bust.

Adeola talk say as the convict go carry cutlass, come cut cut him papa, him say him beg am say make him stop, but say him no gree hear.

One Man Bury Victim After Him Raid The House For Niger state



From ALI INA...

The Niger state police command don arrest one 31-year-old armed robbery suspect, Adelowo Adedayo, because say, him kill one of him victims wey be, Abdullahi Liman, con bury am for one shallow grave behind the APC quarters for Suleja inside Suleja Local government area on January 16th.

Adelowo wey lead the team of police detectives go the shallow grave on Tuesday January 22nd, talk say, him kill the victim so that him go fit steal him property wey include, set of chairs, LG plasma television, mattress, three pairs of shoes and two bags of clothes. Hear as him talk am,

“I don dey plan to steal from him house for the past six months; but unfortunately, the day wey I go there, him con dey for house and the only option wey I con get na to kill am. Liman house been dey well furnished and I been want some of the property wey him get; but as I con meet am for him house, I kill am, so that him no go con expose me to people.” Na so him talk

Confirming the incident, the state Police Public Relations Officer, Muhammad Abubakar, talk say the suspect confess to the crime as dem dey interrogate am and say dem go charge the suspect go court very soon

Dem Catch Two Sisters As Dem Dey Attempt To Smuggle Drugs Enter Kuje prison



From ALI INA...

Authorities For Kuje Medium Security Prison, don catch Two sisters wey been dey attempt to take style carry some kind substances wey dem suspect to be Indian hemp and Tramadol enter the Prison.

We hear say, Miss Blessing Chinwuba, been conceal the prohibited items inside one carton of neatly packed Indomie wraps.

Na some vigilant officers wey dey for the gate of the prison, na them catch am, before she go pass, go give one of the inmates wey him name na John Ifeanyichukwu.

The FCT Prisons Service Command talk-talk person, Humphrey Chukwuedo, on Tuesday don issue statement concerning the matter.

According to the statement, the prime suspect, wey pretend say, she no know anything about the contents of her illegal cargo, during the time wey dem been dey  interrogate her, she claim say, na her younger sister wey her name na Victoria, na she give am the consignment.

Victoria ma, come kuma dey support wetin her sister dey talk, she also talk say, she no dey aware of the contents of the consignment, wey she just collect from one courier service provider like that.

Dem don hand over the two suspects to the National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) for further investigation and possible prosecution.

One Woman Don Die inside Sleep After Fight With Neighbor





From Olu ALvin...

Police don arrest one 27-year-old woman, wey be Olabode Bello, and her two children because of say them beat one 40-year-old housewife, wey her name na Foluke Olanipekun, wey them dey live together for the same compound for Ogo Street, Arigidi Akoko area residence, Ondo State, and say the woman come die.

We hear say the two families been get quarrel wey come turn to free for all fight. After them fight finish, everybody enter him house go sleep. As morning reach na him them hear say 40 years old folake die for her sleep. Na him them invite Neighbours them, after them don wake wake am, and she no gree wake.

The family of folake no waste time to point hand to the family wey follow them fight, say na her an her children dey responsible for folake death. As police show for the matter, na him them ask the accused them questions con carry all of them go police station.

Them don carry folake body go mortuary, as them don transfer the case go the state police headquarters to ask more questions and say them go carry the case go court.

The question now na shey na them kill am, or na watin oyibo dey call coincidence.

Private School Driver Don Rape 4-Year-Old Girl For Osun...




From OLU ALVIN...

Them don carry one driver wey dey work for one private school for Osogbo, Osun State, wey him name na Oluwatomisin Oyelakin, go one Chief Magistrates’ Court sitting for Osogbo, because of say him go dey touch touch one small pikin for the wrong wrong place.

We hear say Oyelakin na driver for one school wey the  four-year-old victim dey go.

The day wey this suspect been do watin him do, we hear say him been don go drop all the other children for their house, e con remaining only the 4 years old victim.

The police prosecutor, wey be Sergeant Temitope Fatoba, talk say Oyelakin been committed the offence on Tuesday, January 15, 2019, around  4 oclock for evening for Osogbo.

Fatoba talk say the driver carry the pikin go one quiet place come go rape am.

According to ram, him say this offence contravene sections 360 and 218 of the Criminal Code, Cap 34 Vol. 11, Laws of Osun State, 2003.

The mother of the victim, wey her name na Mrs Gbadamosi, been just dey cry as she try tell us say them don carry her pikin go hospital where them do xray and scan on top am

Them don charged the suspect with two counts of r-pe and assault, and say them no wan listen to him beg wey him dey beg, and him crocodile cry wey him come dey cry.


One Lady Don Stab Her Neighbour To Death For Lagos




From OLU ALVIN

Police don arrest one woman because of say she chook her neighbor con kill am, on Friday, January 18, 2019, for Oke Ira,  for Ajah, inside Lagos state. The suspect wey them say hin name na Uche, wey them talk say dey always worry her neighbours them, been chook her neighbor with Knife after them been get serious quarrel.

According to watin we hear, the victim been dey brush her teeth around 5 oclock in the morning, na him uche begin sing song to insult am.

As uche see say the victim no even send am, Uche come pour dirty water ontop the victim body, na watin make the victim provoke, com give am word. Na him two of them begin insult them self.

According to watin we hear, we hear say the husband of the victim don warn am before say make she no follow uche start quarrel. Say make she dey careful of uche.

E never tey wey Uche and the victim begin quarel, na him the suspect con chook am for bele, as she dey take her children go bathroom make them go baff. Na him the victim come die latter, because of the wound.

May the soul of the victim Rest In Peace.

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land