Tuesday, November 26, 2019

SAMARI DEBORAH: "I be Miss City College of Education (C.C.E)..."

"Beauty", as we know am,  get different levels. Even sef, e get different sizes and shapes... And dis na one great requirement for Beauty Pageants b4 dem go crown person as "Beauty Queen"... Na so, her Beauty + talent + brains + betta waka don make Miss Samari Deborah become another Beauty Queen wey don dey make News now no matta how anybody think am or talk am... But make we leave matta for matthias, follow me as we begin betta tori waka with Miss City College of Education(CCE) 2019/2020...;
  "My name na Samari Deborah. Na for Edo state them born me..." 😁Omo dis Edo babe smile no be here ooo... E dey pierce person soul like paper but e make sense wallahi! 😍Anyway on top her educational background she talk say; "I been attend L.E.A primary school for kwali Abuja here, then I attend Legacy high school for inside Ajaokuta kogi state. Then I come finish my senior secondary school for G.S.S kwali and now like this, I dey school for City College of Education wey dey for Mararaba. And na Computer/Mathematics I dey study..." Hmm make I reserve my comment, make we continue...πŸ€” As per who she be for people wey no sabi her as we dey yarn, she talk say; "Na student I be, I also be Model and right now i be Beauty Queen"... As matta con be like dis, na so we ask am say, how you take become model? Hear wetin she talk;

"How I take be model be say from when I dey small I come realize say I like fashion and people come dey tell me say I resemble model so I come dey try dress well every time even when I no commot  because I know say na my life be that..." Hmm if you dey yarn with dis babe, you go just dey trip for d way wey she dey dish her pidgin like garnished spaghetti.🍜🍝 E dey exactly like Beauty Queen...πŸ‘ΈπŸΎ Lol!😊 Make we flow... Unto wetin she dey hope to achieve with dis career path wey she don choose, she talk say;

"With this modeling I go like make people understand say modeling no be the way dem dey see am. I go like teach people how to dress and make dem know the worth of fashion..." From how she dey talk sef, you go know say dis babe know wetin she want and wetin she dey do and even me sef, my mentality about modeling don dey change small small...πŸ€” But make we continue, before we finish, she must finish d process wey she start... How long you don start?; "I just dey start but God help me now I be Miss city college of Education (C.C.E). And some other opportunities don  they come..." Toh na for here we con ask her say as she don reach dis level, who con be your mentor?;
 "For the field of modeling I no get person wey I wan be like. I just wan dey original because I never really see wetin I dey find for other models..." Okay... As time don dey give us signal say make we try begin dey park our kaya even as her limousine wey dey outside don start ignition to take style carry her go her next destination of touching lives, na so we kukuma use d opportunity ask her say, how long she dey plan to pursue dis her career? She no waste time to tell us say; "For me modeling na something wey I go pursue for the whole of my life, I no plan to stop am anytime soon..." Hmmm see Correct Queen with betta focus! OK, unto wetin she go like make people take dey remember her, she talk say;
  "Na my style of modeling na im I want make dem take dey remember me. E go different from others..." Before we match break for here, shey project dey wey you don do or you join body do? "For now, no project except the interview wey I been do for ITV with DJ temple and Mr Bassey regarding one program wey dem call The Unborn..." Nor worry, na small small, at least before your tenure finish and as you dey climb go far your career, we go soon dey hear of d plenty project wey you don dey do, plus d ones wey you dey plan to do... Anyway, las las, her advice to people wey dey start be say;

"The advice wey I wan give those wey dey come up be say anything wey you wan become for this life you fit make am, na hard work and determination you need and no forget to put God for everything wey you dey do..." True true, we don reach days wey modeling no be wetin e be before, but d crop of babes wey dey wear crown like Samari Deborah, na babes wey we fit conclude say dem be "Beauty with Betta Brains"... In case you wan encourage Miss CCE, you fit do so under here with una comments or reach am through her social media handles;
FB: Samari Deborah
IG: Samari Deborah

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land