Tuesday, January 7, 2020

Dear 2020... Our hope don full bucket ooo!

Again we dey plead with una to try encourage our correct hustle by just to click here πŸ‘‰πŸ½http://pladollmo.com/1WATπŸ‘ˆπŸ½ Na only God go bless you nyafu nyafu!!!



2019 bin make sense i no go lie you, and up till now I still no fit wait to see the kind packages wey you carry come for all of us...

As i take style Look back ontop the memories wey I make for 2019 with the people wey I adore and respect, e dey make my heart sing. I dey feel some kind quality love so ooπŸ€— and I dey feel jolly belleful and most importantly, I dey feel grateful, plus I gbadu the kind support wey i don bin dey get especially ontop this blog...😊

From one opportunity go the next, one adventure go the next, one palava/wahala go the next. I know say ups and downs go boku well well... Damma I know say, life no ever dey straight but I dey very hopeful  say, the good go continue to shine pass the bad.

And I dey hope say i go dey get betta betta orishirishi, with some kind opportunities to help others, with space to grow and become one kind betta version of myself & unaselves and with the ability to take style full ground gidigba, anytime wey my closest ones need me.

I also dey hope say as all of us don take style reach year 2020, we go continue to dey present, dey grateful and dey full of joy when we need am the most. I also hope say when the thing con dey be like say hope no dey at all, no worry, one kind small sunshine go just show face wey go take style show us the way when we need am pass...

I also dey hope say, we no go put too much pressure ontop ourselves, and we go take time to celebrate our achievements... Plus, make we put our health and happiness first before anything...

True true I dey hope say year 2020 go make sense pass 2019!

Una Happy New Year!

Again we dey plead with una to try encourage our correct hustle by just to click here πŸ‘‰πŸ½http://pladollmo.com/1WATπŸ‘ˆπŸ½ Na only God go bless you nyafu nyafu!!!

Una welcome back!!!


Oya na new year we dey so oo, no forget say you fit support our correct hustle by just to click ontop here πŸ‘‰πŸ½http://pladollmo.com/1W3MπŸ‘ˆπŸ½... God go bless you nyafu nyafu for 2020!


Happy 2020 to all of una wey make am oo! As new year don reach so, Inside plenty plenty resolutions, celebrations and some kind anticipations, I dey always take some kind quiet moment, to take style look back. So that i fit see both my achievements and opportunities wey I miss, both my work and personal life and both my highlights and low points, make dem sink inside me well well so that I fit readjust.

E dey very easy to start to feel one-kind one-kind and con dey dwell ontop the things wey bin no go according to how we plan am and somehow I dey feel say na normal thing because na human nature.

That na the reason why we dey exist especially for this blog because e dey give me some kind small time every now and then to take style remember the kind betta people wey i bin meet especially since this blog start 1 year ago.

After this one year, wey don include plenty life changing moments, I don already dey wonder how year 2020 go match up to the greatness? But as we all bin dey try for our own small small way to  dey more present throughout 2019 and with hopes and wishes for our minds for the year 2020, make we no forget say Nigeria na we own, make e no kpafuka. Make we join hands to make am betta, because no place be like our home...

Una welcome back!!!


Oya na new year we dey so oo, no forget say you fit support our correct hustle by just to click ontop here πŸ‘‰πŸ½http://pladollmo.com/1W3MπŸ‘ˆπŸ½... God go bless you nyafu nyafu for 2020!

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land