Wednesday, November 20, 2019

EVA PRAISE;D Next Big Thing For Gospel Music...

The next big thing wey go soon happen don land; Eva Praise from Port Harcourt, Rivers State (Nigeria) wey dey signed to North Hill Music and get plenty betta tunes for her name still dey work like fire for fire so that she go fit put more tunes wey go take Holy Ghost style dey bless lives nyafu nyafu... Make una watch out for her!!!
#northhillmusic #northhills #north #hill #Music #eva #praise #evapraise

SAINT SIMON; "4 me as Model Instructor, i go like groom the MBGN and also Miss World..."

 Say everybody fit shake body πŸ•ΊπŸ½πŸ•ΊπŸ½when song dey play, no mean say na everybody fit dance...πŸ’ƒπŸ½πŸ’ƒπŸ½ And several times e don dey very evident for practice say some people bin no sabi but after dem recieve betta training, dem become professional pass people wey even teach dem... Oya make i no go too far... Today our guest na dancer, fitness instructor, modelling instructor, singer and plenty oda things wey, him humility no go gree tell us but make we leave am for the wan wey him choose to tell us, so dat we go fit appreciate d career wey him dey build... Who be dis guest today? Make we meet am;
"my name na Simon Michael aka Saintsimon dc..."
Hmmmm dis talk go make sense today ooo, make I adjust my chair siddon well... Him continue say; "Dem born me inside Benue state for Orokam Ogbadibo LGA... I bin attend LEA phase 1 primary school gss masaka..." Na for dis interview session I con discover say Saintsimon na part-time introvert wey no dey like wahala but on top stage when him dey perform, him na complete extrovert... When we ask am who him be, to take style confam who we know am as, him talk say;
  "I b dance/modeling  instructor and also I b singer..." I tell una say dis guy humble to d core and him humility no go gree spill the beans but anyhow, we dey satisfied with the little wey him don spill... Lol! Unto how him take start dis him career, him talk say; "wetin inspire me, na my elder broda Mr Sunny wey, b4 na very good dancer for him time, b4 na him dem dey call Abuja Michael Jackson..." Oh oh oh😯 so dis thing bin dey run for their family gene and Saintsimon sef con discover am early, and now d thing dey open doors for am... Chai!πŸ˜ŠπŸ€— See how interesting life fit be sometimes... Okay as we move go front small, na so we con ask am wetin him go like achieve with dis thing wey him dey do and him yarn say; "wetin  I go like achieve na, 4me as model  instructor, make i groom the MBGN and also Miss World. I wan also achieve the area of to get my own dance academy wey go promote African kind of dance so d world fit see..." As per how long him don dey do am, him say;

 "I don dey do am since 2004..." Omo na like 15 years be dat o! No wonder if you see am for action, you go no say dis guy don tay inside dis game no be today... And him know wetin him dey do... As e reach dis point, we con ask am say na who you go like b like, him no think 2 times b4 him answer say;
 "I go like be like J moss..." Nice wan! Anyway as per how long him dey hope to pursue dis him career, him yarn say; "i don dey do am rite 4rm 2004 nd I wan continue am till d end..." Hmmmmm see strong passion! I go join my faith with oda betta people dem to pray say the oil for your head no go ever run dry... Oya make we continue o b4 time con dey give us signal.. Unto wetin him go like to leave as per legacy wey go make people remember am, him talk say;
  "Wetin I go like leave for pipu 2folo me, na 4me to help those wey think say dem no fit and those wey fit but no get opportunity, i go like create d platform wey dem go take showcase dat tin wey God give dem..." As time kukuma don already dey give us signal, we con ask am say, any project dey wey you dey involed or you join body do? Him talk again say;
  "yes, the project na FABP Face of Arts Beauty Pageant by CEO Lawrence Okpe of Black Giant Signatures, where I groom the models for dance and fitness... I also groom FSNI Face of Soccer Nigeria international. I also dey part of them from day one." Weldone Saintsimon! I believe say you be God gift to humanity and very soon the world no go get choice but to Celebrate your talents wella... As per him last words for those wey still dey struggle and those wey dey come up, him talk say;

"I no Believe d word upcoming artiste o. Na just d platform wey most people no get wey make dem still remain dea." Toh Saintsimon don talk him own as him believe say e be... In case you go need the services of dis talented young man, no look go far, just comment under here and e no go too tay, you go get wetin you want as e concern dance, fitness, to groom models, even to teach dance for schools or for wedding entrance sef... Na for here I go follow my Hausa brothers say "Magana ya kare" Lol!😁😁😁😁😁😁😁😁

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land